Omo my area them done change am for us o, them no dey collect of naira notes again, and the new notes we no dey even see am, I no know waiting them want us to do ,
Dem say make we go cashless, how hard e dey for we to understand. No dey find cash as e no go dey instead dey use your Bank app run transfer or debit card dey pay for transaction. E no dey that hard to achieved, yesterday I buy bole with transfer and the woman recieve am serve me my launch meanwhile others dey there they argue with her to collect the old Naira. Belike people never understand say anyone wey collective old currency na at his or her own risk because the procedure to deposit no be here and na only one time you fit deposit from now until April 10th.
While practicing the new cashless policy, the only thing I fit advise us to do na to get two banks. One normal one and one microfinance banks like dem Opay, Kuda etc because when normal banks dey misbehave ah, you just switched to Microfinance and vice versa. That way you go avoid stress and use less of cards because the kind debit wey dey happen this days of unsuccessful transaction ehh. I dun call my customer care to the extent they sabi my number now lol.
I know how hard the situation be for the country right now. Infact make I share my own small experience today.
So after I roamed up and kept my eyes peeled out for any POS with available cash to dispense, I finally stumbled upon one that had cash and was the only one for a long distance. I paid the agreed charge which was more than 10% and he wanted to give me more old notes and fewer new ones. Thank God I declined and only took a thousand naira in two 500naira piece.
I spent one on food, but when I got to the market, everyone refused to accept the old notes all of a sudden and I had to start doing transfer o. Thank God again for microfinance bank, OPAY. I for hear whiiim today, mostly as aboki cut my meat, I no get cash and network no come agree to work again o.
The transfer finally worked and I just carry my small foodstuff run to my house. All effort to use the other 500naira note has been futile as no one agreed to accept it.
Which way Naija. Never thought we would go back to trade by barter system or buying naira for naira.
I will frame the note and hang it on my wall as a reminder of a country called Nigeria.