Author

Topic: Signature campaign announcement 📢 (Read 135 times)

sr. member
Activity: 574
Merit: 308
July 10, 2023, 12:05:44 PM
#19
UPDATE
The due payment (Week#9) sent, please read details: https://bitcointalksearch.org/topic/m.62529556

We the campaign has been launched again. Please apply.

Sorry for the delay payment for the due week. We are back in the track again.

open slot available in above link



Wetin people dey talk na their own decision and me I no see anything wey bad for the thread self, na better thing him do because all na for d benefit of us we dey d local board and na even nice idea self. D way people dey condemn am no make sense at all, make person put effort just to make Impact on the local board and everybody come dey condemn am like that, if the post no too dey okay, dey get reasonable way wey dem go talk am. With the way people dey talk now, you think say e go encourage am to create another thread for dis local board again? Any thread wey anybody create, make we dey try encourage d person, if we dey discourage people then everybody go come dey run from d local board. Wetin be d use say person go take time create thread you go come dey talk say Wetin d person do no make sense at all, and most people wey dey talk all dis rubbish no dey create thread for local board na only comment dem dey do. Abeg make we dey try appreciate peoples effort even if Wetin dem do no too go well.

Make we allow the matter slide and move on. E make sense to me sef as everybody dey counter but wetin spoil am be the point wey some people dey present no strong but e don do. I go lock am down till further.
Well don my guy. I like this thread wey you create and I buy into the idea. Despite the critical opinion of our other naija brothers abeg nor fell discourage. No lock the topic. Everybody just dey air their opinion and everybody must not be on the same page with you. If you stroll enter some other country local board, you go see say them sef get this kind thread and some of them even dey more active for their local board pass the English board. One of the reasons sha na because say we nor get our own moderator. Well, everything na time.

Abeg as e be now sef, you need to update this thread because Sherbet don reopen.

Thank you bro but as I weigh the matter, since plenty people no buy into the idea, I go lock the thread for now. I appreciate una all for the criticism and encouragement. Na so person dey take get experience. Person wey never face challenges never try anything new. Na our elders talk be that.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
July 10, 2023, 10:34:37 AM
#18
~snip~

Well don my guy. I like this thread wey you create and I buy into the idea. Despite the critical opinion of our other naija brothers abeg nor fell discourage. No lock the topic. Everybody just dey air their opinion and everybody must not be on the same page with you. If you stroll enter some other country local board, you go see say them sef get this kind thread and some of them even dey more active for their local board pass the English board. One of the reasons sha na because say we nor get our own moderator. Well, everything na time.

Abeg as e be now sef, you need to update this thread because Sherbet don reopen.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
July 10, 2023, 07:03:21 AM
#17
You see this thread wey you just create so, eh no make sense for one bit and I no like am, because I think this is not the kind of thread that we should be discussing about here, because this for really make sense on a "Telegram channel" or a "WhatsApp group", because I notice say since WhatsApp made their recent upgrade, a group can now have up to 1000 members, and we no even reach up to 500 here, so that medium for really make sense pass creating a thread here, con dey report say either campaign this or that get so so so open slot or eh don full. Omo, eh no make sense at all.

(But note, that's my own personal opinion & I'm entitle to it).
Na so everyone is entitled to his opinion but how you air your opinion matters a lot. E get one opinion wey go cause unrest and e get some wey go make everybody agree to your point. As the higher rank members wey una be una suppose to dey guide and encourage us upcoming members and no be to dey discourage and rubbish our efforts. After all, we dey together.

That idea of Telegram or WhatsApp is a very good one but some problems go dey base on say some people including myself no dey active on telegram like that and I no dey sure whether that WhatsApp own go dey OK to some people base on security protocol. WhatsApp go show everybody number for group and I believe say some people go like maintain anonymity. Telegram go take care of that since one can hide the number from public. E go make sense make we get either of that two.
You be my brother oh, because for the fact say we all from the same country 9ja we are all brothers & sisters for this forum, but eh get wetin you go bring and we go tell you "CAPITAL NO" and eh get some wey you go bring and we go embrace am wella, and that shouldn't discourage you, because if you feel discouraged, then that means you aren't ready for the journey of life, as no be everybody go always agree to what we say, but our ability to stand strong and keep pushing is what makes men successful in life.
So thank God at least you were able to see reasons with me why I said having such discussion on "Telegram channels or WhatsApp group" for really make sense than having it here, as you fit drop message now & in few seconds everybody go just receive notification and people wey dey interested go just apply sharperly- sharperly, unlike here wey if you just drop am now, if person never visit the local board, eh no go know say such update don come on board.

So no feel discouraged my guy, as we are all here to carry each other alone.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
July 10, 2023, 04:22:41 AM
#16
My guy you try for this one, na help you won help your people nai make you do this this thread but as e be now I go say make you park the topic one side becos of the  kind r replies I dey see here. I like Wetin you Dey do, the wahala na who go dey update the thread regularly, na big work o
Wetin people dey talk na their own decision and me I no see anything wey bad for the thread self, na better thing him do because all na for d benefit of us we dey d local board and na even nice idea self. D way people dey condemn am no make sense at all, make person put effort just to make Impact on the local board and everybody come dey condemn am like that, if the post no too dey okay, dey get reasonable way wey dem go talk am. With the way people dey talk now, you think say e go encourage am to create another thread for dis local board again? Any thread wey anybody create, make we dey try encourage d person, if we dey discourage people then everybody go come dey run from d local board. Wetin be d use say person go take time create thread you go come dey talk say Wetin d person do no make sense at all, and most people wey dey talk all dis rubbish no dey create thread for local board na only comment dem dey do. Abeg make we dey try appreciate peoples effort even if Wetin dem do no too go well.

the wahala na who go dey update the thread regularly, na big work o
Na better thing u talk for here, the only issue wey go dey na how him go fit keep up with the update of d thread wey I see say e go dey very difficult, make e no come be like say d thread no go come dey inactive or d op no go fit dey update d thread frequently.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
July 09, 2023, 06:24:18 PM
#15
My guy you try for this one, na help you won help your people nai make you do this this thread but as e be now I go say make you park the topic one side becos of the  kind r replies I dey see here. I like Wetin you Dey do, the wahala na who go dey update the thread regularly, na big work o
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 09, 2023, 01:52:00 PM
#14
Oga, 2 tell u d koko eh, dis ur thread way u create nw dey vry unnecessary nd unimportant 4 dis our small corner.
E no get ay reason why u need 2 dey duplicate watin dey service board 4 here.
There is nothing bad to have a discussion about signature campaigns on this thread, but...

Imagine say we wan con dey paste bounty as u don carri sig matter lik dis, no b small spam u go see here o. D board go jst full anyhow wth watin don already dey,
This is about signature campaigns, not bounties. Both are different and I believe only bitcoin signature campaigns would be welcomed.

OP, I am sorry to sound this way but from my own side,I don't think that this thread is relevant. Here are my reasons:
1. I believe say anybody wet no get campaign and dey look for campaign,the moment wet him login to the forum na service he go first go check to see whether any open slot or new campaign don dey.
2. Person no fit apply for this thread for campaign,instead he need to go service go apply because no be this thread need the applications.
To wrap it up nobody go come check for signature campaign updates for local board when e go fit go check for service and apply immediately. Lock this thread but wait first to hear from other members to see how them feel towards this thread of yours.
Never mind me, I do not see these as reasons.

The good reasons I see about this is this: Overview of Bitcointalk Signature-Ad Campaigns [Last update: 02-July-23]

I think it would be a valid point if these two reasons are stated:

First, because there is an existing thread about it and we all understand English. So anyone that is interested in signature campaign updates can put the link above on notification. So anytime there are open slot, you will get notification as people post about it.

Second, some people see this not good because people from other boards and English boards may see it as a way that Nigerians do not joke with campaigns.

@knowngunman
It would be good if you lock this thread. Although, some local boards may have this kind of thread, but as Nigerians do not welcome it, I will advice you to just lock this thread. I am only suggesting it for you. Or you may leave the thread and see how it turned out.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
July 09, 2023, 08:36:33 AM
#13
OP I know sae, you wan help and carry us wey be Nigeria people wey d for the forum along. I understand wetin you wan try do. At least make we get a thread for signature campaigns announcement. That one dey sha, if we can apply that in the future but as in dey, the btt forum get an existing board meant for that, and many of us wey dey for the forum knows the board where they can find signature announcement. So no worry yourself concerning the matter. Many of us can find our way for here. We do that almost every time to check if there is new signature campaign to join or the ones wey we join already get important announcement to make for em participants.
OK na be like I go soon lock the thread since majority dey go against am but I go like hear more people opinion before I decide to do that.

You see this thread wey you just create so, eh no make sense for one bit and I no like am, because I think this is not the kind of thread that we should be discussing about here, because this for really make sense on a "Telegram channel" or a "WhatsApp group", because I notice say since WhatsApp made their recent upgrade, a group can now have up to 1000 members, and we no even reach up to 500 here, so that medium for really make sense pass creating a thread here, con dey report say either campaign this or that get so so so open slot or eh don full. Omo, eh no make sense at all.

(But note, that's my own personal opinion & I'm entitle to it).
Na so everyone is entitled to his opinion but how you air your opinion matters a lot. E get one opinion wey go cause unrest and e get some wey go make everybody agree to your point. As the higher rank members wey una be una suppose to dey guide and encourage us upcoming members and no be to dey discourage and rubbish our efforts. After all, we dey together.

That idea of Telegram or WhatsApp is a very good one but some problems go dey base on say some people including myself no dey active on telegram like that and I no dey sure whether that WhatsApp own go dey OK to some people base on security protocol. WhatsApp go show everybody number for group and I believe say some people go like maintain anonymity. Telegram go take care of that since one can hide the number from public. E go make sense make we get either of that two.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
July 09, 2023, 07:26:48 AM
#12
OP I know sae, you wan help and carry us wey be Nigeria people wey d for the forum along. I understand wetin you wan try do. At least make we get a thread for signature campaigns announcement. That one dey sha, if we can apply that in the future but as in dey, the btt forum get an existing board meant for that, and many of us wey dey for the forum knows the board where they can find signature announcement. So no worry yourself concerning the matter. Many of us can find our way for here. We do that almost every time to check if there is new signature campaign to join or the ones wey we join already get important announcement to make for em participants.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
July 09, 2023, 06:45:55 AM
#11
E go make sense make the thread dey pin 📍 to first page but I no know how our bosses here particularly brainboss go see am.

I go like explain some related abbreviation for signature campaign small before I continue.
You see this thread wey you just create so, eh no make sense for one bit and I no like am, because I think this is not the kind of thread that we should be discussing about here, because this for really make sense on a "Telegram channel" or a "WhatsApp group", because I notice say since WhatsApp made their recent upgrade, a group can now have up to 1000 members, and we no even reach up to 500 here, so that medium for really make sense pass creating a thread here, con dey report say either campaign this or that get so so so open slot or eh don full. Omo, eh no make sense at all.

(But note, that's my own personal opinion & I'm entitle to it).
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
July 07, 2023, 10:09:40 AM
#10
I don't understand watin u mean by civility from my first comment on ur thread. Abeg, try help me talk hw I 4 xpress my views on hw I no like d thread nd exactly watin mak my first comment harsh.

If u ft point am out, I go understand were I stand 2 be corrected. At d moment, d only thin I feel say u view as bad thin frm dat my very first post na d fact say, I oppose d idea of duplicating open sig threads or evn a portion of it as update. I no like d idea.
Persn way dey fine somtin of dat nature, e no hard enter service thread.
The point be say I dey try to be creative here in order to make things easier for us. This kind thread dey for some local board with numerous pages meaning that e dey go well there. Na why I say make we sef get similar thing. People like me find it hard to visit service board but I dey check this our board everyday for updates and to also contribute to one or more things. I dey sure say I'm not alone on this.

So in that regard, I think e go make more sense if you first appreciate me for my effort before you begin to tell me your opinion and why it should be locked. Criticism is always welcome but it should be constructive bro.

OP, I am sorry to sound this way but from my own side,I don't think that this thread is relevant. Here are my reasons:
1. I believe say anybody wet no get campaign and dey look for campaign,the moment wet him login to the forum na service he go first go check to see whether any open slot or new campaign don dey.
2. Person no fit apply for this thread for campaign,instead he need to go service go apply because no be this thread need the applications.
To wrap it up nobody go come check for signature campaign updates for local board when e go fit go check for service and apply immediately. Lock this thread but wait first to hear from other members to see how them feel towards this thread of yours.
Mr bright shey you see how mtn sim card  Grin present his view and opinions with absolute calm and maturity con back am up with reasons. Na like this I expected you to do as well and it will go down well with me. Anyway, it's okay and we move ✅
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
July 07, 2023, 09:56:21 AM
#9
Op, I no say u do dis tin becos of us who is finding it difficult to get signature campaign based our rank, but d way u make it as a topic here, it look some how to dis local board becos d way other people will interpret it can make people to start suspend our activities here. If you can lock it,I think it will be a best solution or u can wait for our senior members to contribute and tell u wat to do
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
July 07, 2023, 09:10:16 AM
#8
OP, I am sorry to sound this way but from my own side,I don't think that this thread is relevant. Here are my reasons:
1. I believe say anybody wet no get campaign and dey look for campaign,the moment wet him login to the forum na service he go first go check to see whether any open slot or new campaign don dey.
2. Person no fit apply for this thread for campaign,instead he need to go service go apply because no be this thread need the applications.
To wrap it up nobody go come check for signature campaign updates for local board when e go fit go check for service and apply immediately. Lock this thread but wait first to hear from other members to see how them feel towards this thread of yours.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
July 07, 2023, 07:56:51 AM
#7
I don't understand watin u mean by civility from my first comment on ur thread. Abeg, try help me talk hw I 4 xpress my views on hw I no like d thread nd exactly watin mak my first comment harsh.

If u ft point am out, I go understand were I stand 2 be corrected. At d moment, d only thin I feel say u view as bad thin frm dat my very first post na d fact say, I oppose d idea of duplicating open sig threads or evn a portion of it as update. I no like d idea.
Persn way dey fine somtin of dat nature, e no hard enter service thread.

Still, I no ft stereotype u, dats not me.
I dey wonder hw I wan tak command u shah.

We no dey banter nothing here shah if na so u see am. Imagine u tellin me say I no read abi I no understand! Dis kind small thread way no go anywhere...

As e be now, Ozonechain, Sinbad and d likes of Stake way no dey close dey open but somehow, u no stil update dem. Abi does onces no follow 4 d update matter way u dey propose. If I reason am, e go con be like say, u jst rush drop dis one.

Own your view, own your mistakes bt I go still tell u say, dis duplicate thing u dey propose as update, e no dey me OK nd I no gbadu am.

Updated: You win I believe say na watin u wan hear, u win, Cheers!
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
July 07, 2023, 07:41:03 AM
#6
E be lik 2 learn go hard u o, knowngunman.
Try dey read mak u dey understand nd mak u no feel say, persn no fit tell I somtin 4 here. If u feel say here na where u go enforce ur opinion nd no go get contrary view, I go see reason why ur name na knowngunman.
Stereotyping I see here... In that regard, I go like you remind you that as your name be Mr right no be everybody you get right over to command.

Quote
If u read u go seewhere i talk say mak u imagine say we dey update bounty lik u dey propose 4 signature. Abi u no kmw say both na campaigns or you feel say all bounty no get value abi dem no get bounty way dey pay in USDT or ETH cef.

Guy, try dey concentrate waka 4 forum, no b only service thread nd sig mak u 4 dey learn. Thins way dey here pass lik dat.

So bcus Charles-Tim see am as gud idea, e mean say anode persn no ft get contrary view.

I stil dey rubbish am. Dus thread no go anywhere, pack am nd throw for waste bin. No point duplicating service board here.
You're not getting the point Mr man... It's not about having contrary view and opinion, how you present your view is what led to this lengthy banter. We can disagree to agree or otherwise but it should be done politely. I would advise you to be civil in approaching to issues because it tells a lot about your personality. In fact, how you attained Hero rank is questionable with this your character.

You erred already and you should succumb and accept correction rather than trying to justify your action. You presented your opinion in a harsh and rude manner which is uncalled for. You can do better mate.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
July 07, 2023, 07:17:59 AM
#5
To learn dey sweet for body when you dey learn and earn at the same time. Na the reason why I say make I create this thread so we go dey update each other on signature campaign wey launch newly or the old ones wey get open slot as e dey happen for other local boards. I check the board but I no see such thread (if e dey already abeg call my attention so I go lock this one) na why I say make I create am.
E be lik 2 learn go hard u o, knowngunman.
Try dey read mak u dey understand nd mak u no feel say, persn no fit tell I somtin 4 here. If u feel say here na where u go enforce ur opinion nd no go get contrary view, I go see reason why ur name na knowngunman.

Imagine say we wan con dey paste bounty as u don carri sig matter lik dis, no b small spam u go see here o. D board go jst full anyhow wth watin don already dey,
Wetin you dey try yan guy? No be you go tell me wetin I go do abeg. I no sure say you read through the thread sef before making this your comment. Wetin bring bounty issue come here now? Did I say make dem post every bounty and signature campaign as separate thread in the board? You for dey chill read with concentration and ask question if you no understand. Difference dey between read to understand and read to comment. You just justify that statement now.
If u read u go see where i talk say mak u imagine say we dey update bounty lik u dey propose 4 signature. Abi u no kmw say both na campaigns or you feel say all bounty no get value abi dem no get bounty way dey pay in USDT or ETH cef.

Guy, try dey concentrate, waka 4 forum, no b only service thread nd sig mak u 4 dey learn. Thins way dey here pass lik dat.

So bcus Charles-Tim see am as gud idea, e mean say anoda persn no ft get contrary view.

I stil dey rubbish am. Dis thread no go anywhere, pack am nd throw for waste bin. No point duplicating service board here.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
July 07, 2023, 06:37:22 AM
#4
I once have this in mind in the past. Good idea.
Thanks! E don tey wey me sef dey reason but one or two things dey stop me until I jam one again yesterday for one local board like that and the thing give me courage again.
Oga, 2 tell u d koko eh, dis ur thread way u create nw dey vry unnecessary nd unimportant 4 dis our small corner.
E no get ay reason why u need 2 dey duplicate watin dey service board 4 here.
Imagine say we wan con dey paste bounty as u don carri sig matter lik dis, no b small spam u go see here o. D board go jst full anyhow wth watin don already dey,

Mak I update u say,
Signature or bounty threads way active, way get slot way 4 pple to apply no dey beg 4 bumping. Pple dey apply occasionally nd peron way dey fine somthin, once u cari waka enter there e no go hard u see am.

Omo, jst 4get dis thread way u create here. Lock am evn, e cast.
Wetin you dey try yan guy? No be you go tell me wetin I go do abeg. I no sure say you read through the thread sef before making this your comment. Wetin bring bounty issue come here now? Did I say make dem post every bounty and signature campaign as separate thread in the board? You for dey chill read with concentration and ask question if you no understand. Difference dey between read to understand and read to comment. You just justify that statement now.

I no get strength to follow you argue abeg. @Charles-Tim dey commend say na good idea and you dey here dey rubbish my effort anyhow. Make I tell you the truth guy no dey use this manner follow strangers talk abeg. E too bad of you. Imagine the audacity telling me to lock am. Wetin you mean by e cast sef?
hero member
Activity: 896
Merit: 645
July 07, 2023, 06:33:54 AM
#3
Oga, 2 tell u d koko eh, dis ur thread way u create nw dey vry unnecessary nd unimportant 4 dis our small corner.
E no get ay reason why u need 2 dey duplicate watin dey service board 4 here.
Imagine say we wan con dey paste bounty as u don carri sig matter lik dis, no b small spam u go see here o. D board go jst full anyhow wth watin don already dey,

Mak I update u say,
Signature or bounty threads way active, way get slot way 4 pple to apply no dey beg 4 bumping. Pple dey apply occasionally nd peron way dey fine somthin, once u cari waka enter there e no go hard u see am.

Omo, jst 4get dis thread way u create here. Lock am evn, e cast.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 07, 2023, 06:26:49 AM
#2
I once have this in mind in the past. Good idea.

E go make sense make the thread dey pin  to first page but I no know how our bosses here particularly brainboss go see am.
We do not have a moderator yet, unless you report it to be pinned and it will not be pinned. It does not worth to be pinned. The one on the English board is not even pinned.

OPEN: e mean say the campaign dey open for qualified applicant to apply
X: this x means the number of participants require for each rank
CFNP: this one mean say the campaign Don close for new participant at that moment
FULL: e mean say the campaign don reach the number of participants required
FINISHED/CLOSED: this one mean say the campaign Don finish or something happen and the campaign close
PAUSED is another one.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
July 07, 2023, 06:16:28 AM
#1
Una weldon my country people. As e be like this now, many of our people Don dey rank up small small with their hard work and the support of each other here. To learn dey sweet for body when you dey learn and earn at the same time. Na the reason why I say make I create this thread so we go dey update each other on signature campaign wey launch newly or the old ones wey get open slot as e dey happen for other local boards. I check the board but I no see such thread (if e dey already abeg call my attention so I go lock this one) na why I say make I create am.

E go make sense make the thread dey pin 📍 to first page but I no know how our bosses here particularly brainboss go see am.

I go like explain some related abbreviation for signature campaign small before I continue.

  • OPEN: e mean say the campaign dey open for qualified applicant to apply
  • X: this x means the number of participants require for each rank
  • CFNP: this one mean say the campaign Don close for new participant at that moment
  • FULL: e mean say the campaign don reach the number of participants required
  • FINISHED/CLOSED: this one mean say the campaign Don finish or something happen and the campaign close

You fit add if I skipped some important abbreviation.

At the moment, we get this campaign wey get open slots for new applicant

manage by Royse

We have several openings.
2 x Hero
2 x Sr.
2 x Full Member
2 x Avatar
Please apply. I will accept applications for the next week

Minimum Merit requirement in the last 120 days: 150+


NOTE: Abeg read and understand the rules wey dey the campaign wey you apply before you drop your application for any campaign posted here.


I go like here una opinion and suggestions concerning this thread and it can improve.

Cheers 🥂
Jump to: