Many believes hardwork drives one into light but it can be contradicting as hell cos in this present era it becomes more of being smart than hardwork.
Doing more of hard work than working smart will get you to a certain level of achievement where applying more knowledge and critical skills would amount to greater achievements
In the days of our fathers, hardwork pays but today smart work pays, when you look the world come look people wey dey do well for demselfs you go see say na smart work wey dey pay pass.
Smart work na work wey you no need manual labor but brain work. When you fit capitalize on your brain work you go get more advantage pass person wey dey use him body dey work and when you look office jobs self, no be those wey dey work harder dey get highest pay, na managers dem wey dey manage people and to manage people you need sabi how to use your brain not your hand or body. Smart work need you to dey street orientated and I no dey talk the gra gra street but the street wey be say you need know the things wey you dun mention for OP so far and other things wey dey necessary.
We get some kind things wey go make you be a smart worker, smart work gives you an opportunity to do multiple jobs but hardworking go make you tire self and no go get time to do other things. Smart working go give you this things;
- Smart work go bring about more productivity to your work
- Smart work go bring about more flexibility to your work
- Smart work go bring about more Agility to your work.
- Smart work go give you more free time and make your work enjoyable and not boring.
- Smart work go help you achieve your goals faster than when you dey work hard.
- Smart work improve you overall experience on that job, encourages you to learn more on that job and other benefits wey you fit get from working smart.
I disagree with you on this one, when we talk about hardworking wetting dey come our mind dey always be say na manual work. You forget say the smart work you dey talk like this depends on individual. Wetting you see as smart work wet dey pay you go be like a lazy work for somebody else. You ft dey work smart and somebody you see say him dey work hard, fit dey earn pass you and him don dey used to that parttern of life. Morover for the office matter, before you become a boss today you don pass through theory and practical before them go make you a superior over every other person's except you pay to aquire that position. Why Dem dey always ask about previous experiences before them dey employ you? No be results of hardworking?
When we talk about hardwork, make we dey try to differentiate am like
Physical hardwork: this one involve you to use your physical body parts to work
Mental hardwork: this one involce using your mental ability to do meaningful thing to make money. Over stressing of the brain can cause mental problem. If Mental hardwork is easy, every single person that was given opportunity to work online would have been rich. Na most of this thing dey make our brilliant student no dey succeed for some kind work because they always think say them sabi everything. Not knowing say theory without practical is as not leaning anything.
Take for example who learn car online or with manual and who learn physical car wey don handle gear before, who go do more better? So the two works together. No matter how smart you are you no ft give woman belle without hardwork.😂