Author

Topic: Some of our Nigerians celebrity investors. (With prove) (Read 108 times)

full member
Activity: 224
Merit: 195
Omor this our celebrities dem dey try and follow the advancements for this technology stage dem no only dey focus on their field but dey spread accross all every sectors.
I dey sure say most of them get Bitcoin wey dey hold for their wallet, wey be say dem dey like anything investment even with this current Bitcoin dip I dey sure say most of them done invest well well inside Bitcoin.
Wetin just dey sweet me also be say dem dey try spread the knowledge accross so make those who no believe in Bitcoin make in begin clear off their doubt as even celebrities they happy say dey be Bitcoin owners. Thank God say Bitcoin no be only for the wealthy as even people wey no too get fit still dey invest little by little make dey no go use am like excuse say na because this our celebrities get money na wetin make they do this kind investment
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
I no dey surprise to hear say celebrities dem dey actually invest in bitcoin, because bitcoin and the entire crypto space deals with enough anonymity, so I so suppose expect anybody to come out side say em dey hold bitcoin before I go fit get hint weda em dey truely hold. Minus celeb dem sef we get so many people wey dey into crypto yet e just like say nothing come out, just imaging say we no get bitcoin enthusiasts for our country, this how come we take dey become one of the nations wey dey adopt bitcoin or other crypto. I believe say ones the government remove this restriction, Nigeria go be like El Salvador, many transaction would be done using bitcoin and e go still help increase our international tourism rate, meaning we go get many outsiders wey go come for tourism for we country.
full member
Activity: 1190
Merit: 124
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
I believe some of our leaders that hate BTC in the country will believe that BTC is a real decentralized currency that is not control by the government and, it is not a fake currency. Do you know that majority of Nigeria celebrity are crypto investors, just watch what will happen after this new song those popular singers released about BTC and, it will give other singers mind to come out boldly to join them to spread the good news about BTC in the country in a way it will attract other people to know BTC.

The reason why many celebrities like BTC than fiat money this days is because, BTC is very easy for them to hold and move around the whole world without the fear of EFCC because, there are some amount of money that will enter your  bank account that will make people to call you for questioning which such thing can never happen to BTC.
full member
Activity: 560
Merit: 161
Them fit no get bitcoin but then get the understanding that bitcoin is very valuable.  Person fit dey talk about bitcoin but e no really mean say them possess some amount of Bitcoin. But it is a good thing if our musicians they are talking about Bitcoin it means that they are giving more awareness of bitcoin for people know the word bitcoin and further to know more about it. The truth be say Nigeria youth are very aware of bitcoin and they have engaged themselves into it so much because they know say their is good benefit in investing bitcoin.
full member
Activity: 280
Merit: 203
The great city of God 🔥

Only this logo and the music show say yes them be bitcoin investors
My people our Nigerian artist done drop one new banger way relate to us we the bitcointalkers, this our music artist their names nah Asake, shallipopi and Wizkid aka Big-wiz @wizkidayo nai drop this banger named wire me bitcoin, so I say make I update us.
Only this one go show say our Nigerian artist they help spread this Bitcoin far far to other people way never hear about am before, and one other thing be say as nah celebrity dey spread this word Bitcoin e go still give am advantage for people to join the crypto world, because nowadays people value celebrities pass common man, abi nah lie?
Plenty of our celebs them self nah Bitcoin investors and some of this new ones way just dey come up nah watin them take blow today.

Yes na true but I no think if na only them self even and Nigeria srtis wey be Rexxie ft sheyi vibe don sing song wey him mentioned 40bitcoin. And that is to tell you say those men dey fully awear about bitcoin and probably dey do am secretly sice e never dey official for the country.
https://www.google.com/url?q=https://www.six9ja.com/rexxie-40-btc-ft-seyi-vibez/&sa=U&ved=2ahUKEwiOjc3MiPKCAxWFFBAIHWJWAfAQFnoECAAQAg&usg=AOvVaw2xiUC6haWp4Iyaktz_viuz
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Well we never can tell because no be say dem talk am meaning say dem mean am o. E just be like say Na happening trend wey dem feel like to take make hit songs because na wetin dey reign for the entertainment industry now. Even if dem use am sing song, you don see any day dem talk about Bitcoin before? or say  dem grant interview to talk about Bitcoin?
Forget say dem be celebrity that one Na for mouth o. As e be say nobody to pay for advert dem no dey bother talk about Bitcoin but if Na  to talk about casino or sportbook dem no go waste time do the advert as them go pay them. Since Na Bitcoin and nobody dey pay dem dat one Na on your own.

I for like make dem begin vibes to Bitcoin so that their fans go know what's up about Bitcoin. Check out when that one happen just imagine the millions of people wey go begin ask about Bitcoin to know wetin e really mean. Na there the adoption go come strong wella. If dem go fit do a 4 to 5 minutes talk  on Bitcoin put for their social media handles, believe me you the adoption g ok dey massive because people go want to hold Bitcoin as their celebrity dey hold am too.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

I do not download musics and videos for the sites I do not trust, for the safety of my device. I will not download or listen to the music until I see it on YouTube or YT Music as usual.


Me too because I no just dey click link anyhow to avoid stories. So apart from YouTube, I also dey use SnapTube. I hope we sabi that one too, e just dey like YouTube. So I go check those names wey op mentioned for the SnapTube to check if any of them don carry the music enter there.

This will definitely let more Nigerians to know about bitcoin and some people may invest.

Yes artist get strong influence and bond on their followers.

If the song get chorus wey dey talk about btc direct na im be say more Nigerians go want join btc

Edit, okay I don see the song. Na just about 1 minutes short song. The song need some serious vibes and I believe some naija artist go begin jump on songs around bitcoin.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
I saw download when I clicked on the OP link. I hope that is not those Nigerian download link that will be redirecting people to ads? I remember I have encountered things like this on (Nigeria) musics and movies sites before I joined Bitcointalk. I noticed the YouTube video is not available on the site yet. I wish I can watch it on YouTube or YT Music but I did not see the official music or video yet.

I do not download musics and videos for the sites I do not trust, for the safety of my device. I will not download or listen to the music until I see it on YouTube or YT Music as usual.

This will definitely let more Nigerians to know about bitcoin and some people may invest. Although, bitcoin is no more new in Nigeria, but the people in cities and towns are the ones that know much about bitcoin. This music should be able to find its way to the village and more people can know more about bitcoin. Although, I expect more people from cities and towns to know about bitcoin through the music, and also encouraging them to invest.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217

Only this logo and the music show say yes them be bitcoin investors
My people our Nigerian artist done drop one new banger way relate to us we the bitcointalkers, this our music artist their names nah Asake, shallipopi and Wizkid aka Big-wiz @wizkidayo nai drop this banger named wire me bitcoin, so I say make I update us.
Only this one go show say our Nigerian artist they help spread this Bitcoin far far to other people way never hear about am before, and one other thing be say as nah celebrity dey spread this word Bitcoin e go still give am advantage for people to join the crypto world, because nowadays people value celebrities pass common man, abi nah lie?
Plenty of our celebs them self nah Bitcoin investors and some of this new ones way just dey come up nah watin them take blow today.
Jump to: