Author

Topic: Special thanks for our backups and advice to the newbies (Read 78 times)

sr. member
Activity: 224
Merit: 195
The forum sweet die, no be capping. E no look easy but e easy ones we gather the potentials but as a newbie normally we go find am very difficult cos e nvr yet be our thing but by the time we don build reach full member na their u go understand say e no too difficult na just for we to do more of reading and learning, be the real you for the forum no go overdo for any board, where we no sabi e go just better say we no reply just free am comot go another board wey u fit contribute do your things then comot na so the merits go dey come, no stress.
hero member
Activity: 966
Merit: 620

As a person who didn't know much about this forum when I came in
My gee, welcome to this ogbonge cabal o and I say nah beta talk you yarn for here but I say make I correct an impression. E for beta to use "As a person wey no know much about this place" instead of the wan you use because if we check am, you dey try let us know say you still dey learn but with how you put am, e come look like say you don Sabi everything for the forum; which no be bad thing but since learning nah continuous process, we no fit sabi everything finish.

 Nah true talk you cap because one thing for life be say if you no get person wey dey act as mentor, we fit loose guard for some areas and narrowing it down to this forum, e good to get person to show you the ropes around here make you no go fall your hands unto say you feel say as nah to just read and post, anything fit go.
sr. member
Activity: 560
Merit: 326
Na so di matter bi for here, wen you enter forum as a newbie, e go be like say make you rank up sharperly, follow members wey don de higher ranks to enter campaign, like say na one day e take dem to reach dat level. I also know di feeling wen you get your first merit, e go first be you like film trick, too much happiness and high morale, you go come count down ninety nine more to go, with time experience go come tell you to calm down and focus on rising gradually.

The truth be say if you carry merit matter as your main focus for dis forum, you hand fit fall, because you need to earn am, even when you sabi e still fit delay to come. So na to enjoy your self with the conversations for di forum, focus more on quality posts, obey forum rules and gradually members go begin de notice and merit you, small small you go come de rank up de go.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
You know life is never too easy, words of the month in practical are never the same. Spoken words can be sweet at the same time bitter spoken words can seem easy and the same hard depending on how it was emphasized to you.
As a person who didn't know much about this forum when I came in everything seemed like it would happen that day if you see the ginger the zeal the passion but at a time first of all when I saw that it was about writing Omo my pressure nearly calm because I wrote and cracked my brain to get a meaningful write up to bring here to feel among guy it was never easy, as a newbie no form like say you too know even though you sabi book but once you are here even small mistake fit fuck you up.

And you see them said what you don't know is a mystery but for here as a newbie man you must need person wen dey follow you up if not you no go meet up, it's either you backslide or you quit Omo kudos to those of una wen Dom go far as well as being FULL MEMBERS, HEROES, LEGENDARY. I pull cap una try una sacrifice major time no be small, posting and every other thing say no be my back up I for Dom drop this forum since but kudos to him. U know that feeling wen be say u get one merit newbies una know that feeling see I happy die I felt like I have arrived no be small I buy water for my niggi make we take celebrate am but him no understand why I dey happy even the first day I get comment cho e give me ginger to post more though we still dey grass root but for the small one wen I get I appreciate everyone wen Dom contribute that one na my greatest strength ONE LOVE.

MY FELLOW NEWBIE make una no give up you must pay a price to reach where you want be. This forum be like wen you want join force it's never easy but wen you arrive e go loud like trumpet. For those wey Dom arrive una children dey back oo.

As you dey talk I just dey see reflection of myself when I been dey newbie. You own good say pure water you buy take celebrate, my own I knelt down for on top bridge they thank God, because e nor easy, and that morning I been go church go pray about the matter. So when I come see the merit the thing just show say God still dey hear em children. Omor you wan see joy for my face that day, e just be like say I don rank up. To get your first merit naim dey bring joy pass when you even turn full member, some persons no go believe but na truth be that. To me oo, I see merit as grace because sometimes na your less quality post go come get merit pass the one wey you feel say naim you use all your knowledge take write.

I just wan let you know say I dey see you good works and make this ginger no stop oo, keep it up.
member
Activity: 215
Merit: 60

Jump to: