When the government fails to take care of the citizens, the citizens will go wild and not obey government laws. Naija problem of insecurity na corruption, if no corruption everything go dey move well,job go dey,politicians no go thief money come dey deceive us, and the jobs dem no go hide am cari give their children. Nepotism make Nigeria no fit go forward which be the major factor of corruption.
Nigeria no go fit tackle insecurity again o,make we no deceive ourselves, water don pass gari,because the all system of government dey so eaten by corruption wey be say them no go free let good man wey no dey like dem rule because them no say e go bring out their leg and maybe jail them or them no go fit benefit again from the national cake,but God pass them.
With the way wey things dey go for Niaja,I no see hope from any where so the only way to tackle insecurity na make Nigeria divide so that people fit start again do new government system and by then we go know whether the two different countries no go do well. The fucking truth is that Nigeria is too big for one man to control since the whole system is messed up from 1960 till date.
Happy New Year... 2023....loading.... 75%
My broda we all understand the dip shit wey nigeria dey when its come this insecurity mata but dat one no ever mean say we no go fit tackle am again. My one reason to this insecurity mata na like you have already stated say na corruption and na the whole truth be that because is core chain to so many issues wey dey happen for this country.
Unemployment is another branch of this insecurity mata and this also caused by the corruptive mind of our leaders wey don refuse to spread the rate of employment around this our country and this has lead many people especially the youths to go into different illegal things and business as a means of survival.
Person wey no get work or the system dey condition am go also strive for a way to survive na and in so doing actually condition himself to commit crimes such arm robbery or kidnapping to get money for his survival so nigerian leaders na the real cause of the insecurities in the country.
But brother i still we can grow out of this situation and become better its only a matter of time because with time all her deep wounds will eventually heal up with the right medicine.