Yesterday been the 30th na him dem suppose launch the pool for the token and stop mining but before that yesterday, dem release say them no go stop mining(tapping) that day because many people don use bots gather coins and them wan fish them out before the launch pool which they carry date go July again. Before that again, them been talk say them no go launch on soalana blockchain again which many people believe say na red flag be that and make people no to take am serious as they did before. All in all sha, dis na cryptocurrency space, if you make your hopes too high, you go dey disappointed. Just do your thing and expect nothing or less to come out from it, with that type of mindset, you go they at rest regardless of wetin dem come be after them launch. Surprises full here and I just dey wait to see the outcome of dis one because of Nigerians don too dey interested in am and everybody especially those wey no understand crypto feel say e go make dem rich overnight..lol.