Bitcoin na investment wey need patient and for those people wey invest aftwr bitcoin don already reach him ATH last time, na patience get dem so o and if dem practice d patient will dem go still dey profitable very soon. For all the time wey bitcoin don dey dump, them suppose utilize am dey buy more and more bitcoin so that the average price wey e go be say them buy dos bitcoins go don reduce by the time wey you wan comot your profit from the investment after waiting patiently for several years. Na DCA go only get them wetin dem want and if them use am well, then suppose dey on enjoyment as time for don dey reach small small as bitcoin don dey come to witness another bull run after four years.