Author

Topic: The way our girls dey miss this days (Read 224 times)

member
Activity: 130
Merit: 10
May 14, 2023, 06:52:12 PM
#20
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.

Na so the country dun grow reach now, ritual dun dey so common wey be say we dey praise am and na wetin deh cause all things. This ritual matters na majorly wetin they make people miss and also kidnapping. I no just understand wetin the government and securities agency for country dey do. Abi dem no dey pay them again to protect us. As e be like dis belike dem go begin approved personal arms because person need gun to take care of himself this day as if dem come for you, nobody fit do anything even the police self no follow.
Our girls too no dey try, na so so wake full their legs. How you go just meet person for online either through Facebook or other social media and you dun dey follow them go house. The worst na the hookup hustle we dun dey so common wey be say 90% of our girls especially university girls na wetin dem dey do and dem sabi go this boys wey book them houses without any security like telling person where dem dey go. How dem go carry tell person self when the hustle wey dem dey do no pure. Make girls give themselves respect and hold their self well because all this problem no dey too near those wey dey respect themselves.

My senior brozzay na true say rituals and kidnapping don turn business for dis our country nd e no good say some pipu dey glorify am. E suppose be government nd security agencies wey go protect us but e be like say dem no wan de reason our Mathias again. But if we begin carry personal arms e fit cause more violence sha cuz nobody get joy as e de be now like dis.
For dis matter wey concern our girls wen dey do online hookups nd other risky tins, na true say dem dey fuck up nd dem follow contribute to dis mathias wey de sup for we country. E important say make we de make responsible decisions nd put our safety first. Omorrr our girls sha get mind sha o… Make we try de encourage our girls make dem for get respect for their body. No be every Man u see for road u go follow go house.
Any which way, we still need address d main problem nd make we work together to make d society safer for all we us.
sr. member
Activity: 644
Merit: 262
May 13, 2023, 10:39:09 PM
#19
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.
D rate at which young guys dey look for money now don too much, dey are ready to do everything possible just to make this money, and girls also, their eye no dey stay one place, na guys wey go spoil them with money dem dey look for, some of them know say Wetin d guy wey dem dey follow dey do no pure, but dey go still dey follow the guy just because of the money wey dem dey get from the guy.
All this gen-Z girls them no get joy for any hustling young guy side oh, them no the see you self as person way get future as far as you never get money to the spend spend anyhow on them. And wetin the pain me pass nah be say same girls them get brothers way never make am but them still get hope say their own brothers go make am but them no get hope for another guy way the hustle too say him go make as to hustle together with the guy, them dey find where don already done make them com relax chop, and nah all these things the lead to some impatient and indiscipline guys to go the pit their hands for bad things just to impress them girls .

But my own rhetorical question be say, if we guys too start to the date women primarily for money reasons nah which girl go actually get boyfriend cos the last time I checked plenty girls broke finish, as in like 90/100 girls nah broke ass.
hero member
Activity: 868
Merit: 574
May 09, 2023, 04:46:26 AM
#18
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.

Tor, na so we dey hear am sometime op, say people dey miss and  I dey no dey found many of them again especially young ladies.but it is not new in this country that some people use blood of human being for spiritual sacrifice especially those ritualist, and if we can look at rate which young guys are into dirty work now especially yahoo  yahoo dey don't care to do anything that can make them get rich, so sacrifice their follow human beings mean nothing to them again.

Nowadays many yahoo yahoo guys found it soo easy to use this girls for sacrifice because they now they are desperate of money and ready to give and get the opportunity. it is money that push many of those girls those yahoo yahoo guys, so if some girls see that this guys get money they are always blind following them to any place or easily allow to have sex with them, not knowing many of yahoo guys have bad intentions.but the issue why this act have been increasing it is because of insecurity in the country.if governments can provide good security in country all this bad act will reduce seriously.

member
Activity: 212
Merit: 12
May 08, 2023, 06:01:19 PM
#17
My dear,it is a very Big issues in this country, not only missing persons oooh, kidnapping has been the other of the day, and no body cares,they were only interested in packing money to other countries and live in there,

Killing everywhere, what kind of government are we practicing in this country,no body else can talk expect them.. and when you mistakenly talk they will look for you and send you to prison or kill you immediately..so my dear alot is happening ooh,the life we are living today is by the grace of God,if not God who knows what would have happened to us by now.

Again in the other way round our girls are the cause of their problem, because their eyes on money are what is killing them the most,they want to be like this and that and you leave your parents house going to visit a guy you don't know,you have never set your eyes on him physically, and because he has promised you heaven and earth, and you went without telling your parents about this..
sr. member
Activity: 770
Merit: 445
May 07, 2023, 02:32:28 PM
#16
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.
D rate at which young guys dey look for money now don too much, dey are ready to do everything possible just to make this money, and girls also, their eye no dey stay one place, na guys wey go spoil them with money dem dey look for, some of them know say Wetin d guy wey dem dey follow dey do no pure, but dey go still dey follow the guy just because of the money wey dem dey get from the guy. For my side if you hear say girl lost mostly na boyfriend side she go, most of them na all this yahoo boys dem dey follow and at the end, those guy go just end up using them. If girls fit dey satisfied with Wetin their parents they give dem and make dem they do legit hustling, make dem no dey depend on boyfriend, then am sure d way girls dey lost go reduce.
sr. member
Activity: 714
Merit: 353
May 07, 2023, 04:48:51 AM
#15
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.
My guy as these things wey they happen every body just they surprise because how person go just comot for house say him wan go visit friends that person no go come back some they hardly comeback again so people don go they no go see them for this life again. So all these things wey dey sup I know no whether na for only this country e dey happen. But I they think say these things they happen because everybody wan get money quickly for these life every body wan work less and get money plenty money so wetin you they think when person no Wan work and him get money definitely you go mingle with thugs around the street and na wetin they lead this missing bedat.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
May 06, 2023, 07:34:39 AM
#14
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.

Them sure say na their friend birthday those your neighbour pikin them go? Them fit follow that excuse put head for anywjere weh concern them. Girls of nawadays don turn something else. Na so so bad gangs most of them deh follow now especially Yahoo boys weh them deh like hype because of money weh those boys deh throw. Make their parents check well, maybe them follow some boys go honeymoon.
sr. member
Activity: 2842
Merit: 326
Vave.com - Crypto Casino
May 05, 2023, 01:19:36 AM
#13
Our people dey talk parable say na person wey river see him leg na him e dey swallow, likewise, person wey enter forest go pack firewood wey ants full, make him no complain when lizards begin do meeting for him house...

The pattern of our girls this days dey shame me I no fit lie, and I no dey surprise when I hear say one or two dey miss, na wetin person ask for na im him dey get, I no dey pity for this girls at all, them wey dey run follow yahoo boys up and down, suppose know say na collateral them be to the yahoo boy, when yahoo boy dey spend money on top the girls, dey suppose know say, any day wey the money go down, and yahoo boy need more money and no see any other means, yahoo boy go use one of his collateral do money, and as money dey to spend, na so more collaterals dey come - our girls suppose done get sense by now..
Many greedy girls don become endanger species for naija teytey because of desperation to belong to a high class, dis tory no dey move again, I watched one video way bi say one yahoo boy used this girl finish she come dey vomit maggots from her mouth and private parts all in the name of show off, go and see plenty girls wey dey do hook up everywhere not even minding who carry them, the Koko bi say anybody wey born girl make sure he train and guide am well o, the funniest part bi say many of those girls no wan hustle, the urge and mentality to earn quick money don becloud their brain thus ability to reason go don die, and yahoo boy wey wan renew their wealth no even send them.
legendary
Activity: 2450
Merit: 4295
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
May 03, 2023, 11:29:28 AM
#12
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.

Na so the country dun grow reach now, ritual dun dey so common wey be say we dey praise am and na wetin deh cause all things. This ritual matters na majorly wetin they make people miss and also kidnapping. I no just understand wetin the government and securities agency for country dey do. Abi dem no dey pay them again to protect us. As e be like dis belike dem go begin approved personal arms because person need gun to take care of himself this day as if dem come for you, nobody fit do anything even the police self no follow.

Our girls too no dey try, na so so wake full their legs. How you go just meet person for online either through Facebook or other social media and you dun dey follow them go house. The worst na the hookup hustle we dun dey so common wey be say 90% of our girls especially university girls na wetin dem dey do and dem sabi go this boys wey book them houses without any security like telling person where dem dey go. How dem go carry tell person self when the hustle wey dem dey do no pure. Make girls give themselves respect and hold their self well because all this problem no dey too near those wey dey respect themselves.
legendary
Activity: 2422
Merit: 1083
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
May 02, 2023, 09:27:22 AM
#11
Our people dey talk parable say na person wey river see him leg na him e dey swallow, likewise, person wey enter forest go pack firewood wey ants full, make him no complain when lizards begin do meeting for him house...

The pattern of our girls this days dey shame me I no fit lie, and I no dey surprise when I hear say one or two dey miss, na wetin person ask for na im him dey get, I no dey pity for this girls at all, them wey dey run follow yahoo boys up and down, suppose know say na collateral them be to the yahoo boy, when yahoo boy dey spend money on top the girls, dey suppose know say, any day wey the money go down, and yahoo boy need more money and no see any other means, yahoo boy go use one of his collateral do money, and as money dey to spend, na so more collaterals dey come - our girls suppose done get sense by now..
jr. member
Activity: 86
Merit: 2
May 02, 2023, 09:04:02 AM
#10
The way most girls just dey become desperate to get flashy things na dey make them lose there life nowadays..Them dey forget say some yahoo boys na ritualist and the rate of evil doing done full our country.".A word is enough for the wise"..Dem fit work get those things for their self but they prefer quick one na e make dem they lose their life
hero member
Activity: 1092
Merit: 747
May 02, 2023, 06:03:10 AM
#9
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.
Shah, did you just asked which pattern for our country or abi you meant which pattern for most of our girls? Because the truth be say the way most of our girls dey crave for material wealth this days is becoming very preposterous, of which who knows whether one Yahoo guy don promise to buy them an iPhone 14 during the party only for just a one-night stand and they agreed, followed him to his house and never came again. Because the issue be say if only our girls can be productive (i.e either physical or digital) and start making money on their own without relying on pussy as a tool of exchange to getting what they want, all this kind matter go reduce well well.
sr. member
Activity: 378
Merit: 258
Lohamor Family
May 02, 2023, 02:39:26 AM
#8
@Ledway, you should read all pinned thread in all boards to have a proper knowledge of how things works here. Also don't rush into posting as a newbie with little or no knowledge on bitcoin or on the topic being discussed. Read more articles in the forum by high rank members,do your own research to know and learn fast. Any discussion wey the person put link,go read the link so that e go give you more knowledge on what to contribute. Anything wey you no get idea for,feel free to come here and ask,you get get answers from our experts here,instead of going out there to cast yourself. Who no know road wey ask people no go lose.
As for your thread, Nigeria don cast to the extend wey be say we no dey safe again. The government don abandon security work for us to guide ourselves,na money na e Nigeria police and other security agencies dey run follow now. Leaving their primary duties to the citizens, na e make all these our evil doers come see am as opportunity for them to dey do all the evil things like kidnap,money rituals wey must endanger our lives. I just hope say your neighbour dey save hand,make e no be say  she go just miss like that. Na God be our security so make we help ourselves by avoiding some waka wey no dey important.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
May 01, 2023, 05:34:47 AM
#7
As our country the so, I keep on saying it that not all invitation wey peso invite you over, you suppose to d honor so, more especially birthday parties. When it comes to celebration of a thing, na girls wey dem d target pass, pass guys. Na why em be sae, girls supposed to d mindful of the kind place wey dem d go, friends wey them d keep and mingle with because you know why? Ground no pure again. People d do unpalatable things these days just to get fame. They no mind to kidnap and later run use the peso for rituals. We are not praying for such a thing to happen for neighbor pikin(2 daughters) sha. I pray make una see them soon. The thing na be sae, do the parents of the girl's wey d find their daughters sabi their daughter's friend wey do the birthday party? If they do, they should report the matter for police so that make the arrest the girl wey do the birthday party for questioning. At least make police people start-up their investigation from there to check whether they go fit trace how the two sisters take do their walka. Whether the follow guys go their house to spend time with them or not. This kind matter no be wetin peso suppose keep calm for. Peso suppose to think outside the box and take all the necessary steps for answers. This our country no be wetin peso suppose to trust anyone again

hero member
Activity: 1288
Merit: 504
April 30, 2023, 08:01:37 PM
#6

This na bad omen o. Sometimes we go dey reason am say maybe na kidnapping sup like dis but sometimes e dey far from it. With the rate at which everybody wan make am for dis life now, ritual don become normal thing too oo. I pray dem no dey missing for any of those purposes but make our parents no dey allow children dey move out anyhow
Dis one don pass 2 be anytin omen o, omen na warning 4 watin nevr happn no b watin don happen. D only tin way we no ft knw nw na I dem don kpafuka or nt. Watin we knw nw b say, dem nevr see dem eye. Either na by dere choice or not, we nevr stil knw kwa

Where matta dey b say,4 dis pple 2 commot 4 house lik dat without supervision, dem gats b adult nd adults no dey lose lik dat na. Evn of dem lose, once you book bolt con put ur address, u don reach house back b dat.

I no go lik imagine d worst of d situation shah bt, mak dem dey safe nd mak God help dem 4 d sake of d pipo way dey find dem becus, dis matta no funny at all.
hero member
Activity: 1008
Merit: 702
April 30, 2023, 06:31:22 PM
#5
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.

This na bad omen o. Sometimes we go dey reason am say maybe na kidnapping sup like dis but sometimes e dey far from it. With the rate at which everybody wan make am for dis life now, ritual don become normal thing too oo. I pray dem no dey missing for any of those purposes but make our parents no dey allow children dey move out anyhow all in the name of party especially for night because this country no safe again. I pray dey find them and they return home safely, if not dis matter no funny again oo.

Abeg read the forum rules well no be when them catch you for copy and paste you go come post topic for local board.

Lol, maybe OP just dey come here dey chill and disguise after him don collect warning for general board. @Ledway better listen to advise make you no go chop ban o.
hero member
Activity: 1190
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 30, 2023, 11:59:01 AM
#4
The rate of kidnapping cases don dey increase, person dey dey careful for anywhere he dey go, these criminals dey use both keke, taxi and bolt dey operate, make police leave 200 naira way them dey like collect from taxi driver go find way to tackle this problem because he don too much. This your neighbor case never reach 24 hours I no sure say una go fit file missing person report yet.

Abeg read the forum rules well no be when them catch you for copy and paste you go come post topic for local board.
hero member
Activity: 882
Merit: 800
April 29, 2023, 03:47:55 PM
#3
We know already the country are no longer safe for one to reside again, there are lots of atrocities enveloping the country haven known this we should mind the way we pay visit or even attend birthday parties because those are the main common thing which they uses most to catch up people attention especially the female genders. The insecurity and killing and kidnapping rate is much so it will be ideal anyone going for birthday party should not over stayed their time and given moment or after party they should go back to their respective homes instead of making another smart move which may endangered the celebrants.
However @Cryptsafe already said it all, always stick around here to learn things you don't know before doing ITK and got ban for not following the rules.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
April 29, 2023, 03:33:35 PM
#2
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.

OP I thought as much seeing you here on our local board. Initially I had no idea you were a Nigerian. I checked your profile to see for myself again but it seems your old topics been deleted and I believe you know why those topics of yours were all deleted.

I would advise you here. Do well to read forum policies, guidelines and principles so as to help you to making good posts and meaningful contributions. Also, I would advise you to always cite articles where you copied from just like you did before without citing or refferencing them as failure to do so might get you suspended or banned from this platform.
newbie
Activity: 9
Merit: 0
April 29, 2023, 09:37:03 AM
#1

Jump to: