My friend de always say its better to have a certificate you do not need than being in need of a certificate you do not have.
buy and hodl BTC now so you won't speak the motivation talk of " if like say I been buy am that time I for be big boy by now"
Thank you for the reminder as we need am, procrastination na disease and many people get this disease but them never know say dem get am. What's the difference between buying Bitcoin today and waiting for tomorrow to buy. If you continue to wait for tomorrow, tomorrow no go even come and if tomorrow come another thing go follow am come wey important that moment pass so you no go fit buy Bitcoin as you talk again.
Buy small small, no wait to buy in bulk but dey buy as your hand fit reach and that's the power of accumulating or DCA as we dey talk am here. No dey procrastinate, na devil dey work you so anytime you dey procrastinate, your friend talk well because e better to get something and you no need am than to need something and you no fit get am.
E just dey like nysc certificate wey People dey say e no important until future reach and na time to secure job or political appointments and dem no get the certificate making dem to lose the job. As dem say make we no gree for anybody this year, you too no gree for Bitcoin. Gum am body tight, as you dey receive salary so and they share money go everybody and every where put the one you go use buy Bitcoin one side too.