okay my country people, I greet una I just carry one issue wey I think say go make sense well well for our Nija board and most especially for our newbies them wey just start to use Bitcoin and cryptocurrencies. we know say one thing we everybody need to learn d most for this cryptocurrency world, na to know the best way to keep our funds safe. Many of us no Sabi thing wey we no supposed do to avoid lose of funds. cryptocurrency na one interesting world on it own, but bad things still dey sub everytime. some how we go think say e no dey possible for Dem to hack us thief all our funds, until e happen.nothing dey impossible for this world. I don see many people for this forum dey cry about how dem take thief Dem one way or the other con wipe all their funds. I wan use this means take show us some wrong things wey some people dey do wey go fit put thier funds for wahala.
1. connecting our wallet to unknown websites all in the name of free coins or airdrop. some dey call am faucets. just last week for here, I remember one topic wey I don write concerning this airdrop matter. I say make I still add am for this thread because this wan na common habit for some person. when ever we hear airdrop, we way rush go link wallet. some of these airdrop or faucet fit be scam. e dey hard to see better wan wey go pay you and even when Dem pay, the money no go reach you buy bread. so I no see any reason why we go waste our time and at same time put our funds for risk. to join airdrop no be bad thing oo, the only problem wey you go con get na when you connect wallet wey you take dey keep your funds put for these websites. just last week person come dey cry for forum say e go kill him self say Dem thief e funds. d guy go connect e wallet put for airdrop, unknowingly say na scam. Dem wipe e wallet. make we dey careful, even if we wan still collect these airdrop.
2. using third party software : normally, we know say many of us don dey use to mobile wallet. this one na because the hardware wallet, wey dey safer come day too expensive to buy. these mobile wallet dey easier to get with just few data you don install am. as we dey install am make we no forget say our device fit dey exposed to many threat for the internet. this one na why e dey important not to dey download anyhow app put for phone wey we don install and fund wallet put. some people go say they wan customize their key board, some go say them one add wallpaper join their phone, even ringtone app sef. These apps sometimes fit dey designed by scammers to get access to your phone. and normally, these apps dey always need permission to take run. so if you give them this permission, anytime you go online their creators go easily connect to your device without you knowing Dem go search for personal documents wey fit connect to any of your fund. let's all be careful.
3.storing you seed phrase the wrong way. we all know say our keys na one most important matter wey as a Bitcoiner or cryptocurrency person we no suppose use am take play at all. some people go just dey lazy to the extent of storing their keeps put for Gmail or online cloud apps. I still no know watin dem dey think Sha say Dem no fit hack Gmail or something. these days, many people Dem Sabi store personal documents well well for Gmail say na e dey easy pass.This wan na d worst practice wey most people dey involve Dem self. like this, your funds no even be your own at all. make you no dey forget say you no supposed leave your keys for any online platform no matter what. not your keys not your coins. These storages na third party dey run am and dem go fit get access to your files. Again, some people go dey snap their key dey store am put for phone as image. snapping images of our keys con keep an for our phone dey expose Dem to anyone wey get access to our device. normal Dem go see am as picture, but if bad person see an and e no watin e be, Dem go thief am take wipe your funds. even sef, if your phone loss or wipe then forget your funds. you go like to check this thread by (name) on how to store your keys properly.
4. no trust anyone we you meet online: okay, as many people know say this thing called internet dey sweet, still e still get many bad persons Dem. their sole purpose for there na to fish for victims wey Dem go fit scam. as person wey dey new to cryptocurrency, e dey easy for person to lure you into yeye investment. Dem go shine the lie well well for you to make you believe say na better one because you sef no get idea at all. this one na why Dem dey always dey advice people for forum, to dey careful with who ever you wan do business with. and most importantly do your own research well. there's no quick way to make profit, so if person dey cap give you say you fit make millions over night guy na lie. keep off from such.
this one na the few wey I fit talk put for now Sha, but make we dey careful as newbie. Nigeria don too hard to dey fall victims of scam. any money wey you get now, you know how manage you take sweat get am so make we all dey wise. On love my country people