the things wey person go fit learn when him dey HODL Bitcoin na:
1. No believe any price wey person predict give you.
2. No dey buy and sell for different different cryptocurrencies, those other crypto currency no get only one place wey person go fit dey trade am
and any coins wey no be bitcoin no too get value like that and e just be like person wey dey play gamble, the reason wey make them introduce bitcoin na to end this slavery wey dey now wey e be say any transaction wey person wan do you go pass through some body or some organizations before person go fit do transactions.
3. When every person come dey talk about bitcoin make you just know say you dey untop the bull run be that, although because of too much excitement you no go notice am o but na after the bull run na in you go understand am.
4. No dey trade other coin dem when you wan get bitcoin, u know say person understanding never reach like dat and person fit just go lose everything.
5. For the method wey dem dey call DCA, no go carry your mind dey trade or you come go dey monitor the market just invest your money den you leave am there.
6. No go dey too dey too anxious to dey tell people about bitcoin you know how people dey behave na if dem see say you too dey serious for dis bitcoin matter dem go dey feel say you wan scam dem even when e b say na help you wan help dem.
7. Learn to dey go places dem wey dem dey always talk about bitcoin e go help you know things well well about bitcoins. No just go stay on your own, dey try to dey relate with people wey sabi bitcoin well well.
8. When people dey ask you where dem go fit buy bitcoin just refer dem to all these BITCOIN-ONLY company dem. Those Bitcoin-only company them na in dey safe for people wey just start to learn about bitcoin.
9. Dey for #Bitcoin for Twitter e go help you to know plenty plenty things about HODLING bitcoin.
10. Dey very careful with people wey dey try teach you about bitcoin as some of dem dey good and some of dem na bad people too so you need to dey very very careful.
11. Even as in be say this bitcoin go make everything concerning money matter to dey easy for everybody but no go dey try to dey convince anybody. Na only people wey come meet you to know about bitcoin na in you go tell the important things dem wey for bitcoin and make people no say na bitcoin work wey you dey do.
I believe say with all these guidelines wey I give una e go help us when we dey HODL our bitcoins dem, una thank you. Source:
https://www.binance.com/en/feed/post/1138270?ref=22537208&utm_campaign=app_share_link