You see this our leaders, them don know sae blockchain na the future and the youths are into it badly. Them they find ways to support am the way they can, not to talk against am. For Tinubu to talk this kind thing, em mean am and em do am without doubt.
Tinubu na industrious man no mata any other businesses wey dey rumor say him dey into, the guy get version and many people dun confirm am say his leadership enforced the development wey Lagos dey enjoy so. Like no be him start am oh but wetin him do as him enter power priorities the development and others governors wey follow, follow him foot steps as na him put them there. The only governor wey go against am wey be ambode, dem commot am immediately.
Dem say tinubu na talk and do, so make we dey watch, tinubu himself know say this blockchain adoption go benefit plenty people for him home state Lagos even though dem no vote am and I believe him go try make this happen. What's there to benefit of him making us suffer it won't be any different from what other president has done and he might just want to be different from the rest.
From the beginning of the APC government in 2014 campaigns till taken over of government, Tinubu was the spearheaded campaigner who promised Nigerian youths millions of jobs. Till date one {1} job has not been implemented by the APC or Tinubu party in the country.
Immediately a president take over the seat, he's now incharge, nothing wey party go fit do am and I think that's what happened between Buhari and tinubu and might just be the reason tinubu wants to do it himself. Maybe him dun try to talk with Buhari but baba no gree thinking say him wan control am as him dey control everybody wey him put for seat. No forget say even baba been dey against tinubu presidency so obviously something was wrong between the two because how you go deny your master success.