Carry am 4 mind say u need help others to fit get help when in need cus as wen u grows old, u must need helps if not financial help but Errands and some health caressings.
This na why we need to invest on people and plans towards our tirement (old are).
No go dey help help people dey think say you dey plan your old age or use dem as your retirement insurance. People mind dey very unpredictable just because you help people no mean say dem owe you back help, the only way to plan your retirement na to make investment and this investment no be human resources like children, relative or others but business wey be say when you old, even though you no dey present the business fit run e self and dey deliver profits for you. Many of our parents no plan their retirement days and dat's why we have people that are meant to be relax and enjoying life still hustling in their old age. No be say dem no been dey ball when dem dey young or received better salary but dem no plan well for when dem no go fit work again that's why we have to be different, dis our generation need to have investment plans in multiple businesses so we no go get all our eggs for one basket.
Getting a retirement plan dey very easy to do but I no understand why our people no dey do am abi dem too dey live in the moment and no dey think about tomorrow. You fit dey invest 10% of your salary into any better investment way you know say legit like Bitcoin and you use am as your retirement plan. Make I say you dey receive 100k monthly salary and you invest 10% monthly wey be 10k, for one year na 120k you dun invest so and if you do am for 10 yes that's 1.2 million wey you dun invest be that, make we forget about the gains first but only reason the investment capital wey dey guarantee to come out from our investment and make we say we dey approximately 30 years when we get work and we work for 30 years that's 3.6 million investment. Even though the business no dey profitable and you only get your capital out, you can use that to do another new business investment and live comfortably without depending on anybody. Make we dey learn to invest and we'll be independent in our old ages.
I also look at some retired persons and even on their old ages them still dey cater for their responsibility financial challenges then u go hear the papa dey say... My son CryptopreneurBrainboss, u know say I no dey do much with money again, take this #100K support ur business, Charles Tim, u no get job, take this #200K start somewhere. I want renovate the house, I want buy 1 kabu-kabuka car way go dey carry me up and down cuz I no too fit for Waka about.
I think him dey execute all these on the course of him running investment. Super. 💪 na that type them dey say retired but never tire.