Author

Topic: To chop no be small wahala for the country (Read 548 times)

member
Activity: 224
Merit: 24
March 30, 2024, 06:05:39 AM
#51
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

There are a lot of reasons why things keep getting worse and worse every day. There's the bad government. They and their terrible decisions that are continuously causing detriment to the nation. There's the fact that people continue to export even though they know that that's what's making things difficult in this country. There's the fuel subsidy issue and many others.

It's the fact that when the dollar naira exchange was about 1800-1900 naira per dollar, surprisingly things were even better. Now that it reduced, it's as if the prices of a lot of commodities soared even higher than it was. This is to tell you that what was causing these problems in the country wasn't the exchange rate but a lot of factors that are bombarding on each other and the government continues to overlook these matters for God so knows what reasons. Only God would have mercy on this country.

member
Activity: 168
Merit: 75
Normally as the country be so, nothing dey easy again for us to do, true true to see food chop no easy as at all, no be person wey get money to buy food, na e go chop or no be person wey dey work, na e go see food chop, no work self wey person dey do wey go fit dey sustain person, to get work for the way our country be so na still big wahala, now na by begging we dey take dey survive, anywhere we see food, we chop because now, no be only us dey take care of ourselves, everybody dey take care of each other in one way or the other, now no be say I get everything o, now na I get person and we ourselves wey be traders dey follow dey make things hard for us, in a way say dem dey sale things cost. Just imagine say u still go hustle come back with small money and that small money to prepare food for you for dat day and the next day but u carry dat money go market see say u no fit buy even the least wey u go chop, na e make e dey advisable say make person no come dey depend only one source of income, because our country now no easy, we all struggle to survive and also by God grace too.
full member
Activity: 280
Merit: 151
God is All
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Everybody dey observe am but the thing be say nothing is being done about it but at first the government was blaming the naira falling for the high cost things but even as the naira is gaining on the dollar the price of things is still stagnant and one would be surprised what then is the real course and for me I think everyone both me and you nai dey cause thing.
full member
Activity: 196
Merit: 123
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

My brother of a truth, for we country now, to see food chop no be small thing, most house hold for my neighborhood wey dey live in abundance before, no dy fit eat three square meal again, some family na even one time then dy see food chop.

So my brother, as the country be so, anything wey you know say they put food for ur table, my brother hold am strong oo, just imagine how things hard now upon say you dy work, how e go be if you no dy do anything? So as a typical Nigerian wey we be, na to keep on grinding and wait for better days.
full member
Activity: 154
Merit: 108
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

One of the major serious problem in our country is the high cost of petrol, it has gotten to the point where marketers  will buy goods may be at #20000 but before the goods will get to their destination they may have spent #50000 for transport,so you see the one of the reasons why cost of goods has become very high. You bought something of 20k and transportation fee is 50k and you must sell it at an amount that will give you profits which is the aim of any business.
member
Activity: 70
Merit: 10
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Omo for this 9ja ehh to even eat two square is now a big challenge.you have to leave morning food and wait till 12pm and eat both morning and afternoon food. With the inflation in price in the goods of food.its really a big issue to be able,when you go to market today it’s a normal price and tomorrow another new price and this salary is very static and Hardly change.
jr. member
Activity: 98
Merit: 4
January 23, 2024, 05:25:16 PM
#45
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Wetin u buy today u go go tomorrow to buy am u go hear say en don add money. Why? dollar rise, nay d national anthem for inflation and every person one take opportunity of every chance wey come there way. My mother Dy cultivate cassava. Cassava when she bin sell two years back for #4000 she Dy sell am for #12000. I understand with her because if she still sell am for that old price the value of the money no go reach to buy other commodities for the market. Now my question be say, na who dy measure the degree of inflation for them In relation to dollar because no foreign exchange here.
jr. member
Activity: 21
Merit: 0
January 22, 2024, 01:19:02 PM
#44
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

Brother no b small tin for dis our country Nigeria o,the major cause of high price especially foods in particular for consumption as a result of higher cost of fuel imagine fuel of #500 dat can take a bike man for a week,can only last for one day imagine how hard it's for Us so many people increase the price of food items bcox transportation don cost , secondly we have shortages of farm production bcoz of other places wey they dem dey produce food to save for Nigeria like some party of the states like niger state,Kaduna State zamfara etc bandits take over those areas and didn't allow people to go farm Nigeria is getting out of hand we pray for better Nigeria Amen
jr. member
Activity: 67
Merit: 7
December 06, 2023, 08:53:12 PM
#43
For this naija now to eat belleful for local restaurants u gats hold like 1500 or 1200 minimum o if not e no go bellfu u everything don cost and na so market women dey reduce there hand naija suppose don dey produce agricultural produce for export I no know wetin be there problem per say, If our country continue like this na be say our children go really suffer if we no put some basic amenities in place to help there future, I no blame those wey dey jakpa if na me na the same thing I go do, na to go find greener pastures for better country because this country no way
full member
Activity: 462
Merit: 145
December 06, 2023, 06:41:26 PM
#42
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Nigerians are reaping the effect of allowing a bad government remain in power because consequences dey always dey for all this kind matter. This nor be time to dey over chop anyhow, person need to start to dey plan their meals well, because the price of foodstuffs dey increase regularly. Some ways wey you fit use take help yourself na to;
a) Cook more at home than buying food. You go spend money to cook, but e go save you more than when you continue to buy food. If you dey buy food make e be once in a while.

b) Buy foodstuffs for plenty quantity, nor dey buy small small things because you go dey spend more.

c) You fit start to dey do agriculture, dey try grow some things wey you dey chop if you fit.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
December 06, 2023, 06:30:30 PM
#41
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this .
If I ask you when last you buy the infamous Abakeleke rice, I doubt say you Dey buy am. If e reach buy cloths, we go commot body for Aba made, Dey fine designers, British and US brands, we don Dey even fear made in China. We no Dey too patronize our country and na for good reason shah, via say fake plenty but that na due to watin, low patronage still count because, people no wan put better on stick and have a long growing mentality run the business to a lose. We gats first buy Nigeria to boost our economy.
Corruption matter still Dey o but, we need buy Nigeria kwa.

Another thing way Dey there to understand be say,
These products we Dey feel say, na locally made or produced. These persons way Dey sell am, them dey sell am so them fit get money buy other products o. Most of which might not be locally produced. If them no sell with better price, them fit no get money to buy watin them need or to restock. E reach everybody but, some people no Dey tool fill am. Na so e just be.
sr. member
Activity: 266
Merit: 276
December 06, 2023, 03:43:48 PM
#40
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

OP, since when you create dis your post reach now, d price of chopping breakfast don pass d amount wey you talk before. Dis na just within three months and things just dey worse dey go for the country. Dis no be wetin we plan for or wish for the country but as things dey go now, we need divine intervention from God to help us see through the minds of our leaders wey dey make things hard for us and life unbearable for us to live in our own fatherland. I just hope that tomorrow go better pass today soon.
Unfortunately, OP no they again for the forum and e account done they banned for a long time. If not him for they see say the true true the country done really hard and people no they see enough food to chop. For Nigerian if person done chop two times a day you done chop weting no nice. Because sometimes no be chop o, when you look your responsibility and things wey they your hands to do my brother you go they minimize the way you they spend. Last last food no be everything, even as God done make our body to they hungry sometimes we they feel like we no one chop and money go they our mind.
full member
Activity: 322
Merit: 166
December 06, 2023, 02:23:15 PM
#39
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

OP, since when you create dis your post reach now, d price of chopping breakfast don pass d amount wey you talk before. Dis na just within three months and things just dey worse dey go for the country. Dis no be wetin we plan for or wish for the country but as things dey go now, we need divine intervention from God to help us see through the minds of our leaders wey dey make things hard for us and life unbearable for us to live in our own fatherland. I just hope that tomorrow go better pass today soon.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
December 06, 2023, 09:26:23 AM
#38
Many are finding it so difficult to earn a living due to the rate of increasing inflation in the country, things are just getting more complicated instead of getting better because there's no much avenue for some people to get opportunities in surviving through the economy hardships that's going on, we cannot conclude that this is only affecting our own country alone, other countries got affected too as well, but when we plan to have a sustainable alternative on our own for the sake of ourselves and the dependent family we have, we may not be really affected, we can also encourages farming for the settlement of the demands on food items.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 06, 2023, 09:16:11 AM
#37
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

My broda dis one wey dey you like say nah new thing to you shock me oh, things no dey increase on a monthly basis oh nah daily, go market to buy something of #1500 the next day dat same thing go cost #1700. Like is crazy my broda, I dey see all these things as high cost of fuel prize if not every where for balance, because nah transportation them go blame am put.
Man no fit use #1000 chop again complete food again and we never really see how to manage December spending as we dy so. But no matter how e be people wey complain say things hard, prizes of food stuff don fly go up, with all these complain people go still buy plenty things for Xmas celebration trust me.
full member
Activity: 308
Merit: 197
October 06, 2023, 08:15:41 AM
#36
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

 I day tell you with watin day sup for the country, hunger day wound some people, this inflation really touch everybody both big and small, too chop com be major issue for some people. Cos of this issue people eye day red and day fit do anything to make this bread. Even to commot sef the transportation allow go discourage your movement, due to fuel money wey go up too. Most of watjn we day chop and use for this country we day mostl import them and now way boarder day close due to policy from government, all this government policy na watin day make us suffer like this, 1k our highest currency no day last again, naija which way ? Pressure and tension don day rise ooo…
   Government no try at all they no reason us, we no day ever day their plan, our country na enter chop your own commot and the money dey go round for their circus. Na person way open eyes go fit commot from this slavery, make we no go loose guard get hope for our government, every body day find way cause they know line don scatter for front. Our problem go need special intervention if we wan commot from this bondage. Our old men for office no get any remorse at all ee no concern them cause they no day see watin day sup for them Street. Na to get hand work because na only fit save yourself and of course with God by your side.
jr. member
Activity: 42
Merit: 1
October 05, 2023, 06:39:08 PM
#35
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

This thing wey you talk na true oo but the major thing be say e don happen and our government get hands on it and at the same time we too because na we they vote them. I go advice say as things they cost make we too they Hustle because no food for lazy man for this country. Furthermore make we try get hand work and we should not depend on government totally ooo.

This money wey you talk like this even better for some places you no fit see anything chop oo, and that's why we Dy here in order to gain knowledge about bitcoin and to better our life with gained knowledge. Make we they help each other ooo e no easy to go through this country like this alone sef
full member
Activity: 560
Merit: 161
October 04, 2023, 06:10:17 PM
#34
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
The thing be say naija people like to dey use everything as opportunity to make money, e get somethings like even leaves wey everybody can plant in their houses if you go market here the price it is still expensive,  the price of things in the market increases everyday . I no still understand wetin make garri and rice Don dey do competition for price now, garri is the last hope of the common man wey be say every man fo fit afford to buy but now it is one  of the most expensive products in the market.  Almost every indigenes of every village produces garri,  e no suppose go up.
jr. member
Activity: 34
Merit: 14
October 02, 2023, 04:45:55 AM
#33
Since wey my mama born me, we dey pray make eh better. We dey complain of the previous administration, now we have come to realize that Buhari really loved and took care of us as a father. Since the ascension of the new administration, I saw myself going broke. My clients I render some services for at least 5k now came back begging for the same services to be render at 2k or even less, I had no option than to render the service cos these are the ones that pay any amount I charge them to render such services to them. The money on my account started dropping drastically, when I realized myself, i saw 3k in my account omo! I cucuma carry my bag enter village go chillax waiting to fall back to the street when Christmas season approaches. Eh choke!
member
Activity: 334
Merit: 27
October 01, 2023, 06:08:25 PM
#32
The increase in fuel price is nothing but the major cause of the problem, even if all Nigerians have farm today, there will definitely be hunger. Let me make it clear, the vehicle and motor cycle requires fuel to power them before they can work and that will definitely make seller to add their expenses to the product before selling to consumers or industries. Whatever that is produced by industries will also bear the effect of fuel as some engines uses fuel while others that uses light also have their bills, all this will throw the price of the final product up. Apart from fuel, light is another problem, do you know that most of the power plant in Nigeria ate powered with diesel? , You can Google search it. If the cost of fuel is up, then the cost of electricity will also be altered technically.

Do you also know the level of insecurity in Nigeria? As it stands now, in some places, farming in remote area is a suicide attempt. There lots of causes, to this problem.

One among this problem that the government both federal, state and local government should be concern about is the market manipulation, once their is a rise in price of goods, sellers don't beat down their price even when the price falls back.

God go help our naija in the season as we dey hope for better tomorrow. One love, one naija
full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
October 01, 2023, 06:01:37 PM
#31
The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service.
Abegy which average Nigeria citizen wey dem d pay 150k per month? I wan see them cos this 150k wey you mention don mad me cos I never hear or I see any graduate wey d pay such amount of money at this time wey em d hard some state government to even pay the small minimum wage wey be 30k. Even the recent minimum wage wey NLC d ask of, FG no wan implement am into law.

Abeg help me ask am well o. This one sha shock me reach my bone marrow. Why this person dey talk like say e no know wetin dey sup for Naija. Make we even say dem born you inside sliver spoon, yet you supposed to know say average salary for Naija no be 150k na. For this one, me and you no need Google am.

If you dey on ground, you supposed sabi say na only Federal works dey even pay above 100K for a start at level 8. For state, some Directors wey I know no dey really collect pass that o. E go shock you self. Na why plenty civil servants wey no get heart dey fit still government money be that. As Director, person don dey near him pinnacle for him civil service career be that, yet see wetin dem dsy offer am. Something around what another person wey dey work NNPC or so go collect for a start. Because I forget to mention say, no be all federal works sef dey give 150k for start o.

We no dey talk about this because say we dey happy about the status quo but the last time wey I check, our minimum wage no pass 30k. That na just around 30-35 dollars. Abeg, as you dey comot house every morning of the week dey go work place come back by evening, your minimum wage na 30k. Wetin you get to come show for house and how you wan take handle your bills when fuel subsidy removal kasala don burst too.

For our information, FG been just announce this evening, after him meeting with the Labour, say em go increase the provisional minimum wage for all treasury-paid Federal Government workers to 35,000 naira for the next 6 months. Chai, na him someone dey call 150k as average? Dey calm down na bros.
full member
Activity: 252
Merit: 157
September 30, 2023, 04:14:37 PM
#30
The mata no be small thing ooh, the rate at which commodities food stuffs and other things are increasing everyday is not proper at all, how can as big as Nigeria nothing like price control and not even that government is not aware of all this increment on commodities but they choose to ignore it and watch people surfer, actually is expected of the government to make things on a equilibrium state by implementing price control and enforce it using agency that monitor all the selling activities, at least with that things would have been a bit chipper and affordable.
full member
Activity: 560
Merit: 161
September 30, 2023, 02:15:27 PM
#29
It is so painful that if you calculate the amount money wey they come into your hands for the month, you see say about 50-70 % of this money dey into feeding.  Things too dey expensive for market,  and the funniest thing about the price of food be say the price still dey go up. The things we plant by ourselves wey suppose dey cheap dey increase in price too, for me I feel this people wey dry sell food wey no suppose cost dey use the inflation as advantage just to make more money. I think things dey get worse instead of getting better, the price of food for market Don finish the poor since and now dealing with middle class people. People who are earning no fit afford food because of the high price.
newbie
Activity: 28
Merit: 6
September 23, 2023, 05:02:08 PM
#28
Sometimes when I reason how things dey add money for this country ehhn I dey weak. And nobody wants to do something about the inflation, bag of rice now is 49 thousand and the cost of fuel follow join. One thing have learnt this year is buy this thing now if not money go enter tomorrow, and that's very bad. Na only God fit save Nigerians oh
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
September 20, 2023, 01:56:32 PM
#27
The reason why our farm product d cost even though we d produce them na base on the increment of fuel price. The increment of fuel contribute highly on am, in the sense of na transportation wey d farmers d take transport their farm product from one city to another. You no expect the farmers to pay hugely on transporting the farm product to the city without adding the money spent in transporting to the farm product produce.

The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service.
Abegy which average Nigeria citizen wey dem d pay 150k per month? I wan see them cos this 150k wey you mention don mad me cos I never hear or I see any graduate wey d pay such amount of money at this time wey em d hard some state government to even pay the small minimum wage wey be 30k. Even the recent minimum wage wey NLC d ask of, FG no wan implement am into law.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
September 20, 2023, 01:46:40 PM
#26
One major reason everything come dare like this  na the cost of transportation  and fuel increase drastically  and you go agree with me say this raw materials wey you dey talk but so, go still need transportation  to fit reach the needed and necessary place and you go agree with me say this commercial drivers no come to play at all, another thing na the very bad state of our roads as this they also contribute to major hike in prices of every other thing.

This topic the very similar  to topic i been read of recent for the local board and seriously,  cost of living wan truly kill the living.
sr. member
Activity: 560
Merit: 408
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
September 19, 2023, 07:20:51 PM
#25
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Oga ooo dis matter wey you bring so dey comfuse me well well, di way wey tins dey go self na only God fit come help us for this matter ooo. Even the government dey comfuse too. I no worry my self again for  issue, my prayer now na to ask GOD make him dey give me food they chop,
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE
September 19, 2023, 04:54:11 PM
#24
This matta no be wetin man go kill himself for because i know say everyday by day na so tins dey increased in our country without any cause of it or something that stirs it up.. Make I say Garri wey me carry from home to ph i spend like 10k while the garri na just 1 bassen wey be say i buy am 5k then transportation make am reach that level, this come trigger something for my mind say reason why some food stuff dey expensive even though na we dey produce am na onto say transportation dey high and the reason for this transportation matta because of fuel dey on a higher amount so to carry something from Northern area to the Eastern region go almost take you 10x of worth of produces wey you carry by this the seller ( That is, whole seller go increase their prices then sell to the retailers, the retailers will increased their prices and sells to the final consumers) which e come be me and you.

Na wetin make food matta come dey tire pesin for the country, anything you wan buy now carry belle so as you dey touch am you dey high tension because immediately you touch am come price the price alone go shock you and you go drop as e dey hot. For now nothing we fit do and the only remedy be say make you try get small garden for your compounds so that you go plant some things like, pepper, scent leaf, ugu leaf, bitter leaf, also you plant cassava if possible add am cucumber make you know say you don reduce expenses entire. Some people dey even go far put small poultry farm for their compound wey be say any time them fit kpai one chicken take make food eat while some people dey put fish ponds inside their compound as well.
full member
Activity: 322
Merit: 146
September 19, 2023, 04:37:01 PM
#23
Diz kind agenda dey make lot of us talk pass ourselves oh... Sometimes beyond what is called for cuz the situation on ground is frustrating.

Those days 4 primary schools, we dey call flogging "tea without sugar" na him Odogwu Burner boy com bring up update say heart broken na "breakfast".

Now I fit just say we dey chop " tea without sugar for breakfasts" for this country as e be.
Bro, rejoice say u get #700-#1K for 2 time meal on cuz some families dey find that amount to make a general family food yet no way.

Well as u ask, fuel na the source of the hiking of goods and services for our society today.
Our govt say dem want elevate national economy dey boost say in just 100days in office dem don save over #100B. But I ask, on what essence dem dey realize all these funds for way citizens dey perish? No he say dem dey use am assist to lives oh but all aim to feed more of their pockets.

full member
Activity: 448
Merit: 117
September 19, 2023, 12:34:28 PM
#22
OP your talk really catch my attention no be small. This same question Na wetin I don dey ask myself for long now.  Fuel price increase no be say na all the products wey dey Naija wey dem dey import o. The locally made goods wey we dey produce here how far?  The garri wey we dey produce here how about am? The rice and other agricultural produce too nkor?
Me I believe say within this level, Na we Nigerians dey do ourselves. Where e dey very clear Na the very first dey Mr. President make him acceptance speech wey him talk about subsidy wey make all filling stations close down immediately Na there I know say Na we dey do ourselves for this country. You go imagine say any small rumour wey just circulate about strike or fuel the next thing you go hear be say marketers no go sell again. Them go begin hoard their products dey wait for price increase so that dem go begin sell that same product dem buy very cheap at a higher price. How the country wan take move forward with this kind of actions now.

Most of these food stuffs wey we dey consume here for Naija no be import we dey import dem. Na just be say vendors and marketers  dey take advantage of situations to the detriment of the masses. Wen you ask a vendor why the increase in price wetin you go hear Na fuel price even for market too Na same story you go hear for vegetable leaf wey dem dey plant here too.
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
September 19, 2023, 11:38:58 AM
#21
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

Anyway that we see in this country we dey live on it, if anything happens it will not be a new thing. Breakfast wey you dey spend up to 1k all the time in some places you can just spend like 5h for breakfast and e go do you, na every place things dey cost but who are we going to blame? People fit protest from today to tomorrow we go just dey shout nothing go change for this country because even rich people sef don dey complain this one no be for only poor people again everybody don dey see shege wey government dey show us but money still dey where e dey most of people no go even complain over this challenges that we are facing now.

All this issue na fuel subsidy cause am base on my view, because if fuel no cost food sef no go cost, but base on say fuel don cost it will touch prices of everything, i believe say we go dey keep on buying things like this till next year before we see any changes from this country if not now things has town down already make we sha just keep on with our hustling.
full member
Activity: 294
Merit: 168
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
September 19, 2023, 07:04:07 AM
#20
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase every month to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use to make process food we get am, how come everything cost like this. Watin we go say be the cause of this one now. E Don vex me all person money now dey go for food. Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
This 700 - 1000 naira to use chop breakfast na only if now one person wants to take the breakfast, and you no go chop belle full so that the 700 or 1000 naira go do you for the breakfast.

In my view, flooding and the high cost of fuel are the costs while some things do cost for this country.
For instance, if flood happens as e happened last year, e go make people way get farms in those areas where flood enters to harvest their produce when e never matured and sell it at a low price, when those people way flood no effect go harvest their farm produce to sell for market, them go sell their farm produce at a very high price because say e dy limited for that period

The high cost of fuel follow keeps our country like this, we know say anywhere way transportation cost standard of living goes dy high too. Even to visit  person from this country na war if you reason money way you go spend for transportation you go just say make you relax o. Before to go buy garri from village come city to sell go cost you small money for transportation but now to buy garri from village come city na war because only the money way drivers go take from the garri way you carry go almost come out the money way you used to buy the garri half. Na this thing cost if them done dy successfully bring garri  come city them go sell one custard 1700 naira to get gain for their business. Na all these tins I talk above na in me see dy cost why food items dy cost for this country so.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
September 19, 2023, 06:40:18 AM
#19
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

Who tell you say we dey produce most raw materials wey we need to use arrange food, why the cost of foodstuffs dey high na our bad government. The bad government come dey affect the economy and when market woman dem go market things dun cost for that side because of importations and after them buy dem go need sell am costly too so dem fit make back their capitals and gains. No forget say dem no wake go buy this things, dey enter transport and due to the increase in fuel prices in the country, transportation dun add e own and when dey add all their expenses, to make small gain self dem need double the price of the goods wey dem dun buy or increase more than double just to get better gain. We also get some wey dey over greedy and dem dey add price without conscience.

The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service. Unfortunately, base on the currenct economic realities of our country, 50% of this fund is spent on feeding. This is to say that many people are leaving from hand to mouth because the remaining 50% is not enough to cover to shelter, health, clothing, utilities and other basic amenities.

Where you dey get dat statistics from say dem dey pay average Nigeria #150k abi u dun forget say our minimum wage na #30k and no need to dey convert am to dollars, na we we dey hear so we understand ourselves. Na local board be dis and everything need dey local. Wetin me I know na say the average Nigeria salary na #50 +/- and I dey putt together all the official and jobs wey dem dey pay #70k, #80k, #90k etc and unofficial jobs wey dem dey pay less. The big jobs self go hard before dem pay you reach $100k and dat's if you see the job oh because wetin I know na say job no dey the country and now all this filling station attendant, super market attendant and other small small private companies jobs na him dey and those people dem no dey pay dem pass #60k.
hero member
Activity: 798
Merit: 546
September 19, 2023, 06:39:40 AM
#18
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase every month to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey they dey use to make process food we get am, how come everything cost like this. Watin we go say be the cause of this one now. E Don vex me all person money now dey go for food. Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Concerning the current situation of things in Nigeria, E dey clear say the problem we get for we country na money inflation and price inflation join body,  as the dollar dey go up steady against the Naira ($1/960 current rate), Na so the cost of importation of goods and services, plus food prices will as well dey go up because Nigeria relies mostly on the important of goods to survive, hence making the country a consumer as supposed producer.

It is really annoying to witness the current skyrocketing and instability in the price of things in Nigeria, when you go to the market today to buy something, if you go the next day you find out that the price has dramatically increased, that's insane.

Our bad politicians contributed to this harsh situation in the country due to their selfishness and is affecting everyone, forgetting that both the poor, middle class, and rich go to the same market.
legendary
Activity: 2254
Merit: 1052
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 19, 2023, 05:47:58 AM
#17
Op abeg, try relax a bit, making more than one comment in a roll is considered spamming on this forum, and it could lead to ban, try go through the forum rules to get a better understanding of this ..

When you have more than one comment you want to reply to, what you need do is use the "insect quote" function, you can find this function on the top right corner of every comment posted on the thread when you are on the reply page..
See the screenshot below to better understand what I mean..

With the insect quote function, you can reply to as many posts/comments as possible in one comment, instead of having to reply one after the other in a roll; which is I forbidden.

member
Activity: 64
Merit: 32
September 18, 2023, 05:19:36 PM
#16
Nigeria has gone from worst to too bad, sometimes I see a good reason to say that our leaders has no conscience, how will you allow the people that you are leading to die in hunger, our leader doesn't like the idea of licensing more production companies or better still encouraging small firms that are into production, because most of them have share or quota in a particular man business that have decided to keep his people in the dark by inflating the price of everything through the help of the government, Nigeria has everything within her reach not to allow it's citizen suffer, removal of subsidy has been the major cause for the suffering of Nigerians, a government that wake up and announce the removal of the only thing the citizens benefit from, without putting things in place to caution the effects that may arise as a result of this, I think its time for the right thing to be done, because the current hunger in the land is so unbearable that, it takes God to control people not to do otherwise, Nigeria needs urgent revitalization, and that's the way we should go.
Yes this is true the major problem here is bad and over corrupt leaders. Imagine tinibu saying its his turn ,meaning say them wan dey suffer the citizens turn by turn as we dey elect new presidents suffer dey increase even comon water pure water the most common of them all Don cost now u no fit buy water for you and your friends without thinking the thing. Now fuel wey the crude just dey under our land here don dey so expensive.  Tinibu just come comot subsidy wey we dey benefit from . This country na wa oh

Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
All these high price of everything for Nigeria na because of fuel subsidy wey Tinubu remove. Ever since Tinubu took over power the rate of hardship is increasing day by day to the extend that a poor man might finf it difficult to feed. I notice that the price you buy something today will increase the next week when you want to buy that same stuff.

Feeding is a basic need but the government don't understand this and they want the masses to die in hunger strive. No be small money I dey use feed myself alone for this place wey I dey. If I want to cook I will spend up to 3k but when I visit mama put, 1K no dy reach me chop because the food go small and some places only meat or fish will consune upto 500 naira talk more of the food itself. Poverty is really a major challenge in this country because the government have chosen to kill the poor people with harsh economy. All our gals are now on the street because of what they want to eat and some have been killed by ritualist, only God knows when Nigeria will become a better place for people to live happily due to good economy.

The most painful part of it is that the unemployment rate is also high . To see work do so u fit buy that expensive food no easy ,as I dey you like this my guy wey finish school still dey streat na now en wan learn affiliate marketing from me. My advice to every Nigerian is to start earning in dollars if not this hardship go finish you
sr. member
Activity: 322
Merit: 274
Baba God Noni
September 18, 2023, 11:40:33 AM
#15
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
All these high price of everything for Nigeria na because of fuel subsidy wey Tinubu remove. Ever since Tinubu took over power the rate of hardship is increasing day by day to the extend that a poor man might finf it difficult to feed. I notice that the price you buy something today will increase the next week when you want to buy that same stuff.

Feeding is a basic need but the government don't understand this and they want the masses to die in hunger strive. No be small money I dey use feed myself alone for this place wey I dey. If I want to cook I will spend up to 3k but when I visit mama put, 1K no dy reach me chop because the food go small and some places only meat or fish will consune upto 500 naira talk more of the food itself. Poverty is really a major challenge in this country because the government have chosen to kill the poor people with harsh economy. All our gals are now on the street because of what they want to eat and some have been killed by ritualist, only God knows when Nigeria will become a better place for people to live happily due to good economy.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 18, 2023, 11:29:50 AM
#14
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Na inflation cause everything,  because most time what Nigeria produce is raw materials and not finished goods because in most cases,  we still import almost all our basic necessities a d this have left us at the mercy of foreign exchange rate,  which now determine the price of basic goods in the market,  and that is the cause of the current economic downturn that we are witnessing today in the society.

Basic needs have become out of reach for the ordinary citizens and also the cost of living in general talking about housing and the rest of what have you have all gone so high that survival now is just by the grace and high calculations.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
September 18, 2023, 10:45:48 AM
#13
The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service. Unfortunately, base on the currenct economic realities of our country, 50% of this fund is spent on feeding. This is to say that many people are leaving from hand to mouth because the remaining 50% is not enough to cover to shelter, health, clothing, utilities and other basic amenities.

If urgent steps are not taken, people will drift towards depression and that is not good for a country with population of 200 million people. 

Even earning 150k monthly relies on the industry you work in, and even gaining the money isn't helping much; the money can't even keep up with the bills because the person generating the money is still battling to stay up with the whole scenario.  And the government has refused to revise the minimum wage, at least because the price of things is not friendly to people at all, from the price of fuel to the price of food. Everyone is just trying to survive it is no longer about how well you are doing. because even housing is becoming ridiculously costly, because despair is terrible and leads to a slew of unpleasant outcomes, both mentally and physically.
full member
Activity: 266
Merit: 140
September 18, 2023, 07:24:27 AM
#12
The problem of this our country now don get worst seriously no be waiting we sleep with we go wake with how we poor go take survive wey everything just dey high every forking dey, I can blame the farmers because even they're working materials don cost no be wetin de bort it last season dey sell am this season. Especially fertilizer wey before 1bag no pass 15k to 20k and now it's almost 50 to 60k, all the course of the does problem is do to bad government that we have, my brother is only God that can Stand for us if not the course of living wan killed the living.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
September 18, 2023, 06:15:27 AM
#11
If to say na only food nai the economy affect e for they some how easy for those set of people way base for their villages because them for they do farm works take they feed them selfs and their families but since e be say nah everything nai they affected even the people way live for Town, city and villages they suffer, whether you get money or not e go affect you as long as say you they this country.
One thing be say as Nigeria they so, nah very big country with over 223,804,632 people both the citizen and non citizen they inside even good and bad self they, but the bad plenty pass the good nai make we they suffer.
Nigeria is @62 years so far and I don't know why the country economy is so bad to this extent that even the rich is complaining, now image the rich people complaining, so if the rich is complaining that means the poor will cry for hunger.
full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
September 18, 2023, 03:14:30 AM
#10
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

This matter carry plenty kassala for head. I dey always dey scared to even discuss this kind of matter because I no fit even imagine how I dey take cope on top this economy again. Na why person suppose dey thank God fof the level wey we don reach so far. For basically being alive.

The way e difficult to get money now for the country, e be like person wey wan climb mountain everest with him bare hands and feet. On top of this money and job unemployment, things con dey skyrocket and none wan come down. Even dollar and fuel just dey rise they go at their peaks.

The question be say, how poor man wan take survive like this, when to eat better food on an average now reach ₦1,000 naira per meal. And an equivalent of ₦3,000 per 3 square meal.

With the figures wey dey above, make we take laborer wey dey do strong work for instance. As a laborer you need eat food make u get energy do work. How much be your payment for 1 day wey you work? For this side of the country e no pass ₦2,500 per day. Now make we say, the laborer wan drink tea and bread for breakfast which takes like ₦500. Small lunch come be like ₦800 and dinner like ₦800 too. That na total of ₦2,100 out of the ₦2,500 wey him collect with ₦400 as the change wey remain.

Abeg, when this person wan buy clothes to wear, buy other person needs, pay house rent con even send small back home?

You see, this and more na the reason why people dey sleep under bridge and na why many people dey hostile to each other.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 17, 2023, 06:39:35 PM
#9
E Don vex me all person money now dey go for food .

My brother no be only food wey the thing affect. The falling standard of living affect every aspect of the economy, e just be say na food we dey deal with every moment. Okay see, people wey dey sell food put money for am or reduce hand for the quantity and quality wey dem dey sell because say other things too wey follow for wetin go make food cost, transport to go buy the incredient, kerosene abi na gas. Abi house rent never dey increase for your area? Oya wait make you finish the rent wey you pay for and to renew am you go sabi say rent too don increase because landlord or landlady too dey buy things costly and dem too go increase the rent wey dem dey from feed. My brother the thing na circle, no be only feeding e affect.
member
Activity: 64
Merit: 32
September 17, 2023, 05:35:19 PM
#8
Nigeria has gone from worst to too bad, sometimes I see a good reason to say that our leaders has no conscience, how will you allow the people that you are leading to die in hunger, our leader doesn't like the idea of licensing more production companies or better still encouraging small firms that are into production, because most of them have share or quota in a particular man business that have decided to keep his people in the dark by inflating the price of everything through the help of the government, Nigeria has everything within her reach not to allow it's citizen suffer, removal of subsidy has been the major cause for the suffering of Nigerians, a government that wake up and announce the removal of the only thing the citizens benefit from, without putting things in place to caution the effects that may arise as a result of this, I think its time for the right thing to be done, because the current hunger in the land is so unbearable that, it takes God to control people not to do otherwise, Nigeria needs urgent revitalization, and that's the way we should go.
Brother I dey with you on this one , our leaders are seriously forcing every body to madness see the way the country is going confusion every where , our own president his certificate is not proven, them just calm down sell us finish . Then them come band the only thing I dey use chop Bitcoin make them come stop me nah
sr. member
Activity: 350
Merit: 295
September 17, 2023, 05:02:41 PM
#7
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

You are speaking about yourself of the whole nigeria? I'm asking because I'm not sure if 1k is enough to feed me because baba, me I dy chop well in the morning and I make sure everything set. Let's look at it this way bro.
A loaf of bread soft one fit cost you ₦800, milk tin now na ₦500, you buy milo or any other beverage to add as ₦200, that's like ₦1500. If you come say you wan fry egg join, na more than ₦2,000 you dy spend be that. Na average wetin you fit chop as naija be this because I know no wetin you wan do with ₦1,000, e no go do except you wan dy drink akamu in the morning.  Grin

Now back to the matter, brother man, the truth or this matter na fuel subsidy removal na why everything don cost like this. Any sales that involves transportation has increase the price of their products and it's a normal thing in economy that when basic price of things are increase without alternative, other price of goods and services will also increases because they need to adjust their financial support to meet the current state of the economy. If price of rice was ₦1,000 and then the price jumped to ₦3,000, expect every other price of things to increased because the sellers need rice, they will also adjust their price so they can e able to buy and eat too while maintaining their business.

There is nothing in this country that does not need transportation and as long say the price of fuel they up, we go dy buy things high but if they are able to stablise the USD at the current price that it's been sold, things will be stabilized for a while because we depends on refined fuel from outside the country and if dollar price continues to go up, then every price of goods will increaeas well.
legendary
Activity: 2254
Merit: 1052
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 17, 2023, 07:48:29 AM
#6
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
I am actually wondering what kind of breakfast some one would be eating for such a small amount of money, except you were only talking about bachelors and spinsters and forgot that there are also many of us that are married and have children to feed as well ...

I know for a fact that anytime me and my family wants to take tea and bread for breakfast, I spend nothing less than #2,500 on just bread and tea alone, before I begin to consider eggs and spices and any other stuffs we might need to make the meal sumbcoius.

Anyways, the current situation in Nigeria demand that we not just work hard, but pray hard too, because in as much as we really need to earn more so as to be able to keep up with all the expenses and the loss of the purchasing power of the naira, we also need to pray hard to God to make the means of earning more money available to us, because I personally believe that it's only by the help of God can we prevail in the current situation of the country.
sr. member
Activity: 350
Merit: 335
September 17, 2023, 04:42:21 AM
#5
The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service. Unfortunately, base on the currenct economic realities of our country, 50% of this fund is spent on feeding. This is to say that many people are leaving from hand to mouth because the remaining 50% is not enough to cover to shelter, health, clothing, utilities and other basic amenities.

If urgent steps are not taken, people will drift towards depression and that is not good for a country with population of 200 million people. 
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
September 17, 2023, 04:06:15 AM
#4
Nigeria has gone from worst to too bad, sometimes I see a good reason to say that our leaders has no conscience, how will you allow the people that you are leading to die in hunger, our leader doesn't like the idea of licensing more production companies or better still encouraging small firms that are into production, because most of them have share or quota in a particular man business that have decided to keep his people in the dark by inflating the price of everything through the help of the government, Nigeria has everything within her reach not to allow it's citizen suffer, removal of subsidy has been the major cause for the suffering of Nigerians, a government that wake up and announce the removal of the only thing the citizens benefit from, without putting things in place to caution the effects that may arise as a result of this, I think its time for the right thing to be done, because the current hunger in the land is so unbearable that, it takes God to control people not to do otherwise, Nigeria needs urgent revitalization, and that's the way we should go.
full member
Activity: 280
Merit: 159
September 17, 2023, 02:13:20 AM
#3
I have already done a survey on this issue, and what I discovered is that all this issue comes from the cost of fuel because many farmers that farm are complaining that the amount of fertiliser is very high and the cost of transportation from their various locations to the city is very high, so if they don’t increase the amount of product they sell, they will end up losing money and might not farm again. I even visited some near-by villages, and some farmers told me that they just farm what they can profit from, and most maize farmers didn’t farm maize this year because of the high cost of fertiliser, so with this, I can say Nigeria is getting to something else. All I can say it let work hard and pray
sr. member
Activity: 420
Merit: 262
September 17, 2023, 02:05:09 AM
#2
700 -100 Naira for breakfast self depend on where you de leave, e get some places wey that money no go do you to chop. You talk say we de produce d raw materials wey dem take de use produce some of dis good and e still cost, d reason be say d cost of production and transportation don go up and even farmers wey de farm d product self de buy other things, so as other things de expensive dem also make what de produce to be expensive so dat them go benefit from their work because even fertilizers now wey dem de use don cost and government no de support de like dat.
member
Activity: 64
Merit: 32
September 17, 2023, 01:52:52 AM
#1

Jump to: