Author

Topic: To crush oil thieves, you must step on toes---Niger D stakeholders to Tinubu (Read 19 times)

member
Activity: 159
Merit: 39
The issue of oil theft no be news to us as naija pipo and e dey dey worrisome to a point because e go affect the oil economy and cause insecurity  and also affect the business of prospective investors in the oil and gas sector.

Stakeholders of the Niger Delta don advise our presido to calm down in him bid to crush oil thieves as to do such, e go gats step on powerful toes. Why e be say don tok like dis na say most of the rotten eggs wey dey participate in this crude oil theft na top ranking officers like the Police, Air force, DSS, Navy amongst others and say dis oil thieves dey use technology and instead of always fixing breached pipelines,  make e use tech solve d mata.

The way I see dis one, if Tinubu achieve am, e go go a long way to solving economic problems and fixing corruption. How una see dis advice? E fit dey achievable or Presido just dey do gara gara?

https://www.vanguardngr.com/2023/06/to-crush-oil-thieves-you-must-step-on-toes-niger-delta-stakeholders-tell-tinubu/
Jump to: