Waytin be life if you no enjoy? Abeg make everybody enjoy oo because na one day you go kpie. If na for you to sell Bitcoin chop be the thing sell am I support you 😂
As light warrior die like this him BTC way him family no know about do go be that oo. And him no chop the accumulation again oo so if u get Bitcoin way u fit sell to enjoy your self my brother sell no mind weytin we de talk for forum oo we get life outside here.
But if you sell am too wey people wey hold their own become rich later at least you no go loss you go still be their gate man 😁
Watin you dey talk nah true o but come to think of it, watin be life if you no enjoy no totally mean say you go just dey chop and no get saving oo (hope say you already know like that?)
Yes everybody way dey into crypto dey try get some profits from Bitcoin, wether nah big profits way you get abi nah small one, just you am do better thing.
For @light warrior matter, really really no body know when him or her go pass out but we all pray to live long, nai make e still good to tell one of your family members about your investment, abi you never see pipo way dey hey lawyer? If you get lawyer and you dey invest on anything even if you no tell your family members at least your personal lawyer go know, so that if anything happens to you, your family pipo go inherite your assets.