I go like tell you to use an exchange wallet instead of the electrum wallet because exchange wallet go reduce the stress of high fee and waist of time for you.
Well, make you try binance exchange wallet, that nah another good exchange wallet for those way really dey sell their coins all the time
My brother thank you very much for this wonderful idea be like na em I go take dey do my many transactions dem oo, because e wan come be like say electrum wallet wan cut my neck commot. The only problem I get na be say normally our Ogah dem don dey advise us make we no dey too money for exchange for long, so I wan ask weda to keep for up to 24 hours na bad thing? because most times wey transaction dey come I fit dey were network no dey, I travel a lot so I wan know if e dey safe?
Well,,, as you already know say the binance exchange wallet no too dey safe, so I no go fit tell you when bad things go fit happen because me self I know really Kno if the exchange go crash any time soon (just like the
EFX, no body knows untill e happen, and I believe say nah because of something like this nai make most exchange wallets them no dey safe but I go like tell you not to keep your coin too long for binance, just only if you know say you go sell soon.
As e be so, I already believe say you dey aware say electrum wallet no be exchange wallet, the electrum wallet nah for when you hold your coin for dear life nai you supposed to dey use am but for person like you way dey sell coins most times, I go like tell you to use an exchange wallet instead of the electrum wallet because exchange wallet go reduce the stress of high fee and waist of time for you.
Well, make you try binance exchange wallet, that nah another good exchange wallet for those way really dey sell their coins all the time, me I dey use electrum wallet before but letter on I con change am because of fees and waist of time and since then I dey get no stress (but I still dey use am)... Watin I dey try make you understand be say the electrum wallet no dey bad ohh, e dey more safer than the exchange wallet like Binance and all the rest.
Make you no say no be only cheap or low transaction fees wey you go only consider to use centralized exchange wallet, make op consider the risk factors wey dey involved when it comes to using a centralized exchange wallet like Binance as you mention, make him no say not your keys, not your crypto, you fit to face any challenges at any time and they fit still freeze your money at any time plus other factors wey dey risky to dey use centralized exchange.
The main reason why I say binance nah just because of watin the op talk.
fit give me recommendations or direct me to any wallet wey nor dey too take much for transaction fee.
So nah because of this quote nai make I recommend binance exchange wallet give the op, as I see the matter, nah just because say the op want were em go fit sell em coins without any stress of fees or time wasted,, as the matter be so, I no really tell the op to use binance hold em coins because say e no dey safe,, so as em just want to sell em fit still use am.