Author

Topic: Tribunal court don set judgement for PEPT (Read 141 times)

jr. member
Activity: 78
Merit: 6
September 06, 2023, 02:04:54 PM
#11
My people, the Tribunal court don give 24 hours notice to all political party say dem go drop judgment for the Matter way dey their table, way Peter Obi and Atiku Abubakar carry come oh, concerning the last election results way INEC declare. Them say na on the 6th of September which is Wednesday of this week them go drop their own satisfactory JUDGEMENT.

But watin come interest me be say, TRIBUNAL COURT talk say this particular judgement, say e go dey televised. Say we go watch am live for TV, but I been remember when some parties been dey file petition from the beginning of this matter,  say make the court allow livestream of the proceedings of the court, Omo the court no gree for that motion oh. But how come now, them wan livestream the results but them no gree livestream the process way lead to the result. My people how Una see this matter.
https://www.google.com/amp/s/www.channelstv.com/2023/09/04/just-in-presidential-tribunal-to-deliver-judgement-september-6/amp/
i don't think we are expecting something different in this judgement. because, we all know what our politicans is capable of doing. now, judiciary is no longer the hope of a common man.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino
September 05, 2023, 07:30:54 AM
#10

3: Una don ever hear say dem unseat any sitting presido for Nigeria thro court- NOooo!

So my Bloodas and my 6ters make we just melembe nothing new go happen. Make we just dey double our hustle while we wait for another four years of another general election to come.

Well that doubling hussle still make sense as people dey talk but me I know say people wey dey government still dey fear for the judgement wey dey come tomorrow because dem don ban many television stations and radio station plus journalist from Aso rock to avoid covering wetin dey happen there, dem want only those wey dey wine and dine with them. Make we never despair, tomorrow fit better for the majority of Nigerians because we know say no be them Nigerians vote for. Since democracy wey PDP rule for 16years and for past 8 years of APC, no any direction for the country. Make dem give Obi chance because na him win the people's mandate.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
September 05, 2023, 02:47:55 AM
#9

The questions be say;
1: who appoints those judges- Na the sitting presido
2: who be the commander in chief of the arm forces - Na the sitting presido.
3: Una don ever hear say dem unseat any sitting presido for Nigeria thro court- NOooo!

All these nah valid points you raise especially for number 1. E get wetin I see this morning say we presido no dey shake for the verdict wey tribunal go issue out. Wetin make? E fit be say e don bread some of them because if we go back to results wey APC get, nah so so mago mago full am and him know say if him no bread, he's not worthy of that position.
 Them dey say dem go televise am as if that will stop the malpractice from seeping in. The day corruption go leave us go tey and weda them set date for judgement or not, we know the outcome already.
hero member
Activity: 1008
Merit: 599
September 04, 2023, 03:33:36 PM
#8
I don't see the tribunal doing the needful in this judgment because of the corruption in the system.
And if we don't get it right this time around it will be difficult for Nigeria to get better or move forward.
The citizens should take it to the streets and occupy the whole nation should the judiciary not do the needful because a democratic system of government where the rules of law are no longer obeyed and a system that imposes candidates to govern the country should be resisted and no longer be tolerated.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
September 04, 2023, 01:38:51 PM
#7
All I can say is that " ALL EYES ON THE JUDICIARY". I pray Thier judgement favours the innocent and poor Nigerians.
Truly all eyes d on tribunal. The whole world is watching

Whatever the outcome of the presidential election tribunal  judgment on Thursday 6th go be d for tribunal hand to determine how Nigeria go end up becoming. Whether em go continue to be a democratic state where the rule of law is practiced or something else.
I smell danger to happen if the tribunal goes contrary to the finding accusation brought before them in which they are going to carry out their final judgment. If they tribunal judges try to deviate from the truth, make we no d surprise to see wetin happen for Gabon, and Niger, to happen for our country(military taking over the country) in no short time.

For peace to reign, make the judiciary give the right judgement so that everyone for the country go d happy sae our judiciary d work. As em d so the fate of our country as a democratic state d their hand.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
September 04, 2023, 01:31:50 PM
#6
But watin come interest me be say, TRIBUNAL COURT talk say this particular judgement, say e go dey televised. Say we go watch am live for TV, but I been remember when some parties been dey file petition from the beginning of this matter,  say make the court allow livestream of the proceedings of the court, Omo the court no gree for that motion oh. But how come now, them wan livestream the results but them no gree livestream the process way lead to the result. My people how Una see this matter.
https://www.google.com/amp/s/www.channelstv.com/2023/09/04/just-in-presidential-tribunal-to-deliver-judgement-september-6/amp/
If dem like make them televise am, live stream, tiktok or facebook am, I no really get interest again. For once I bin think say we go get am right but all of us see how f*cked up di presidential election bin go. Dem bin raise our hope high by announcing say dem go use BVAS for di first time, but las las na person wey dey control di BVAS na him run di show. So like dis I no go like make person come give me another hope with dis presidential electoral tribunal. No be di same running party na him set up di people for di tribunal? How are we sure the tribunal committee have not been bought? Like dis I no get any expectation say di tribunal go do di right thing.
hero member
Activity: 938
Merit: 605
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 04, 2023, 11:01:38 AM
#5
All these things na just way to use give us hope say the judiciary abi na tribunal sey dem dey try their best to dey neutral and unbias not to favour any party involved in the suit. When our hope don rise just as inec been do us with BIVAS machine den com later at the 11th hour burst our logos with how dem son already plan the results from backyard before the D-day.

If the judiciary really wanted to dey just and neutral dem for first annulled the declaration of inec in declaring Baba as presido, then put a caretaker/interim government while the matta dey go on in court. And no be this one wey one person don sit down as president already com dey use the resources of the state dey fight court case with somebodi wey dey as a single entity.

The questions be say;
1: who appoints those judges- Na the sitting presido
2: who be the commander in chief of the arm forces - Na the sitting presido.
3: Una don ever hear say dem unseat any sitting presido for Nigeria thro court- NOooo!

So my Bloodas and my 6ters make we just melembe nothing new go happen. Make we just dey double our hustle while we wait for another four years of another general election to come.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino
September 04, 2023, 09:45:34 AM
#4

But watin come interest me be say, TRIBUNAL COURT talk say this particular judgement, say e go dey televised. Say we go watch am live for TV, but I been remember when some parties been dey file petition from the beginning of this matter,  say make the court allow livestream of the proceedings of the court, Omo the court no gree for that motion oh. But how come now, them wan livestream the results but them no gree livestream the process way lead to the result. My people how Una see this matter.

Na true wey you talk say when the parties apply for livestream of the court proceedings say court no gree but now dem want go live. Anyway, then and now no be the same thing. Me and majority of us been want am like that then unto say we want to dey get updates by ourselves but the court no gree. Them refer to the constitution say no where e dey say make dem take court proceedings to public, so the constitution already kill those application natural wey make them dismiss am. Them say such decision na at the discretion of them wey be judge to decide and there oga wey be Mr Tsammani say that go dey bring drama and people go dey carry court do caricature for the proceedings.

So I think say now wey dem want go live na because no be proceedings. Na judgement e be meaning say the lawyers no go dey involved unto all those lawyer dramas. Anyway make we hope say Wednesday go be a bright hope for the youth and the poor. People dey suffer in the midst of plenty.

newbie
Activity: 36
Merit: 0
September 04, 2023, 08:50:38 AM
#3
All I can say is that " ALL EYES ON THE JUDICIARY". I pray Thier judgement favours the innocent and poor Nigerians.
hero member
Activity: 882
Merit: 800
September 04, 2023, 08:39:25 AM
#2
My people, the Tribunal court don give 24 hours notice to all political party say dem go drop judgment for the Matter way dey their table, way Peter Obi and Atiku Abubakar carry come oh, concerning the last election results way INEC declare. Them say na on the 6th of September which is Wednesday of this week them go drop their own satisfactory JUDGEMENT.

But watin come interest me be say, TRIBUNAL COURT talk say this particular judgement, say e go dey televised. Say we go watch am live for TV, but I been remember when some parties been dey file petition from the beginning of this matter,  say make the court allow livestream of the proceedings of the court, Omo the court no gree for that motion oh. But how come now, them wan livestream the results but them no gree livestream the process way lead to the result. My people how Una see this matter.
https://www.google.com/amp/s/www.channelstv.com/2023/09/04/just-in-presidential-tribunal-to-deliver-judgement-september-6/amp/

See ehh this mata tie rapper oo because with wetin don happened within just dis few days wey BAT dey for seat go make them wan reveal everything make him push out from that seat. Livestreaming go show how transparent every tori wey dey happened there go be, dis one include if them reply all the vote counts and see the manipulation wey dem do there e go show evidence but if them no gree show am then e go still hang for them neck say de person wey enter seat now carry magomago take enter there . But anyhow make we see how the 6th go be for we body because I no even see anything good wey go come out for this current person wey seat down as president.
sr. member
Activity: 700
Merit: 270
September 04, 2023, 08:19:19 AM
#1

Jump to: