Dangote talk say him go dey export (abi him dey expect to they export) around 40% of wetin dem refine to outside. When exportation happen for any country e dey introduce foreign exchange so dat one go surely affect dollars. The problem of this xounyna say we no dey export anything sufficient to dey make foreigner dey bring there dollars come the country which side is why dollars hard to get here and this one follow why dollars dey cost. We dey too over value am. Tinubu administration go also help the situation of the country, heim dun first commot subsidy and na better thing be dat. That subsidy dey chase away foreign investors wey for come invest for the refinery and filling stations wey we get to get slots for the profits wey the dem go generate.
When you subsidies something, you make it difficult for competition and without competition and freedom for the market to decide price, investors no go dey interested in that thing. Now wey Tinubu dun comot subsidy na for local refinery to start to dey attract international investors wey go help make dem function. Make the government commot hand for the refinery and dey tax dem but make dem function on their own and watch how dollars go begin enter the country, Naira begin get value and fuel prices begin to come down. Competition go dey for filling station too and no be this nonsense wey dem dey mandate everybody to sell the same price weather you dey make profits or not
Wetin you yan na true talk. wat if de goverment come change their mind for the subsidy when dey wan comot. I hear say NUC won protest say why goverment comot subsidy?