I never trust our banking system for one dey but the urge to get my money out of niara propelled me to going to get domiciliary account but the shege I see during the process no be here. The demands come they tire me and this na my money we dey talk about here, I still got it but I come reason say it's not worth the struggle and time and effort, and e just be like say I don give my money to the government and them fit freeze am anytime they want.
Then I decided to shift to crypto that is stable and then I went for USDT a stable coin pegged to US dollar it was pretty easy buying some USDT from and exchange and saving it in a wallet, my wallet na me they control the Wallet. So in comparison to domiciliary account based on time, effort and potential of losing your holdings I suggest using stable coin than having a domiciliary account in Nigeria.
Even if i no get millions or billions of naira, you see for this our country i no go even try am say i wan keep money wey big for amount for naira inside my bank account lie lie, USDT ni be the way forward for me come rain come sun NAIJA system no follow, e good i earn the money for dollar den spend am for naira because when you convert am e big.