Author

Topic: Wahala for Niger be like Bicycle,who no go know. (Read 11 times)

brand new
Activity: 0
Merit: 0
So many persons wey from Niger,dey outside country,dem dey hear about Niger and some things wey dey go on for the country,but dem no really know wetin dey sub,na only us wey dey inside the country nai go fit tell how e don bad reach,but the worst thing wey dey pain pass be say,the people wey we elect as our leader no dey wan do anything aboutam,and e only show say every body dey mind dia business, including the person wey we say make e be our presidoo.Job wey suppose dey for the Citizens,we no dey see anything like that.
Man go finish school,stay for house for years without getting any reasonable job,then you expect crime not to dey for the country?Wahala go always dey,cus the government no dey try,abi how una seeam?
Jump to: