The thing be say you get other investment wey you wan cashout from your Bitcoin bag take put for that business? If you no get and na Bitcoin be your investments there's no need selling as you fit sell at the wrong time. Or possibly no enter back the market at the right time. To eliminate all this stress to dey observe the market, you fit just sell wetin you go use hold body throughout the whole bear market and keep the rest for your wallet. You go just commot mind say you get Bitcoin until the next halving and bull run come. To sell all in hopes of buying them at cheaper price dey alright but you go fit follow through the idea and you no go chicken out because of fear say market fit fall again.
For now I dey sell from my trading profit dey hold body and soul. And I know sae many of us dey wait nfoe the ATH to disburse our coins to do some major projects in our areas. God go bless us and Him no go same us.