Now my problem and concern na if these organization truly Dey work or na just avenue to chop money from government revenue and how the common man fit contribute to improve the qualities of these products.
Dem no dey do work wey I dey like these days true true because I notice same thing for many of the products Dem these days, still their stp go just dey der add beauty to the carton or packaging of the product.
E go dey okay if any educated citizen wey see some of these substandard products to point am out either on social media or report am to SON, because many businesses fit fake the stamp just to avoid paying the regulation fees as members of the body.
Also, e fit be say government dey allocate money for Dem but the oga kpatakpata go connive am do anoda tin wey we no know. Whichever way it is, try dey sure say product wey you wan use na better one o, if not go for alternatives and report fake products mostly those wey dey enta belle, to the right authority.