Author

Topic: Wetin e mean and how u dey use this slogan (Read 111 times)

newbie
Activity: 14
Merit: 1
February 03, 2024, 12:54:26 PM
#11
This slogan no too good for person, especially Niger boy; if you follow am as you see am, e fit carry wahala come your side. no let army man slap you make you fight, your life fit end for barracks. For my side, I see the slogan as motivation to try: no gree for anything wey dey hold you back, no gree for obstacles, no gree for lazy moves, no gree for talk talk, no gree for anything, no matter how your life be.
full member
Activity: 182
Merit: 120
Cashback 15%
February 01, 2024, 05:17:54 PM
#10
As I dey reason the word "no gree" many things dey attached to the word and na meaningful word except na person wey no take am serious. No gree for scammers for the crypto space na go one in essence no carry your money play with some coins wey dey serve as scam scheme.
Talking about scammers and transaction, why you give them your attention at the first place, e get some transactions we no suppose do as smart investors and no be every investment choice need our attention, it's best to ignore all of them follow for the no gree for anybody this 2024.
member
Activity: 168
Merit: 50
Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
February 01, 2024, 02:14:27 AM
#9
As we enter the year 2024 , young Nigerians don talk say, no gree for anybody. This one na popular slogan wey dey ginger everybody now. How this slogan take dey affect you and how u dey use am for this crypto space

For me , I go say, no gree for any airdrop wey dey request for money (any crypto as payment) or  private keys /memomnics to your wallet. Na scammers dey play with you so. Apart from centralized exchange, no gree for any p2p transaction wey b say na true social media

Bro your basically speaking your own and that slogan no come out for crypto users or only online people. The main way we suppose to dey use that slogan na in terms of hustling and self development, no gree for anybody this year na say, make you no dey their dey sleep make your neighbour carry your blessing, the thign fit also ckme in for smartness to, which is the one you explained for us, say make we no dey dull dem come scam us, so no gree for anybody u fit still carry am enter church sef, say make u no dey dull, another man blessings pass you. And me as crypto user to add to the one you talk, I go say make we no gree make anything stop us from accumulating bitcoin, make we no gree for any excuse this year, make we go get income raise or anything wey dey necessary to enable us achieve more bitcoin for our wallet. No gree for anybody to me na no excuses!
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 31, 2024, 09:32:48 AM
#8
Follow the right part and be committed to what you are doing. You need to be focused and committed to what you feel or advise that will help you. No be say you go put square peg in round hole and do things haphazardly. You also need to stand firm to your right and no mumu. No gree for anybody no mean say if you dey wrong you go still dey do strong head.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
January 31, 2024, 08:08:57 AM
#7
That slogan nah slogan way dey subjective base on how the individual chose to use and deal with it as we all embark on this crypto journey it get some things wey you go need tell yourself not to gree do this year and beyond, such as:
✓ No agree to click on anyhow links  you see online.
✓ No agree to save your seeds phrase for online storage as malware bugs fit compromise am.
✓ No agree to settle for less in this community, strive to learn and be the best you can be.
✓No gree for greed, na eim be the enemy of many investors for this industry. The profit them don try get them no the feel contented for the moment, before you know them go take action wey go lead losing all.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
January 31, 2024, 08:06:49 AM
#6
For me , I go say, no gree for any airdrop wey dey request for money (any crypto as payment) or  private keys /memomnics to your wallet. Na scammers dey play with you so. Apart from centralized exchange, no gree for any p2p transaction wey b say na true social media
Me I don even commot mind for all those Airdrops because I see say most of the once wey dey now, na just scammers dey take advantage, some no go even ask you for your private key, some go just talk say make you connect your wallet to their site,  and before you know, everything wey you get for the wallet don go already, na y I dey recommend even if you go apply for airdrop, make sure say you create new wallet and use am, incase if they be scammer and dey wan wipe Wetin you get for your wallet, they no go see anything wipe. Me self go talk am ooo, make we no gree for scammers this year, make we dey vigilant, careful and smart.
jr. member
Activity: 51
Merit: 1
January 31, 2024, 05:38:38 AM
#5
This slogan no gree for any body  as a Niger boy na the way you see ham or read meaning to ham na him the matter go follow you.yo no gree you go fight army man because him slap u na there your life end for barrack.as for me I see that slogan as a motivation in your life to try no gree for things wey they slow you for life down no gree for obstacle no gree for procrastination no gree for gossip no gree for this wey no matter to your life na so I see ham.
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
January 31, 2024, 03:42:59 AM
#4
As we enter the year 2024 , young Nigerians don talk say, no gree for anybody. This one na popular slogan wey dey ginger everybody now. How this slogan take dey affect you and how u dey use am for this crypto space

For me , I go say, no gree for any airdrop wey dey request for money (any crypto as payment) or  private keys /memomnics to your wallet. Na scammers dey play with you so. Apart from centralized exchange, no gree for any p2p transaction wey b say na true social media

OP, airdrops are mainly scam, if you are to involve yourself in such you must be very careful, personal I don't do those shit, I concentrate on the reason why we are here which Bitcoin discussion and I am bent on contributing my own quota here.
The aspect of no gree for anybody that you mentioned and your illustration, do you know that you can only identify scam when you are conversant to the system, I check your account, despite that you are still a member, believe you have experience in this place, I must appreciate you for bring such idea to the public because some people are not grounded here and believe what you said is an eye opener to many people in this community more especially our local board, as for the no gree for anybody, is only when you know what is obtainable that you will not gree for anybody.
full member
Activity: 266
Merit: 113
January 31, 2024, 02:07:26 AM
#3
As we enter the year 2024 , young Nigerians don talk say, no gree for anybody. This one na popular slogan wey dey ginger everybody now. How this slogan take dey affect you and how u dey use am for this crypto space

For me , I go say, no gree for any airdrop wey dey request for money (any crypto as payment) or  private keys /memomnics to your wallet. Na scammers dey play with you so. Apart from centralized exchange, no gree for any p2p transaction wey b say na true social media
this matter of no gree for anybody don plenty for the board and you for just kuku reply one of the thread with your own idea on the matter rather than creating another thread to expressing it.

But then, more than just saying that you aren't greeing for anybody, try make you no also gree for yourself oh, all those spirit of laziness and procrastination, try make you fight them this year make them no way you you down oh, the slogan an legit update when if you follow am up from the start of the year till the year comes to an end, you go see better change for your life

selah
jr. member
Activity: 76
Merit: 3
January 30, 2024, 07:46:44 PM
#2
This one na popular slogan wey dey ginger everybody now. How this slogan take dey affect you and how u dey use am for this crypto space
Yeah me self been dea here this slogan time to time, but i ask wan of my guy say howfa this slogan wetin e mean? he said that the way things hard now, you no fit give out and live your self with hungry, e no clear at all, the full meaning be say (everyman for himself). Try your best to live no die for any man.

Apart from centralized exchange, no gree for any p2p transaction wey b say na true social media
Na why naija people carry this slogan for head like mad if you wise toh and if you know wise, you dea on your own. anybody wey go bill you through social media app omo me self go talk am no gree for anybody oo, because scammers don full every where now, as this life dey now omoo EFCC sef dey complain too much, on this internet fraudsters, this scammers of a thing, their work don even turn to handwork wey you gaz serve your boss before him teach you work.
My brother's and sisters na true oo this year 2024 "No Gree For Anybody".
member
Activity: 334
Merit: 27
January 30, 2024, 05:50:25 PM
#1

Jump to: