Now when(if) Nigeria releases her ban on crypto, it would be possible to not only buy via P2P but also bank. This I believe would reduce the price of USDT and thus reduce the value of our stored crypto (Bitcoin) since Bitcoin is still being measured or expressed internationally in dollar.
Chairman which country you dey stay abeg, na this same banks wey hide new Naira from us dey sell am to pos agents and politicians wey wan buy vote na him you dey believe dem go sell at that official price. Bnaks wey go say dem no get dollars but dey get one Black market baba wey dem fit refer you to and na still dem dem dey run the matters there. Abeg fear banks oh. Even though they allow banks dey transaction cryptocurency difference go still dey between cryptocurency rate and normal rate. Infact banks go hike their own price to reach that of crypto P2P market.
At the moment, you know know say dollars no dey banks but yet aboki dem get am enough to exchange for you and their prices still no be the official price wey CBN dey put although e no high like cryptocurency own. I understand wetin you dey reason but no be so e go be infact if government lift ban, we fit get increase in demand and since enough dollars no dey due to the border been closed we for fit get small dollar rush and e go dey trade for 1k per dollars self although e go later stabilized.