If a new government is elected and then everything becomes good, do you plan on staying and enjoy the benefits of the new government, a new Nigeria.
I doubt say the country go remain the same, Buhari was the problem of Nigeria and not APC entirely. Buhari no been get any plans before him become the president of Nigeria. Asiwaju get plans, we never know if dem bad or good but him get plans and him get coordination. Asiwaju no enter seat say him wan chop money or recover his funds spend on campaigning or rigging the election. Dat man get money wey Nigeria no fit get self. So na power make am enter seat. Now wey him dun get the power him fit use am wrongly or well, we never know so make we no judge yet but just dey watch.
As election dun finish, na for us to continue our hustle on hope of getting a better future for ourselves. Trusting politicians is never the well to go. Politics is a game all over the world, after the game is won na the policy wey follow dey determine if the country dey go forward or not. Obama was the choice of the people but dey experience a worst government under him than Trump which everybody despise. This wan mean say things no dey always go as we plan am. Buhari was also the choice of the people but we see how things played out. Allow politicians politic but no stop your hustle as you never know what the other party policy might do to the nation.