Author

Topic: What is the difference between Aza Men and Nigeria Banks? (Read 155 times)

full member
Activity: 145
Merit: 104
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Their is some certain things that did not what discussing the local thread, is an aza man what discussing in local board, when we are discussing let us focus for things that will give us understanding and enlightened us to acquire more experience from other people, how can we be comparing aza man with banks and besides can Google give a definition of aza man, let us be informative in what ever we are doing in our local board, I'm not constant in the forum because of my health, and if i should be consistent in forum and in the local board I will bring educative things that worth enlightening other people, because of their theory.
full member
Activity: 448
Merit: 117
Omo e tire person abeg bank whahala too much for we country because them dey follow make things had for us after politician do their own, bank go come do their own and Aza men them go come do their own making things very difficulties for people wey dey around the environ. Especially for kitchen side food matter don high onto say those aza boy no dey price food stuff and dem dey pay like tomorrow no dey because dem no hustle for the mney in a harer way or without sweating for the money na wetin make things dey go like this for them.

Had in mean they passes through stress to earn those money no time them for go market go spoil food stuff like that for people wey dey try to meet up kitchen matter.

Back to bank casala, this people na serious criminal because e don happened to me severally not ones but multiple times until I carry myself jakpa enter bank go pour out my anger to know wetin make dem dey do me this opata, na so them refund me all my money wey dem take illegall.

No be small o. Our politicians own too dey one corner. Infact all of them na big time hustlers dem be. Come be say na peoples power them take enter office  unto say the masses vote them put for power. The economy dey one corner dey frustrate we country people. Food stuff price don increase, bank dey their own dey collect from people any how, aza men dem dey concentrate for their street mata. The police dem too na headache dem be. Wetin person go do sef. So tey the youths dem don resolve to dey japa unto say dem dey find greener pasture for oyibo man land. This matter sef just tire person for this country. You see as e be ehn, it is either you open your eyes or dem use you shine.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
Omo e tire person abeg bank whahala too much for we country because them dey follow make things had for us after politician do their own, bank go come do their own and Aza men them go come do their own making things very difficulties for people wey dey around the environ. Especially for kitchen side food matter don high onto say those aza boy no dey price food stuff and dem dey pay like tomorrow no dey because dem no hustle for the mney in a harer way or without sweating for the money na wetin make things dey go like this for them.

Had in mean they passes through stress to earn those money no time them for go market go spoil food stuff like that for people wey dey try to meet up kitchen matter.

Back to bank casala, this people na serious criminal because e don happened to me severally not ones but multiple times until I carry myself jakpa enter bank go pour out my anger to know wetin make dem dey do me this opata, na so them refund me all my money wey dem take illegall.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Aboy this your post na big article o. I come dey wonder how I want to take read am to the end but anyways, to he first paragraph wey I read don dey enough for me to understand wetin you dey talk already together with the topic of this thread.

As e be now ehn Aza men Na street life dem dey live unto say na chop I chop things dem dey run wey dey colabo with bank to chest out the mola but bank na corporate and legal crooks wey government dey back to do and undo. Dem get licence to do their things unto say dem dey pay tax and other governmental agency fees wey dey ground but their own too much for body wey be say ordinary country man no get option.

Imagine wey bank dem go collect money from the number of account holders just like OP explain times the amount them dey collect in the name of transaction fee, maintenance fee and lots more on daily basis, e too much Na. I even see as one of the replies here post account details of how much dem collect from account based on say Na fee matter. The thing dey worrisome Na. Sometimes the small money you take get hope wey dey for bank go just dey deplete till e remain wetin you no expect am to be.
full member
Activity: 280
Merit: 190
The great city of God 🔥
My G. Nothing comot for this matter way u Yan o.this country don tire person anyway you reason am na problem. The difference between aza men and bank be say. Azaman na street begger why bank na couprate begger with suit con nak am tie. The charges wey this people dey commot for account ehh chai. Sometimes Dem go send me money like 10k. 300naira don comot inside for electronic maintenance fee, remain #9700 and wetting I wan carry d money do don short. I go come dey find who go borrow me money no complet money wey been don already complete before. POS charges never dey o. Because of that thing I no dey gree save money for bank again this days na opay I dey put money.

For this matter I come conclude say Bitcoin is the best option and naim make we the always preach about Bitcoin everyday for here. because naim be the only way. And with all this thing's I believe say very soon crypto trading go take over local banks and na because of the advantages wey Bitcoin/crypto get naim make we govment no want crypto currency for naija because e go affect their looting from local bank.
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
All of them both banks and Aza men,na the same thing them dey do. the difference be say bank dey extort their victim legally and with government back up because bank and government dey work hand in hand. i no go lie for you,i dey hardly go bank for anything after that cashless policy na only once i don go bank and if you see wetin them use my eye see. i vex talk say i no go bank again,because these people no care wether na your money them dey use survive and them go dey form Jagaban ontop your money come still dey give your condition. As for Aza man that na business wey you know say una don negotiate and since na him hustle,he go deliver sharperly so that make more work come. Bank dont send about your feelings because they are corrupt and they are also supported by the politicians. We see as everything play during cashless policy.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Chairman I no go lie your thread to long and m I no be fan of reading long threads because my brain fit burst bu the truth be say I go just answer your question based on the topic wey you write.
The major difference between these two na east of international payment as Aza man major work na to chest money from around the world with some percentage an rate while banks Dey chest with only rates and another difference be say, aza man de make receiving money from other countries easier without you even leaving your house but you must reach bank for you to fit chest  money for banks from other countries.

Well better aza man Dey always deliver while banks for fall your hand at any time if care isn’t taken
hero member
Activity: 896
Merit: 653
This thought has made me start wanting to see our local banks as a cooperate and legal street business compared to the aza men dem. The banks are legal entities authorized by the government with issued license to operate and carry out financial transactions but it seems that they utilized the opportunities they got to  start a broad day robbery on account holders with their illegal debiting  of funds from accounts of Nigerians or if you may like their customers. They place unnecessary charges and in most cases, they debit twice without any reasons and fail to make refund. If one is not observant enough, they would keep doing that till the account holder notices that and lay a complaint then they would stop because they see that the customer is now aware of that act.

What you just said above, are the outcome of what happens when a system is corrupt, and we all know say this our motherland don lose-guard tey tey, wey nobody dey talk about am simply because all these our top politicians get their own share/percentage of wetin these banks dey treat the poor masses daily basis, and as such, making huge sum of money from the small #50 to #100 "transfer levy", just like wetin "Access" bank dey do me recently, as shown below.

   

But yet, person go still survive in the hands of Nigerian banks, which is why if you get huge fund, Bitcoin is the best way to invest your fund, or likewise create a "Current" account in your bank to keep funds
newbie
Activity: 36
Merit: 0
My dear wetin Nigerian bank d do us no be here. Unnecessary debit charges coupled with debit on failed withdrawal transaction that is very difficult to retrieve. And most times this criminal acts are being done on purpose just to extort from the customers. And for the aza people, 😊 they believe say na street and in the street dog d chop dog.
full member
Activity: 448
Merit: 117
This thought has made me start wanting to see our local banks as a cooperate and legal street business compared to the aza men dem. The banks are legal entities authorized by the government with issued license to operate and carry out financial transactions but it seems that they utilized the opportunities they got to  start a broad day robbery on account holders with their illegal debiting  of funds from accounts of Nigerians or if you may like their customers. They place unnecessary charges and in most cases, they debit twice without any reasons and fail to make refund. If one is not observant enough, they would keep doing that till the account holder notices that and lay a complaint then they would stop because they see that the customer is now aware of that act. Now look at the numbers of persons that such must have been happening to multiplied by the amount and days that debiting must have been happening. You would know that these banks are really sucking Nigerians of their funds and raking in billions everyday or is it the of charges for the sms alert,card maintenance fee, stamp duty, carbon fee coupled with the stress they make one to go through to reclaim their  funds if at all they would make refunds.

Make una no vex o. I use the word aza there for the topic unto say I believe we know wetin I mean by the cappings. I  no want make the other normal name wey dem dey call dem come dey bring many thoughts for other country men their head if dem come dey scroll to see topics for themselves unless dem open and read to really know and understand wetin I dey talk for those wey sabi our language but we know say na street things I dey yan about here like this.  
These aza men own na sake of say them dey do things anyhow dey dry people of their hard earned resources through illegal means compared to the banks. When dem do am, dem dey leave a kind of funny lifestyle wey be say dey attract eyes to them and dem dey make things dey hard for both their victims and other people for the society wey be say police go dey chook eye for young bobos dem too much and dem go spend money any how wey dem no go price market, dem go make things begin dey expensive coupled with the matter wey already dey for ground for we country.

Some of their act na through love scam, hack, forgery,extortion etc. All these na illegal means wey dem dey take collect money and at the end all result to breakdown and hardship of their victims in pain while bank own be say na legal entity wey dey intentionally carry out their acts as e be say dem dey licensed by the government to do financial transactions on their behalf but their act they result to customers being pained. Banks own be say dem dey pay salary, dey run maintenance for their facilities and gadgets, tax and lots more wey dey add value to the society and humanity at large but make we no forget say dem too dey collect from customers anyhow too while the aza men dem na hide hide lifestyle coupled with collection wey dem dey do any how from a specific client wey be their target.

My country people,looking at the above, wetin you think about this matter wey be say both mentioned categories dey do to their clients, the matter pure or na sake of say man go survive things?
Jump to: