My Elders, uncle, brothers and sister I greet oh. I no sabi too much and this period i come dey think in the midst of wetin dey happen for Naija wetin I go learn from Tinubu. No vex, I know say somebody fit learn from bad and good. I don put few observation I make below i go like make una advice me and talk una own opinion as concern this topic.
Influnce- Tinubu get too much influence. I fit develop imy influence to a reasonable level wey my influence go dey work for me.
Craftiness- Tinubu have ability to turn and underturn tables before you realize. Is craftiness a tool I need to get for Naija?
Money- Jagaban hold money them dey call am Bullion Van but Me I no know how e get the money.
Inconsistent Data Record- So many contradiction on date of birth, age, family history etc. Me I go say e good make person get straight data record.
Jagaban get boys for street i.e Men mount oooh. E good make person get that kind structure.
This na few things. Abeg make you put mounth
People like jagaban, will always succeed in a place like Nigeria na. Don't you see how exposed he was in U.S when he was doing those alleged drug business. If we continue to as a people to have a structure of people like Jagaban and Buhari, just forget about things coming to normalcy in Nigeria. The influence your talking about, is not influence of Ideas and technical know-how to improve the lots of Nigerians, but that of hunger, as he seems like their source of income. In today's world, Idea rules the world, I don't see Jagaban possessing any ideas or what so ever to turn around things.