I don Dey think on this matter, Dey imagine how the blockchain system go com be cos as na miners Dey verify and validate our transactions in hope say dem go get small thing if that small thing no Dey again I no sure say dem go still Dey do d work.
Miners wey go Dey, go Dey focus more on transactions wey get higher transaction fees cos that one go be the main incentive for mining.
I believe say the blockchain system go change, developers go work on improving the protocol and ensure say things no scatter (I know say before that time dem go don think of Wetin to do, all the upgrades and stuff).
But the Major koko go be the economic effect ; as no new bitcoin go Dey added to the blockchain, this one go cause demand to increase and higher prices (Law of Scarcity and Demand go take price). If you Neva acquire bitcoin before that time e go be high mountain, cos price go skyrocket in millions of dollars.
Try now make u gather enough bitcoin for your portfolio before that time!
Miners will have to be validating transaction and solely depend on its transaction fees also charging mining fee, they will have to be maintaining Blockchain. When all Bitcoin are mined, which is expected to be by the year 2140, new ones will not be available in the market, the purchasing power and price will be adjusted because there will be no new supply available in the market, there will be more investors and users that will want to buy it because of its scarcity, no block reward any longer .