I was faced with people who where telling me to have my revenge. But is it worth it,
How you for take do am sef, to start with? As in have ur revenge like scam someone back? Well, dat wan sef nor for be good thing, even for ur safety. D persin wey scam you fit escape but you fit to nor escape. E just be like someone wey dem give counterfeit money and e come later find out and then insist sey im must to spend am. Luck fit nor dey on im side, and e com be sey d persin wey im wan take am buy something from na persin wey get A1 for detecting counterfeit. Na betta wahala be dat. Hand must touch am and d hand wey go touch am fit to stain im shirt or tear am.
But my question is, who is to be blamed. Is it the scammer or the person scammed.
E go depend on d type of scam wey happen. If na scam wey persin promise you unrealistic profit like wetin dey happen wit Ponzi schemes, na ur fault. But if na d wan wey you just do regular investment like buying wetin you think sey na normal cryptos wey com later dump or rugpull dat wan nor go be ur fault because nor be big eye cause am for you. If na d wan wey you give persin ur bank details and dem com take am swipe you, na ur fault because d warning don dey everywhere for long.
Technology has so advance that with someone have your bank card, they can do what ever. That why I ask is it you who gave out the information or the person who has decided to eat your labour.
I see people do dis all d time but I think e nor make sense. Why you go give persin ur bank card sef wey nor be ur spouse, if you must? I nor dey talk of boyfriend and girlfriend. Dat wan supposed be big no-no. Hold ur card by urself and keep ur pin and password to ur sef. Nor let love or lust carry you reach there.
Again i ask is there life with out regret.
Nope. Regret na part of life. As long as man dey alive, e go make decisions wey fit nor too go well down d line. Him na mortal being and him nor supposed dey perfect.
What your experience about scam?
Apart from wrong investment choices, nobody don scam me. Na because I nor get big eyes, nor be sey I smart like dat.