Author

Topic: What's the next Trend After Japa? (Read 166 times)

member
Activity: 155
Merit: 79
September 11, 2023, 04:31:02 PM
#19
As ona dey japa make ona  know say e no easy for there. It's not how we think am or as we dey see for  film.
If you don't have a bankable skill or a good profession I won't advise anyone to japa.
You cannot meet up with taxes and bills payment  cos the cost of living there is also expensive. You can work remotely from your own country and still earn dollars just by using your skills.

Before making the decision japa to any country with your skills or profession, it's important to research the specific place  conditions, requirements, and potential challenges. Additionally, seeking advice from people wey don already make the move, e go help you get valuable insight.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
September 11, 2023, 03:28:20 PM
#18
~snip~
oboy, i dey read your comments dey laugh. You even sabi the trends wey don happen pass me sef. And I like as you take outline am.

Wetin you talk na true, the thing with Naija pipo be say dem must shook head enter that thing wey dey trend until e burst. Look this Japa thing for example time go reach wey be say all those countries wey our country pipo dey run dey go, go close their borders specifically to Nigerians because dem nor go fit differentiate their own country from Nigeria.

I also like your prediction, in as much as say pipo dey Japa through marriage, the ones wey I don see for internet na so so old grandmas and divorcees dem dey marry. This one even worse. Well make we dey look.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
September 10, 2023, 01:52:15 PM
#17
If you don join the Japa trend before, you go Sabi say e dey very expensive and second e dey hard to even secure interview date.

This Japa mata no be here oh meanwhile I like as you outline everything for this thread on how the trend dem take be. You forget to put the entertainment trend when everyone been dey reason to enta the entertainment industry (dat time na when skit making start dey become popular when people's notice say na the easiest way to take become celebrity (like take blow be dat). You dey also forget the personal business era and multi level marketing era when everybody been dey do MLM for the country before dem MMM cum come spoil everybody mind with ponzi scheme as people leave the MLM dey enjoy ponzi schemes businesses. The thing be say the country just dey like the crypto space, anything wey come out people go rush am and wan benefit too. I also remember the days of scholarship wey everybody dey rush wan write exam to gain one, so many memories.

The question wey I wan ask una be say, wetin una think say go be the next trend after this Japa thing pass?

E go hard to predict oh because I for like talk crypto but dat one already dey happen as everybody's dey claim say na crypto business wey dem dey do. I for also talk football but people dun see say dat area no be easy oh as I no dey too here people dey talk about am again. My own prediction go be business go be the next new trend, e get when buying of land for estate been dey take over wey be say estate dey advertise land for radio 24/7 but dat one dun reduced too. The country just dey kill any other trend wey get to do with the country so na to japa just dey trend but wetin I think go replace to japa go be japa pro max and that's to marry white woman through arranged marriage to move go outside. Dat one never dey popular but at the rate at which dem dey blacklist Nigerian to travel so, our only options go be to marry away to take commot.
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
September 10, 2023, 10:58:09 AM
#16

I think wetin dey trend right now for naija na content creation. If you open social media na contents full everywhere like comedy skits, pranks, blind dates etc. Person like Sabinus wey people no no before don make name for himself through comedy skits. BrainJotter, Shaggi, Untouchable... di names too plenty, even some artiste wey don already establish for Nollywood dey run their own skit wey come dey make me dey wonder weda skits dey pay pass Nollywood abi na just anoda side hustle for dem. If you check am well different names dey come up everyday and dem dey do very well. So content creation na di trending topic now.

My brother na skit dey pay pass to dey make movies oo. You go need to compare the cost for the two join too, the time wey e go take, the viewers choice. Like me now, I dey like the skit pass home video wey be say dem don finish wetin dey get to act, their directors and script writers no get anything to talk about again but comedy skit go make you relax and laugh out the sorrows in Nigeria and skit no dey last which makes more sense so that you no go just seat down two hours dey watch and listen to one kind story wey yourself fit write. For the aspect of the money wey dem dey make too, as we already know say naija no dey rush hussle for where gain no dey. I listen to sabinus one day wey dem interview him, hmmm the money for the skit be like oil money and you know even need to too dey funny to go into the stuff just make content dey your head and you com dey creative.
This na him make me like Nigerians because no matter the hardship and pains wey dey the country, people go always love to watch comedy to make them laugh so that them no go too reason about the situation of things. I personally, I dey take my time watch all those funny skit,we go make me feel happy and sometimes i dey laught till my belle go start to dey pain me, or wey tears go dey drop from my eyes. Now I understand why one musician say we dey suffer and smiling. This skit hustle make sense o and na cool cash na e dey inside and na very lucrative hustle.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 10, 2023, 06:09:42 AM
#15

I think wetin dey trend right now for naija na content creation. If you open social media na contents full everywhere like comedy skits, pranks, blind dates etc. Person like Sabinus wey people no no before don make name for himself through comedy skits. BrainJotter, Shaggi, Untouchable... di names too plenty, even some artiste wey don already establish for Nollywood dey run their own skit wey come dey make me dey wonder weda skits dey pay pass Nollywood abi na just anoda side hustle for dem. If you check am well different names dey come up everyday and dem dey do very well. So content creation na di trending topic now.

My brother na skit dey pay pass to dey make movies oo. You go need to compare the cost for the two join too, the time wey e go take, the viewers choice. Like me now, I dey like the skit pass home video wey be say dem don finish wetin dey get to act, their directors and script writers no get anything to talk about again but comedy skit go make you relax and laugh out the sorrows in Nigeria and skit no dey last which makes more sense so that you no go just seat down two hours dey watch and listen to one kind story wey yourself fit write. For the aspect of the money wey dem dey make too, as we already know say naija no dey rush hussle for where gain no dey. I listen to sabinus one day wey dem interview him, hmmm the money for the skit be like oil money and you know even need to too dey funny to go into the stuff just make content dey your head and you com dey creative.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
September 09, 2023, 07:41:15 PM
#14
The question wey I wan ask una be say, wetin una think say go be the next trend after this Japa thing pass?
I think wetin dey trend right now for naija na content creation. If you open social media na contents full everywhere like comedy skits, pranks, blind dates etc. Person like Sabinus wey people no no before don make name for himself through comedy skits. BrainJotter, Shaggi, Untouchable... di names too plenty, even some artiste wey don already establish for Nollywood dey run their own skit wey come dey make me dey wonder weda skits dey pay pass Nollywood abi na just anoda side hustle for dem. If you check am well different names dey come up everyday and dem dey do very well. So content creation na di trending topic now.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
September 09, 2023, 05:41:20 PM
#13
I no know if any other person notice this shits but e come be like ritual na the next thread for most of this youths because the rate of ritual killing dey really alarming and ritual wey been dey disgusting and done in secret don dey turn something of the usual  and nobody don fit talk about am.
I feel say japa thread still dey boom but from the look of things,  na forex, bitcoin and trading be the next thread now because if you enter internet now, the next thing you go hear na trading or bitcoin  or forex and that's a thread except of comedy wey I for mention as a thread but I think is already becoming questionable.
For this country, everything dey trend, na just to use your head;
  • Yahoo 
  • Yahoo+
  • Tech
  • Content creation 
  • Japa
  • Bet   
Many more things that is happening and more will come. But then we should be very careful before making our choices.
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
September 09, 2023, 04:39:26 PM
#12
You dey right say na people we already don bulid themselves to survive for anywhere we them go na them dey enjoy Japa. But still make you no forget say e get some kind odd jobs wey people still dey do for that side we go give you cool funds,especially when you come back to the country wey our money no get value. The truth be say e good make you go suffer for foreign country wey get level that you come suffer for Nigeria because Nigeria suffer be l;ike say na season film wey no dey end because of bad government. At the same time work dey all thiose foriegn country pass here we na man know man. Na G-boys dey worry us now o as them no won japa because the money wey them won go there go find,them dey here dey collect am from their clients.
full member
Activity: 756
Merit: 180
Eloncoin.org - Mars, here we come!
September 09, 2023, 04:03:44 PM
#11
I feel say the next big thing na crypto still. Even those wey dey Japa know say na to go crypto accepted country sure pass.

The country situation is tiring as it is already. Same old jobs, same old courses, same old skills, same old politicians, same old schemes.
If anyone has a skill they have been honing and have limited access to the resources needed to master and earn from that skill here;
why the person no go Japa?
Na so person star dey begin shine o!
sr. member
Activity: 294
Merit: 267
September 09, 2023, 03:55:53 PM
#10
Quote

Oga OP, but come to think of it o. E been dey always run for my mind say, why people dey Japa like this and why this Japa syndrome come infest on many many people like this. But since e dey understandable say our economic instability and corruption be the major reason wey make others dey run look for greener pastures. I wan ask tey tey say, why that kind thought never run into my mind before? Abi I get resistance wey dem inject put for my body ni wey dey always make me talk say, I most remain in Nigeria to survive and makes an end's meet?

Abeg, if na village people or something else dey give me that motivation make una tell me o. Because my patriotisn spirit dey high like this, regardless of the situation and I wan stay join hand change the narrative.

Our ways of thinking is different and the way we are exposed different. As a human being, we view things differently and what you consider as normal may looks like suffering to others, what you view as simple will sound or looks complex to other, what you consider to be standard of living will look like help to others and that's why you see people live their comfort zone for another country that has high standard of living than their own, na why people they japa be that.

Wetin you dy see say na normal, another person fit see as suffer, because you fit endure the hardship no mean say another man go fit do the same na why when people see small opportunity to run comot for the country, them dy quick escape sharp sharp just to get greener pasture for another country to get their life together because some people don believe say them no fit make am for this our county naija.

Another thing wey I feel why u no get the feeling to escape this country fit be say you get people wey u dy look up to or may be u sef don get person wey dy support you financially. People dy wey no get family or helper, na them after them na why them dy do anything to run comot.
full member
Activity: 378
Merit: 230
Bitcoin in Niger State💯
September 08, 2023, 04:49:43 PM
#9
A fad is  trend. And a trend is something that everyone talks about or does for a short while after which they move on to the next happening thing. I remember many years ago wetin been dey trend then na say, you wan be doctor, engineer, lawyer. After that one na oil company work come dey trend. Everybody been wan work for oil company. After that one na come government job. Everybody wan get government job. After that one na tech. Everybody one do tech. Now wetin dey trend na Japa. If you don join the Japa trend before, you go Sabi say e dey very expensive and second e dey hard to even secure interview date.

For Naija, all of us sabi at least 2 persons wey don Japa. Some sef go tell you when them don reach because say na you be winch wey fit stop them(Sarcasm intended). I nor talk say Japa nor good or bad but we the stories wey dem dey sell give us no complete. Pipo wey dey enjoy this Japa thing na skilled workers o doctors, software engineers, Nurses. Unskilled people na Dem dey suffer pass and na Dem dey sell all their property to take Japa. Only to go there go suffer. I nor dey judge Dem.

The question wey I wan ask una be say, wetin una think say go be the next trend after this Japa thing pass?

https://nairametrics.com/2023/09/02/japa-is-it-wise-to-sell-off-your-properties-to-relocate-abroad/

Oga OP, but come to think of it o. E been dey always run for my mind say, why people dey Japa like this and why this Japa syndrome come infest on many many people like this. But since e dey understandable say our economic instability and corruption be the major reason wey make others dey run look for greener pastures. I wan ask tey tey say, why that kind thought never run into my mind before? Abi I get resistance wey dem inject put for my body ni wey dey always make me talk say, I most remain in Nigeria to survive and makes an end's meet?

Abeg, if na village people or something else dey give me that motivation make una tell me o. Because my patriotisn spirit dey high like this, regardless of the situation and I wan stay join hand change the narrative.
full member
Activity: 308
Merit: 143
September 04, 2023, 05:27:49 PM
#8
The trend word "jakpa" come gain ground when we country 9ja com dey be unbearable and intolerant bcos life na jst 1 to be gambled with way come make we dey live life by troubleshooting for survival from 1 point to another til ewe even feel the least country go beta pass ours.

We feel to jakpa out of towns or 9ja bcus time no dey again. If u no help urself nobody go help so no time to waste.
We all dey find beta life so we gears up to find this beta life anywhere at all e dey na why this jakpa dey trend and e no go fade til our economic system com to give us a beta living where the  we go see this country a beta place to beta our precious lives.
As for next trending word, that one a future term way no body knows. Na present situations on ground dey fumes what to trend.
member
Activity: 159
Merit: 39
September 04, 2023, 02:45:44 PM
#7
I no know if any other person notice this shits but e come be like ritual na the next thread for most of this youths because the rate of ritual killing dey really alarming and ritual wey been dey disgusting and done in secret don dey turn something of the usual  and nobody don fit talk about am.
I feel say japa thread still dey boom but from the look of things,  na forex, bitcoin and trading be the next thread now because if you enter internet now, the next thing you go hear na trading or bitcoin  or forex and that's a thread except of comedy wey I for mention as a thread but I think is already becoming questionable.
Ritual don dey happen long before Japa na. If me I wan put am I go say the reason all this ritual stuff dey go on nah be say boys wan flenjo, live on soft and even fit Japa with ease.

I no fit place my hand on which Koko go be the next trend but e get the time way we naija folks bin dey reason to marry outside to secure their Green card.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
September 04, 2023, 03:00:30 AM
#6
I no know if any other person notice this shits but e come be like ritual na the next thread for most of this youths because the rate of ritual killing dey really alarming and ritual wey been dey disgusting and done in secret don dey turn something of the usual  and nobody don fit talk about am.
I feel say japa thread still dey boom but from the look of things,  na forex, bitcoin and trading be the next thread now because if you enter internet now, the next thing you go hear na trading or bitcoin  or forex and that's a thread except of comedy wey I for mention as a thread but I think is already becoming questionable.
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
September 04, 2023, 02:46:19 AM
#5
The hardship, inability to get something doing, instability in the country, government anti-peoples policy and the weakness of our currency have pushed people to this extent of wanting to japa at every possible opportunity, Despite the stress they encounter during the visa processing, people don't care anymore, what matters to them, is that, they want to japa, in this era, people see education as a waste of time because graduates are everywhere in the country unemployed, in this case, some family go to extra mind to borrow fund for there children to japa, so that things will get well as soon as they start getting money, our leaders have disappointed us so much, so the option for now is japa for some people, but I believe, Nigeria will be great again it may not be now but it must surely come to fulfillment.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
September 03, 2023, 07:04:41 PM
#4
I swear everyone want to japa leave naija empty. Since those things wey you mentioned e don fall. There was a time na Yahoo come dey reign like tomorrow e no dey and everyone wants to make money, boys dey come dey run for street like mad people. Omen those guys create dramas in naija streets oohh. And because there is no job anywhere as they think would happen after the graduation, everyone hustle to survive on the street and those who could not do the agboro work join others for survival. And for now nobody value education again. And the tin wey go Happened after dis Japa matter na bitcoin trending. Everyone go like to join bitcoin investment if proper orientation is giving to them. People like us wey no sabi any skills na here we dey. We no even know where to japa go sef. If we do sef dem go deport us come dat day. So there is no need for us to even go. Oboy those people we japa and succeed dey make well. But when dem catch you, you go hear am be dat. So make we pray say, make our government do well for di country so dat Japa e no go dey again because if you loss guide for there, you own don go be dat.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 03, 2023, 05:42:45 PM
#3
First I want talk say you no mention the graduate parol levels. Like e get when e be say for naija if you never enter university or poly, you never begin and because of that almost every family get one graduate there.

Well the japa level unto another trend wey go follow am, hmmm me I see say the level go be when we go begin see deportees. Like time go come wey some men go dey use their hand go airport say dem want come back unto say suffer go still dey there when people don full for mouth and the economy don dey over stretched. South Africa now dey face dat kind of situation as men don dey leave dere because of hardship and infrastructures wey don dey drop.
hero member
Activity: 1400
Merit: 650
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
September 03, 2023, 10:13:57 AM
#2
Omo na oda tin wey me no fit cap as e be now because everi tim na so we dey get new trends wey go dey float for we country after Sapa naim we get this japa. But make we tell ourselves de truth be say, dis country na one kind funny place wey be say pesin no fit afford to lose, usually me like 9ja and na free place to move around but if man no use sense dem go use pesin sense.
9ja be like bicycle whahala no dey finish, the more we keep going de we see new things inside we country.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
September 03, 2023, 10:03:31 AM
#1

Jump to: