I thought, I have seen it all until I begin to see some things that is worst than the previous economy. I used to buy a liter of fuel #180 in Buhari regime but, since we entered this new regime the price of fuel hit #500 that made many things to went wrongs in the Nigeria economy and the worst thing is that the new government is not bring any strategies that will improve the weak economy. This is my question, How will Nigeria economy look like when this new government is approaching her second tenure? Because the way the new government economy look like now show, that we are about to enter disaster that will make other country to take over the country.
What is your opinion my Naija people.
The economy no smile for anybody and dos wey dey see d last administration as say e bad, dis one don dey show shege already and we neva go far. Everyday na so so promises of saying d economy go better and we go all dey alright but we no dey see d change wey we want. Na from d government ahbi na people wey dey follow am work dey make hard for us, e just get as e be wey be say na only God go come intervene for us.
As d matter come worst reach, Naija still dey strive and hustle well to meet ends meet. Na the kind courage wey dey inside us dey make us fit still live and dey follow d economy jejely even as we dey hear pepper. About dat fuel price during Buhari regime, dat time dem neva remove fuel subsidy, had it mean dem don remove am, we fit don dey buy fuel for dis price for long now. But wetin dey pain us be say, we neva still see d result of dis fuel subsidy wey dem remove, omo we still dey suffer, make we just dey pray and hope say tins go beta for us all soon.
I thought, I have seen it all until I begin to see some things that is worst than the previous economy. I used to buy a liter of fuel #180 in Buhari regime but, since we entered this new regime the price of fuel hit #500 that made many things to went wrongs
Abeg, how much did you just said them dey sell fuel for your area? Did you just said #500? Because if so, then P.M me later I go drop cash make you buy 100 litres keep for me, because currently speaking, fuel for my area na #700, and I dey even hear say eh fit enter #800 or #1000 soon, but no matter how the economy be, at least we go always survive my bro. No be today this hardship start, and currently now, we don already dey use to it.
Naija no dey carry last when dey see opportunity wey dem fit benefit from at all. I no sure say they get where for naija wey fuel still be N500, E be like na mistake him do as e talk am. If fuel dey N500 for him side, fuel scarcity for don enter dat side because people from neighboring states go dey enter go buy fuel dey resell for their state or even carry an go hide keep dey use from their gradually. Wetin I like for dis all matter, we still dey optimistic say better day go come and we go still survive am. If no be dis kind mindset why we get for dis country, we for don escalate cause kasala for everywhere wey no go better for us all for d nation.