Then for the area you say people judge us from the structure we get, I no think so. Wetting them dey judge people na wetting you don do for your community people. So many people dey rich but dem no dey often visit the poor, homeless, widow and orphans for the village or even check for the things the community lack and when you dey do that thing you go notice say you go get recognition and respect pass who get Manson wey no dey gree help people. Just like this Xmas e get one man for my community, him dey always do giveaway to the widow, orphans and poor people Every year and dem dey also respect am. But that one no end there, for me I think wetting you go do to get recognition na
1. You fit build mini factory for your village or any thing wey go bring development to your community. Because na development dey make people leave where dem dey, dey go other states, but if e dey your community I think investors fit come around come dey invest and your community people go also get job from there and feed themselves.
2. Creating education contests programs and taking the best out of them, and train to higher institutions.
3. Skill acquisition programs for married and unmarried women and men for them to have a skill which dem never get before.
4. Sports/games and musical competition. the best will wind an award or given an opportunity to participate in Nigeria football or music. from there he or she will discover his/her talent and your name will never be forgotten.