Author

Topic: Who dey make prices of things dey very high? (Read 181 times)

legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
August 03, 2024, 05:18:07 PM
#11
My people I greet una, e get wetin I dey think for sometime now on how anytime price of something go up to come down na problem. I dey talk with my neighbor d other day say we no know who we go hold hand if nah Government wey dey make things go up and stay there or nah all these yahoo boys wey no get conscience nai dey cos am.

In addition to what Marvelockg has said, Government no dey increase the price of things directly but they do that indirectly and na just few things wey dem go do na wetin dey affect price of things and those things na,
  • Price of fuel
Nigeria economy is controlled mostly by the price of fuel so when government commot the fuel subsidy wey we been dey get, the price of fuel comes increase and from their every other thing needs to increase as fuel na him be out most used national resources next to gas

  • increasing taxes
When importation taxes are being increased, e go affect the price of things especially as most of our consumptions are imported goods but no be say government go just wake up they determine the price wey marketers go sell their things.

  • Forex exchange
this one na dollars price mata, everybody know say when government intervene for his matter as dem dey always do, e go affect the price of things so make I no talk much as na dollars be the importation currency to use buy things.

Anything wey the governments do wey no make sense go affect the price of things for the country, when they make new policy wey the marketers no like , we go expect the price of things to increase too because everybody dey find e own gain.
member
Activity: 200
Merit: 27
My people I greet una, e get wetin I dey think for sometime now on how anytime price of something go up to come down na problem.
Na why I no like make something Dey go up unnecessarily for dis country, because I know say e no go come down to d price wey e start to Dey increase, highest na just small e go drop wey no Dey make sense. Mostly na people wey Dey sell those things no go want make e come down, Dey go don enjoy as dem Dey sell am high, and they won’t want it to come down, no be everything government Dey cause, even as we know say na dem be primary problem for dis country, but even we citizens Dey fuck up.

Make I use agriculture products as example, time Dey always Dey wey farmers Dey always add money to their farm products because dem go talk say d season don pass, and na only people wey store am get am remain, but if we enter another year, and the season comes, d price no go ever drop like that, things like dis, na we Dey cause am and no be government.

Actually yahoo boys don really cause harm for dis country, yahoo boys don make clothes Dey fucking expensive, and me I go talk say na yahoo boys be d cause of that one, but primary problem of dis country, na politicians.

And tomorrow people go come out say make we go protest for bad governance meanwhile na we still dey make life hard for ourselves becos I no see any reason why becos of greed to make things be the way we see am go be talk of war. Life nah only one we go live am but make we no use am enslave ourselves becos we want to be the richest or something, e be like say that past slave trade something still dey worry we Nigerians. About Agriculture own e dey a bit understandable concerning the season but when them no wan keep the price down na dia be the main issue dey, na the greed I dey talk about which is not good. Me I go sometimes blame the both of them depending on the situation I find myself, I mean yahoo boys and the government. Both parties wan use high spending take kill we the poor ones, I no fit remember how much be cloth self, to enter tailor house nai go be the best to dey wear native😂 throughout.
sr. member
Activity: 854
Merit: 451
My people I greet una, e get wetin I dey think for sometime now on how anytime price of something go up to come down na problem.
Na why I no like make something Dey go up unnecessarily for dis country, because I know say e no go come down to d price wey e start to Dey increase, highest na just small e go drop wey no Dey make sense. Mostly na people wey Dey sell those things no go want make e come down, Dey go don enjoy as dem Dey sell am high, and they won’t want it to come down, no be everything government Dey cause, even as we know say na dem be primary problem for dis country, but even we citizens Dey fuck up.

Make I use agriculture products as example, time Dey always Dey wey farmers Dey always add money to their farm products because dem go talk say d season don pass, and na only people wey store am get am remain, but if we enter another year, and the season comes, d price no go ever drop like that, things like dis, na we Dey cause am and no be government.

Actually yahoo boys don really cause harm for dis country, yahoo boys don make clothes Dey fucking expensive, and me I go talk say na yahoo boys be d cause of that one, but primary problem of dis country, na politicians.
sr. member
Activity: 602
Merit: 291
Bitcoin in Niger State💯
There are some places where things are cheap and there are some places where things are expensive, and all these things are the same, so you can’t blame the Yahoo boys; they have the money to buy those things. The people who should be blamed are those in power (the government). They have the right set a price for anything, and since they failed to do that, everybody sells their things at the price they wish. 

Government is more responsible to the economy situation of a country than it's citizens, that does not rule out the fact that even the citizens don't have their share of the responsibility. When you have a responsible government, you are able to deal with the economic crisis to the best with the kinds of policies and programs designed by the government to shape the Socio-economic situation of the people and their businesses.

Governments with weak policies and programs are prone to facing more economic challenges than government of countries who face the issues head-on. The face that you will be faced with economic challenges as a country is certain, either through the domestic market or influences by the foreign markets. The best way to solve these problems is to always face it strategically by imploring sustainable policies like control of prices of commodities within the domestic market and the strengthening of the currency by leveraging the mineral and natural resources in the country.
member
Activity: 200
Merit: 27
My people I greet una, e get wetin I dey think for sometime now on how anytime price of something go up to come down na problem. I dey talk with my neighbor d other day say we no know who we go hold hand if nah Government wey dey make things go up and stay there or nah all these yahoo boys wey no get conscience nai dey cos am. Government own na to increase things then leave am till them get all the gain wey them want but the yahoo boys them no dey even price self, them go even wan add money join am becos e plenty for dia hand and that alone dey make market people always increase the price becos the yahoo guys go still come without pricing na just to take pay go... I say make una put mouth for this matter who we fit say nai dey really make things stay on high price for this our contri, na government or yahoo guys?🤔
Baba august 1st na nation wild protest against bad government, I for like make we file out to protest about the high cost of things for market, at least make government know say them really need to dey proactive about the plight of Nigerians, no be to pay lip service everytime for things way dey affect us as citizens, because if we continue to dey complain like without doing anything, nothing go change oh, so we all need to do something.

 government and yahoo boys na almost the same kind of persons, the people way dey government dey use fraudulent means dey thief money, na the almost the same too with yahoo boys.

Big man you dey invite me to come join the protest abi wetin becos I no understand where this August 1st talk dey go. Things wey people dey think plenty that na why I make am open make we talk who dey responsible for this high price of things so you fit say nah government wey we know and sometimes nah we dey use our hands dey take spoil things for us becos of greed, guy reason this thing, if the protest start no be still some boys wey no get job nai go still come fight against the protesters? So who we dey fight against, government or ourselves? As long as this matter international help never come in I no sure say e go easy and no get no wrong, I no dey against the protest in any way I just start the reality.

My people I greet una, e get wetin I dey think for sometime now on how anytime price of something go up to come down na problem. I dey talk with my neighbor d other day say we no know who we go hold hand if nah Government wey dey make things go up and stay there or nah all these yahoo boys wey no get conscience nai dey cos am. Government own na to increase things then leave am till them get all the gain wey them want but the yahoo boys them no dey even price self, them go even wan add money join am becos e plenty for dia hand and that alone dey make market people always increase the price becos the yahoo guys go still come without pricing na just to take pay go... I say make una put mouth for this matter who we fit say nai dey really make things stay on high price for this our contri, na government or yahoo guys?🤔

first na the government we go blame because if the government no put high price for something this yahoo boys, them no go go market then go buy the things with that price. Okay leave yahoo boys first the individuals wey them still dey work good work even them go market no matter how the price is you go buy. So nothing the yahoo boys do for here them just follow the procedures wey them government done already done start, so my brother no blame the yahoo boys instead blame the government wey them won kill us with higher prices.

I agree with you but from how e be now e dey work both ways, government dey at fault and the so called yahoo boys dey at fault too. I say eh, government don start up the whole high price something but these other guys choose to stick to that high price just to show off, we know how them dey behave always want make people notice them for the yahoo boys them oh. Fine the market sellers self hand join for all these matter becos of to sell market well well, e no good na few market sellers get conscience and i know say people don lose that patience for this contri.
member
Activity: 154
Merit: 10
Patience is key
My people I greet una, e get wetin I dey think for sometime now on how anytime price of something go up to come down na problem. I dey talk with my neighbor d other day say we no know who we go hold hand if nah Government wey dey make things go up and stay there or nah all these yahoo boys wey no get conscience nai dey cos am. Government own na to increase things then leave am till them get all the gain wey them want but the yahoo boys them no dey even price self, them go even wan add money join am becos e plenty for dia hand and that alone dey make market people always increase the price becos the yahoo guys go still come without pricing na just to take pay go... I say make una put mouth for this matter who we fit say nai dey really make things stay on high price for this our contri, na government or yahoo guys?🤔

first na the government we go blame because if the government no put high price for something this yahoo boys, them no go go market then go buy the things with that price. Okay leave yahoo boys first the individuals wey them still dey work good work even them go market no matter how the price is you go buy. So nothing the yahoo boys do for here them just follow the procedures wey them government done already done start, so my brother no blame the yahoo boys instead blame the government wey them won kill us with higher prices.
sr. member
Activity: 700
Merit: 270
My people I greet una, e get wetin I dey think for sometime now on how anytime price of something go up to come down na problem. I dey talk with my neighbor d other day say we no know who we go hold hand if nah Government wey dey make things go up and stay there or nah all these yahoo boys wey no get conscience nai dey cos am. Government own na to increase things then leave am till them get all the gain wey them want but the yahoo boys them no dey even price self, them go even wan add money join am becos e plenty for dia hand and that alone dey make market people always increase the price becos the yahoo guys go still come without pricing na just to take pay go... I say make una put mouth for this matter who we fit say nai dey really make things stay on high price for this our contri, na government or yahoo guys?🤔
Baba august 1st na nation wild protest against bad government, I for like make we file out to protest about the high cost of things for market, at least make government know say them really need to dey proactive about the plight of Nigerians, no be to pay lip service everytime for things way dey affect us as citizens, because if we continue to dey complain like without doing anything, nothing go change oh, so we all need to do something.

 government and yahoo boys na almost the same kind of persons, the people way dey government dey use fraudulent means dey thief money, na the almost the same too with yahoo boys.
sr. member
Activity: 728
Merit: 354
But did you think it was really what you thought? because for me, I don’t think Yahoo is the reason why things get high in price, but the government, because the government has the right to set a specific price that they want to sell a specific thing at in a certain amount, and nobody will go against it. But in this country, there is no control over the price; everybody sells their goods at any amount they wish, and that is why you will see one thing, but the price also depends on the location where you find yourself.

There are some places where things are cheap and there are some places where things are expensive, and all these things are the same, so you can’t blame the Yahoo boys; they have the money to buy those things. The people who should be blamed are those in power (the government). They have the right set a price for anything, and since they failed to do that, everybody sells their things at the price they wish. 
member
Activity: 200
Merit: 27
All the things you've pointed here are secondary reasons why the cost of things can go high, the primary reason is mostly dependent on demand and supply. Note that even  in shops where goods are sold at an expensive rate because of the yahoo guys who will petronize them regardless of the price, they still sell other customers at a subsidized rate. We don't have anything like a fixed price rate which would have made it possible that anyone that comes to buy an item gets it a a particular price, almost all the shops sell thier goods at different price to different customers depending on how you present yourself and you're left with no option than buying it.

My broda you think say people no wan get plenty moni? As for the price I dey tell you say too much greed dey worry many of us and as a businessman if you see person wey get am for mind say any amount you mention them go pay without trying to price I dy tell you say them no go wan keep the price at the normal price and as long as those set of yahoo boys dey always patronize them you go notice say them go dey happy to get more gain by increasing the price for them and e go affect the poor ones, to me all these has nothing to do with demand and supply as you talk.

Quote
We have a lot of forces that is against an average person that's still struggling and it makes it way to deficult to thrive in the midst of these things. A situation where an item like a simple polo would be sold at 30k and you have a lot of people that will comfortably buy it what do you expect the poor or average ones to do? If you don't want to buy it, a lot of others are readily available who are willing to buy it at the snap of the fingers.

We've come a long way negatively and this is not the tund to complain, you've got to pull yourself together and work very hard knowing that things is far from getting better. If you don't build yourself to measure up to what's now the order of the day, you're just on your own.

For this one you go agree with me say nah them dey make things dey on a high price, like why would the price of the said polo be at that amount even when you price it down the sellers still leave it at that same price becos they know that the main people that don't price must come and buy it, we never talk about food own oh, just polo 30k. So you dey talk say you dey ok with all these yama yama behavior? If you dey comfortable with am I no sure say you want make better dey and no matter how hard you say make we work I no still sure say the average man go fit dey enter market anytime soon, that if we still get average man again as the situation dey worse.
sr. member
Activity: 392
Merit: 277

Jump to: