Author

Topic: Why not our legendry's apply for Mod? (Read 105 times)

hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
April 23, 2023, 06:34:18 AM
#10
maybe if una apply and them finally give 2 to 3 persons mod to dey take care of this our board e go really make sense and e go help us wella, i don see for meta section wey some people dey apply for this things in other to keep their board regulated clear from spammer and shitposters without overall admin visiting that board to delete post.

I know say this question been don rise up somewhere before but i no fit remember where them post here but i know we been don talk am, first, this our board na just 4 months or 5 if no lie about this. We need sub-forum first before those things first dey possible just as Igebotz and Charle-Tim don already talk na so e suppose be but as a good member you be so, if e get some things you witness or notice say e no good you go report them quickly and i believe within 24hrs or 48hrs interval them go clean am up.
So when the main time reach we go still get our mods and by then e go sweet pass i know say them go dey active dey work to know things we dey happen within we board.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
April 21, 2023, 07:38:36 PM
#9
Greetings my people here, how una dey and how things dey go all over una side.

Abeg i wan ask small question, although na more of suggestion for this we board, if i no lie e don reach about 6 months to 1 year wey dem give us local board. Yes, i really appreciate those wey put effort to make am happen so easily, but i go wan asked why those our oga them no put efforts kukuma apply for mod, like for example e get some post them here way dem suppose control or delete to make here cleaner and purer as we want because i know say na this thing dey cause why we dey see shitposters full for this we board. maybe if una apply and them finally give 2 to 3 persons mod to dey take care of this our board e go really make sense and e go help us wella, i don see for meta section wey some people dey apply for this things in other to keep their board regulated clear from spammer and shitposters without overall admin visiting that board to delete post.

Abeg make we put hands together work this one out for we localboard as well, at least e go make sense wella.
I just talk my mind but i believe say people wey senior us here go also raise their reason as well make we put am together take facilitate this precious board.
E never reach 6 or the 1 year u cap. Na December last year we get our independent from the general local board 2 our private nija board, and those shitposters under tok about, dem dey read dis your post like dis, and dwm go still post anoda nonsense tomorrow. And 4 di local board moderators, yes na one di good ideas we many e don tok. I believe say dwm go do am very soon and everything go dey marama. The shitposters sef go confirm di odudu. Let dem be doing it with all pleasure.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
April 21, 2023, 04:31:51 PM
#8
Our main target now is how to get child boards for easy navigation of topics. just keep reporting shit posts

edit
Charles-Tim beat me to it. Cool

Okay thank you all for the suggestions and contribution i hope to my mouth sealed on this aspect of post since it has been clearly stated the reason why they shouldn't applied for such position yet.
Will do my best to report any post that isn't valuable enough, most especially seeing those shitpost and spams across the board.

@Charlse-Tim i also viewed your point, thanks for your input.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE
April 21, 2023, 03:03:53 PM
#7
I think @Charles-Tim don already finished everything wey I want talk and e go sweet us say we dey able to achieve our sub-board before we go request for any further thing that concerns mods or admin to look over we local board. As usual we know say e dey hard to control people talk less of crowd couple with a place wey dey open for everyone to easily make an account to come post bere, anyhow make we just try our best to put effort make here remain Clean the wey e be.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
April 21, 2023, 02:30:50 PM
#6
I believe say CryptopreneurBrainboss don address this issue for another thread before, I think that person been dey ask say why we never get merit source for local board or something similar to that angle. The answer na still the same thing way Charles-Tim and Igebotz don already talk, this board never pass 6 months although we don dey active for the local hangout threads way CryptopreneurBrainboss create years back and also the African proverbs in pigin thread by Mpamaegbu, I dey surprised the way new accounts way no know the history of how the board take be dey immediately dey compare our board with other people own. Rome was not built in a day. The main thing na for the discussions for our board to make sense, mods and merit source go surely happen but if the board na spam nothing go dey for merit source to merit and na big work for moderator becos na only delete and lock thread he go dey do.
newbie
Activity: 15
Merit: 1
April 21, 2023, 12:26:16 PM
#5
Mate I really like dey way u talk your mind here, I be newbie oh but I done go through this board and wetin you talk na true but as u talk am e no too tey wei them give us this local board and we really appreciate our oga’s efforts wei make am happen. To me I just bliv say our them oga’s here are really doing their best to make this board work smoothly and what we seeking for we go get am in due time you know everything for this life na stage by stage we surely get there just hand in there and trust God.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
April 21, 2023, 11:26:59 AM
#4

Omo, d bodi way pple put 2 mak dis local board dey herr 2day dey far frm anytin easy o. Without plenty talk, d mata start wen CB create dat our formal naija hangout way we bin dey manage b4 dem give us dis corner. D date way dat thread cari cef old pass me 4 d forum (March, 2019). Dat na a very long time if we trace am reach 2day, na abt 4 abi 5yrs b dat o.
Omo, una try nd e gud say, una start somtin nd al of us put bodi finish am.

Na y e go b bad tin say, after every every, pple go con dey dirty d place wth watin no mak sense or watin don cast 4 d forum. E no go well. Notin com easy 4 dis forum so, d smal one we don archive, mak we adorn am nd guide am well. E no easy.

Persn way no get watin 2 talk, mak e quite en mouth. To create plenty thread no dey cari anybodi anywhere.

D issue of moderators, we suppose get one 4 here shah via say, na anode community we b bt, na work b dat o nd evn pple way dey run d forum cef nevr wan reason dis mata. Na smal smal. We go reach dere.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
April 21, 2023, 10:38:50 AM
#3
Abeg make we put hands together work this one out for we localboard as well, at least e go make sense wella.
I just talk my mind but i believe say people wey senior us here go also raise their reason as well make we put am together take facilitate this precious board.

This is the political section of the forum, and it's one that theymos hasn't appointed or increased in numbers for a long time. I believe that the current mods and patrollers are doing well, which is why he hasn't considered increasing the numbers even when some of the mods became inactive and left the forum, the mod of B&H MiningBuddy left the forum in 2018 and hasn't been replaced yet. TBH, having a mod here is unrealistic for the time being; our activity are far too low and its something that a patroller can handle; nonetheless, I have noticed that most of my reports on this board have been handled quickly, in contrast to a few months back.

 I believe the moderator assigned to this board has been active recently, although he may have difficulty moderating pidgin posts, which is where we come in. BTW our board is 50% English, 50% Pidgin so its quite manageable.


Our main target now is how to get child boards for easy navigation of topics. just keep reporting shit posts

edit
Charles-Tim beat me to it. Cool
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
April 21, 2023, 10:29:07 AM
#2
Abeg i wan ask small question, although na more of suggestion for this we board, if i no lie e don reach about 6 months to 1 year wey dem give us local board.
Nigeria local board was created in December 2022. Today is 21st of April, this forum was created on 21st of December. Which means it is just four months old now.



You can use the report at the lower right side of any post to report the particular post to a moderator.

I understand what you meant, that we need a local moderator which would be better. If need be, with valid evidence that most posts reported are not deleted while they supposed to be deleted, someone can come up with it on meta board and other needs we want a local moderator.

After election, I do not see many posts as unnecessary, but all I am thinking is that as this single board gets more topics, we are going to need sub-boards. If we have sub-boards, the main board and many important board would be clean of low quality topics and posts.

I think it is not moderator that we need for now, we need this board to have sub-boards. Maybe not yet the time, but the time is coming.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
April 21, 2023, 09:53:52 AM
#1
Greetings my people here, how una dey and how things dey go all over una side.

Abeg i wan ask small question, although na more of suggestion for this we board, if i no lie e don reach about 6 months to 1 year wey dem give us local board. Yes, i really appreciate those wey put effort to make am happen so easily, but i go wan asked why those our oga them no put efforts kukuma apply for mod, like for example e get some post them here way dem suppose control or delete to make here cleaner and purer as we want because i know say na this thing dey cause why we dey see shitposters full for this we board. maybe if una apply and them finally give 2 to 3 persons mod to dey take care of this our board e go really make sense and e go help us wella, i don see for meta section wey some people dey apply for this things in other to keep their board regulated clear from spammer and shitposters without overall admin visiting that board to delete post.

Abeg make we put hands together work this one out for we localboard as well, at least e go make sense wella.
I just talk my mind but i believe say people wey senior us here go also raise their reason as well make we put am together take facilitate this precious board.
Jump to: