Author

Topic: Why we too de abuse moments of celebration? (Read 196 times)

sr. member
Activity: 532
Merit: 250
November 11, 2023, 01:53:27 PM
#17
This na very good advise and we don dey approach the time wey dis celebration dey rampant and people dey misuse am. Many people don loss their lives as a result of dis there non-challant attitude towards celebration. We don mature pass level wey we go dey misuse celebration, I mean dos wey dey do naming ceremony celebration, valentine celebration and d rest. D one wey I go talk say na young people sef dey do am, dey misuse am na dos wey dey do sign out. True maturity na when we fit control how we take celebrate our success for other people eyes. Make we dey take an easy because life na only once, make overjoy no make us die in celebration.
newbie
Activity: 15
Merit: 0
November 11, 2023, 01:06:43 PM
#16
Reason could be that people get caught up in the excitement and enthusiasm of the moment, and don't think about the potential consequences of their actions.. people feel like they have to participate in the celebration in order to fit in or be accepted by Others. Some people may simply enjoy the feeling of being reckless which is not good. Drinking out of control. Whatever the reason, it's important to remember that celebrations should be fun and enjoyable for everyone involved, and should not lead to harm or damage in the place of Celebration.
sr. member
Activity: 546
Merit: 265
November 11, 2023, 12:20:03 PM
#15
When you take over alcohol that you can't take control of then it takes control of you and lives to reveal and active your real being. Those that fights as a course of having alcohol are beasties. Even at non ceremonial grounds they are inspired to cause mayhems.

The reckless driving and the abusive of alcohol as a caused of celebrations is due to overwhelming and the inability to hold oneself maybe on a great achievements.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
November 11, 2023, 06:34:31 AM
#14

   People suppose day bold to face what ever consequences for their actions, to celebrate your wins day necessary but how you take celebrate am matter too as well, everything way you talk for you still leaves with the person moral or values, if na person way get good morals and propped home training, peer pressure no go fit get anything against am. No matter which kind excitement way person day get if you get better training from house all this unnecessary things way lost young people day do no go fit get to. Even if you need drink you go know the quantity way go day okay for you. Watin I day try talk be say he depends on person and how mannered they are
    Everything way we day do we gats still remember where we come from. Plenty of us come from good and Christian homes but base on say you wan feel among you go do pass yourself, just to prove yourself. People way get good morals and are disciplined day nothing way you fit do to influence then negatively because they know watin day want for their self. Mostly na peer pressure day cause this our present generation to do watin they no suppose do, if we normalize day over do things way no get value for the internet  rather impact more educative and innovative things for we go fit still some changes because na internet be the fast means of information right now.

My brother this thing wey you talk na true oo, person wey no get proper home training naim dey mumu em self for outside oo, some parents think say when you lock pikin for house naim be the training but dem no no say that one sef fit make the pikin spoil pass, pikin wey dem lock for house wey get the zeal to explore if dem give am small chance like make em go university, my brother wattin that pikin fit do em, e no go chaise, em fit wan test every thing within that period of time, and before you go know em don go put hand for bad things because of peer pressure.
My roommate den, em papa na DPO and them dey send am money almost every week, but when money talk come reach ground among em peers dem dey cast am lost, say em dey depend on em papa money when em go fit make em own, na wattin me and this guy been dey pass through until one day I hear say em don dey do street, na that time dem come stop to dey pressure am anyhow. So peer pressure na one of the greatest things wey dey cause this matter of celebrating anyhow so.
full member
Activity: 322
Merit: 211
November 10, 2023, 12:34:50 PM
#13
This thing wey you talk about we dey see am almost every day and the thing dey pain me well well if I dey see people dey do rubbish, wen I been dey school after we write our exam finish, the first month ending of the next semester naim result dey burst out, and all in the name of say student pass their exam, through that excitement na there my neighbour for hostel start to dey smoke dey do hard drugs, and that na person wey be say e be like ajebor for house ( mummy pamper, daddy pamper) omor when I see the thing e pain me well well, some times the people wey we associate with matters a lot, no wander dem say "show me your friend and I will tell you who you are" we gats dey careful when making friends. Some person go do truth and dare wey go make person ginger you to do rubbish wey you no like because of over excitement, some persons dey forget say just that one time wey you excess something fit end your life in one Sec.
Person sef don because of excitement go ashawo quarter go collect HIV or other sexual transmitted dieses carry go house go give em poor wife wey dey innocent. So all I am saying is that excitement should not make us do things that are not reasonable in normal sense, and we should be careful especially in this period.
   People suppose day bold to face what ever consequences for their actions, to celebrate your wins day necessary but how you take celebrate am matter too as well, everything way you talk for you still leaves with the person moral or values, if na person way get good morals and propped home training, peer pressure no go fit get anything against am. No matter which kind excitement way person day get if you get better training from house all this unnecessary things way lost young people day do no go fit get to. Even if you need drink you go know the quantity way go day okay for you. Watin I day try talk be say he depends on person and how mannered they are
    Everything way we day do we gats still remember where we come from. Plenty of us come from good and Christian homes but base on say you wan feel among you go do pass yourself, just to prove yourself. People way get good morals and are disciplined day nothing way you fit do to influence then negatively because they know watin day want for their self. Mostly na peer pressure day cause this our present generation to do watin they no suppose do, if we normalize day over do things way no get value for the internet  rather impact more educative and innovative things for we go fit still some changes because na internet be the fast means of information right now.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
November 09, 2023, 04:39:18 PM
#12
This thing wey you talk about we dey see am almost every day and the thing dey pain me well well if I dey see people dey do rubbish, wen I been dey school after we write our exam finish, the first month ending of the next semester naim result dey burst out, and all in the name of say student pass their exam, through that excitement na there my neighbour for hostel start to dey smoke dey do hard drugs, and that na person wey be say e be like ajebor for house ( mummy pamper, daddy pamper) omor when I see the thing e pain me well well, some times the people wey we associate with matters a lot, no wander dem say "show me your friend and I will tell you who you are" we gats dey careful when making friends. Some person go do truth and dare wey go make person ginger you to do rubbish wey you no like because of over excitement, some persons dey forget say just that one time wey you excess something fit end your life in one Sec.
Person sef don because of excitement go ashawo quarter go collect HIV or other sexual transmitted dieses carry go house go give em poor wife wey dey innocent. So all I am saying is that excitement should not make us do things that are not reasonable in normal sense, and we should be careful especially in this period.
sr. member
Activity: 476
Merit: 307
Well, celebration na important part of life and people approach it differently. What I'm only against is people ignoring safety precautions during celebration thereby turning happy moments into moments of pain and sorrow like the tikme Buhari won election in 2015 where many people died during the celebration of the victory.

It is understood that many people resort to drinking during celebration but I wouldn't want you to equate highness to celebration because people high even when bad things happen. Highness na another topic of its own that need to be properly discussed because colos no be anybody mate.
hero member
Activity: 938
Merit: 605
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
On a norm anything wey person the so for life if you like make the thing be sweet thing or good if you don the over do am the thing don turn bad be that, no be only for celebration. Many of the times wey make people the over do these celebration stuff nah due to how over joyous the thing wey happen to them be and them no fit control the joy.

Imagine person wey don marry for over 15 years in marriage and no child then along the line God com bless am with twins at once. You know the kind joy wey go overflow inside that person?  Inno go easy to suppress the joy and as the person wan just express am as him feel before you know e don turn wrong way of celebration be that.
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
October 28, 2023, 02:18:12 PM
#9
There is this thing for sure, the level of mentality at which people operate is the never the same, there are people who likes doing much beyond how it is expected.
Just one annoying part is for we Christians, you can see that on the 25th of every December is slated in the celebration of the birth of Christ but now that day has turned into festive celebration of drinking alcoholic, smoking and carrying of women.
Have we looked into the main purpose at which that day was made for celebration and reason behind it, Nigerians need to wake up and be knowledgeable about certain things before indulging in them.
sr. member
Activity: 434
Merit: 254
DAKE.GG - CASINO AND SLOTS | UP TO 230% BONUS
October 28, 2023, 10:15:01 AM
#8
This is very bad, people have seen this habit as fun, but I condemn it, this has caused so many people pain, why do reasonable individuals behave like people that are not trained, turning a celebration into a sad event, just imagine a student that's celebrating his graduation and some person decide to scope water from the drainage to pour him, is this called celebration or a sign of wickedness, these are not fun, they are just overplay, this madness has to stop, even the celebrants to use the even as an opportunity to do all manner of things, we overdo things here I think there should be a law to this effect if not very soon we will see this thing happening in the way we don't expect it.

sr. member
Activity: 546
Merit: 450
Fine by Time
October 27, 2023, 02:14:56 PM
#7
This na really one of the thing way we really need look into.Celebration has become something else ,we no longer do the normal celebration like we use to do .take for instance the  way we Dey celebrate birthdays this days ,we go say we Dey celebrate birthday but we go Dey do things way no Dey necessary,like taking drugs for birthday party when people don high they go begin fight they open head for the same birthday party, if care  is not taken person fit even die for birthday party way suppose just be normal celebration  .now some birthday party you go hear if you no get mind no come oh like is suppose to be a celebration which one come be if you no get mind no come or they go even tell you say na orgy party (come naked) like where are our values ,youths of this days now see this things as common things and is becoming irritating Undecided as adults we gat they reduce the level of our carelessness cus there is consequences for every action , . E fit no come now but later in the feature we fit regret am. Not only birthdays alone sha but for every celebration make we try they Dey careful and know weting we they drink and smoke. Life no they two no be for celebration of we suppose die put.
legendary
Activity: 2422
Merit: 1083
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
October 27, 2023, 04:01:01 AM
#6
Actually, it is commonly said that too much of everything is bad, and what they mean by "everything" is actually "everything", which includes happiness, over joy can kill, and i am not saying this based on assumptions, but based on fact and experiences.

There was an incident that happened in my area when i was still living in Lagos before i relocated to the place i live currently, a boy of a little above 17 years of age managed to save some money from all of his school handouts, amounting to thousands of naira, he used the entire money to play lotto (baba ijebu), and luckily for him, he won, and the amount of money he won was a little above 30 million naira, this after checking and seeing that his numbers played and he won the money, he instantly become over joyed, started running over the entire place while some boys were all chasing him out of excitement for him.

The guy was running the entire place and shouting, by now, he don pull shirt and trouser, was running with bare body and feet while the ones that are chasing him were still chasing him, all of a sudden, this guy run enter express road, na so one inter-state bus on speed hit am, the guy died on the spot. That was how what was excitement turned into tears for everyone around there, las las, the family collected the money he won, used out of it to give the guy a supposedly befitting burial, and life went on for them.

So, this incident personally thought me that, over excitement can indeed kill, which confirms the statement that too much of everything is indeed bad.
full member
Activity: 1414
Merit: 236
Catalog Websites
October 27, 2023, 03:21:41 AM
#5
That thing is too common among final year students, and there are some students always prepare for such celebration to come so that they can do anything to get the money for the celebration that will take their life. Am not saying celebrating your graduation in school is a bad thing but over high yourself with alcohol and drugs is not good and it can make you to lose some part of your body, you will live to remember and share the story with your children in the future.

I don't think bitcoiners has such spirit in this forum because, if you over high with the influence of alcohol and drugs and login into your Bitcointalk account and you break the rules that deserve ban from the forum, I believe you will avoid such drinks and drugs for the rest of your life.
sr. member
Activity: 616
Merit: 291
Bitcoin in Niger State💯
October 27, 2023, 01:40:08 AM
#4

E get one valentine period for my community when boys carry there banies go party for the valentine celebration. before you know, dem don drink enter highness levels begin fight themselves with machetes and before that day finish, wetin start as celebration don turn full blown community war.

The instances plenty concerning how we de take abuse moments of celebration but I just wan yarn us say as we de in the spirit of celebration, make we no use am wonjor ourselves. It is not out of place to celebrate, especially when the event is a remarkable one in our lives but it's best we moderate it so our celebration doesn't turn out to sorrows in the end.

As the year de draw to a close, make we celebrate and in the same spirit, make we do am responsibly. I trowe salute give una.

I pick interest for that Valentine incident pass but no be only for Valentine e dey happen. Na so them been dey celebrate these huge religious anniversary (I no wan mention the name) for here. Wetin start as celebration come end up take two people lives. One them chook am knife for neck and in the cause of revenge, the guy wey dem kill people follow the other guy go machete am too. Now e don turn serious community crisis as dem no born you well make you trespass the other side without being injured or killed as a result. The thing they surprise me well well how our young people self they behave now and why violence no hard to happen now.

Before these celebrations are meant to bring unity amongst community people and friends and family but now it id used to cause more fights between different groups of young people and what not. I wonder why our society has degraded up to this point now and I wonder what the security agencies and human rights are doing to bring these things to an end in a developing country like Nigeria.

The thing they surprise me these days as you go young even teenagers at their 17s taking knifes, cutlasses, screw drivers and other sharp objects with them when they go out to celebrate religious anniversaries like that. Na so the other day, e never pass one month as we dey drive pass one village on transit, we saw boys and girls trooping on the street with bands and speakers dancing and singing religiously but at the same time, you will see some of them with those items under their shirts, ready to cause any problems that will lead to fight.

I believe many of those boys are under influence and that is why they have that effrontery to become violent at any given time they are high. Na why I dey always drag human rights, security personnels and other related law enforcement agencies into this as I can boldly say that there is little or no advocacy on the effect of drug abuse and punishment to the perpetrators and sellers of those drugs.

Lack of jobs, causes high rate of unemployment which results to many of those young people rendered idle. It is said that an idle man is a devil workshop and this is why these young people have resulted to those violent acts always looking for an avenue where they can converge and cause havoc. It is that bad but we pray that God will continue to perform it's miracle on us.
member
Activity: 785
Merit: 34
SOL.BIOKRIPT.COM
October 23, 2023, 03:06:53 PM
#3
When we experience better thing, e de make sense to celebrate am but most time d manner most people de use celebrate am no de too make sense like that.

Because say your wife born pikin, you go Buy drinks, invite people and una go drink to serious highness come start to misbehave. Some go even fight and wound themselves In the process.

Some go write there final exams for school, all in the name of celebration de go over speed there cars come course accident and some of them go die in the process.

E get one valentine period for my community when boys carry there banies go party for the valentine celebration. before you know, dem don drink enter highness levels begin fight themselves with machetes and before that day finish, wetin start as celebration don turn full blown community war.

The instances plenty concerning how we de take abuse moments of celebration but I just wan yarn us say as we de in the spirit of celebration, make we no use am wonjor ourselves. It is not out of place to celebrate, especially when the event is a remarkable one in our lives but it's best we moderate it so our celebration doesn't turn out to sorrows in the end.

As the year de draw to a close, make we celebrate and in the same spirit, make we do am responsibly. I trowe salute give una.

This whole thing dey get one kind spirit wey dey back am up if you check very well and e no dey always be on clear eyes, like me too go dey just seat and dey reason am deep down, and some people with different mouth, ehh go be like, if things like that no happen the occasion or what ever them dey celebrate no dey legit. like ehh most such mood take place for it to be legit?
full member
Activity: 448
Merit: 202
October 23, 2023, 03:05:22 PM
#2
For sure, this issue of highness is getting out of hand, especially among the youth, both male and female. It is not a good thing when they say a girl is drinking alcohol and even smoking, but most of our youth take it as enjoyment in life, which is very wrong. Apart from the complications that you just mentioned in your thread, there are many other complications that may include damage to the liver, cardiovascular problems such as high blood pressure and heart attack, cancer, which include breast cancer, liver cancer, throat cancer, and many other cancers, and also metal issues most involved, like depression and anxiety, which might lead to death at a young age.

So I will urge youth outside their homes to sustain themselves and abstain from the use of alcohol. It is very hazardous and can lead to death at a young age, and not only death, but those health problems that I mentioned earlier can be inherited by their children. From there, you see, you have already created a problem for the family and, at the same time, for the community.
full member
Activity: 490
Merit: 225
October 23, 2023, 02:18:27 PM
#1

Jump to: