Author

Topic: Wike not supporting Atiku (Read 166 times)

full member
Activity: 406
Merit: 117
February 23, 2023, 06:11:20 PM
#21
If wike no dey support Atiku no be new thing. All of them na politicians wey get selfish interest for their own belle. For those matter as e b so wike dey protect him own interests that's why you see say him out interest for another party candidate which me i believe say before him go give support to that party him go don do some parol with them to see how far him go get him own cut when e be for them. The deal has already been settled hence his unalloyed support for his opposition party. Wetin dey  baffle me be say PDP no fir do anything at all Dem just dey look am dey mess Dem up and wike dey pepper Dem very well wey be say Dem no fit cough. E good for Dem like day as wike don already throw him weight behind Tinub come 25tg Feb for the presidential election for we naija.
legendary
Activity: 2632
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 23, 2023, 01:17:29 PM
#20
Una feel say wike dey fight for the good of Rivers people or en dey fight for en personal interest?
Just like almost every politician, personal interest dey always come first for them and for Wike he is only trying to remain relevant by asking people to vote Tinubu instead of Atiku, that is if this report is genuine.
You dey mind owa politicians? Dem be anywhere belle face. Wike should just go and rest. Him fall hand big time. All d gragra, see where im still end am out. Tueh!
legendary
Activity: 1386
Merit: 1107
February 19, 2023, 03:48:21 PM
#19

Wike and Atiku issue no get anything to do with Obi. Both Atiku and Obi at the moment na candidates and as e be now cef, the election dey between them both than Tinubu with the plenty drama way don play out both with the APC led government following previous administration and the comic state of Tinubu. The guy no dey disappoint. The only matter for Tinubu to get any chnace na if e fit rig am and the support of en people for that side. For this side, e no get many supporters from my evaluation.

Mean while, I know say, Wike na man way get body for en people but, that na only if en fit chop en own wella . En annoyance no go dey far from watin them do am for PDP primaries, them make am realise the game they play and the importance of brotherhood. That na something way en no go forget or forgive, na why en dey act the way e dey act. Last last, supporting Atiku no bringbthe government close to Rivers people or the south so, why that way.

Wike supporting Tinubu go come out of alignment way e don do with Tinubu. Na just wayin I dey think for head like this be that and to show say na the game they play, we see how e carry support for Obi sell sim, na them life be that, game of interest. If e no get watin to gain, e no go move as e dey move. Abeg, support who dey your mind and leave there directives, th no go suffer watin you go suffer.
sr. member
Activity: 546
Merit: 420
I buy all valid country Gift cards swiftly.
February 19, 2023, 03:07:18 PM
#18
I no go blame am because Atiku dey sideline Wike well well while others dey recognize him force for the south south.

Atiku dey fuck up, him no wan give Wike wetin Wike dey fight for and one of them na for them to zone the party chairman to dis side make everything no dey the north since dey no gree give south the presidency ticket. Wike na our own and na fight wey dey benefit him people him dey always fight for even though some personal interest dey always dey inside.

I go disagree with this one boss because from my own perspective of this whole situation between Atiku and Wike, na out governor wan dey feel like say the party no fit do without am because of the large force him carry because I personally watch news when dem been dey interview Wike about his presidential aspiration and the party's proposal to him( say make him come be national party chairman) but my man said no say him wan contest and when him finally contest come fail, he later come back say make them come give am the national chairman back as per wetin na? Na him be the only person wey get force?
Abeg make him rest and just because Atiku tell am say make him come be vice since he don miss the both slots now my man(Wike) say if no be national chairman then nothing and that's a very high rate of greed and make him remember say he belongs to the party (PDP) and not the party belonging to him as he thought.

Wike na one of the last persons wey go ever decamp APC because of the presence of Minister Rotimi Amaechi for the party and we all know say these two be like cat and dog.

sr. member
Activity: 462
Merit: 272
February 18, 2023, 07:32:19 AM
#17
My people una know about the issues wey governor wike and the presidential candidate for PDP (Atiku) Dem been get, the problem Don really increase o, e reach where be say wike don give order to Rivers State people say make Dem no vote PDP (Atiku) for president say make Dem vote APC candidate (tinubu)

Though wike never talk am openly oo, but the PDP political leaders for my local government don dey announce openly say wike say make dem no vote Atiku but tinubu, even yesterday for PDP rally for eleme, Dem still announce am,

My people how una see this matter?

Una feel say wike dey fight for the good of Rivers people or en dey fight for en personal interest?

And why be say wike no support Peter obi based on the issues en get with Atiku, why en choose to support Tinubu?

Nigeria issue just dey increase every day, All this our politicians get self interest or he fit be like say tinubu Don put something for him body, because no matter how e be wike no fit dey get problems wey with atiku and be saying his people should not vote for atiku, there must be a something that enter his pocket wey dey give am joy, even if he is saying they shouldn't vote for atiku no means say atiku no go get voters, because they are many people who also like atiku and they will vote for him.
legendary
Activity: 2184
Merit: 4113
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
February 18, 2023, 12:46:06 AM
#16
wike and PDP matter no they finish, waiting I see for this matter be say wike feel say them betray am, after all the effort wey him done put and if you look am to some extent wike get truth but if you look another thing again I no they trust politicians and if na politicians wey i know all waiting  them they do na because of their of their personal interest.

But Wike no dey lie na, dem betray am wella, without Wike been in PDP, I doubt the party for get strong force for the election infact as wike dun dey do like him dey comot hand, when last you hear PDP as a strong force for the election, no be only Tinubu (APC) and Peter obi (Labour party) wey dey make noise everywhere so. Atiku na the reason PDP go fall commot for the face of Nigeria as I believe if labour win then APC go become the new opposition party and vice versa if na APC win. How PDP go use their own hand betray their very own just because one abroad based politician. One thing is certain, PDP no dey this presidential race in my opinion.

Everybody agree say North no dey return to that sit again and even Buhari and his statement came to an arrangement which is why APC was pushing for the tickets to go to other areas and most especially a young man so him fit relate well with the youth but unfortunately Asiwaju get other plans. If I be wike I go abandon my current party immediately because them deny am all the things he should be benefiting today for holding down the party when everybody ran.
sr. member
Activity: 714
Merit: 356
Underestimate- nothing
February 17, 2023, 02:53:39 PM
#15
wike and PDP matter no they finish, waiting I see for this matter be say wike feel say them betray am, after all the effort wey him done put and if you look am to some extent wike get truth but if you look another thing again I no they trust politicians and if na politicians wey i know all waiting  them they do na because of their of their personal interest.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
February 15, 2023, 02:19:32 PM
#14
And why be say wike no support Peter obi based on the issues en get with Atiku, why en choose to support Tinubu?

Na because Wike deh find who go butter him bread and he knows Peter Obi no go get that type of package for him. Wike fall my hand like other politicians. As a young vibrant man him for side with vibrant Peter Obi but selfishness no deh allow them do the right thing. We still deh wait make Wike openly call the name of the person weh him deh support as him make mouth for December last year. Till today he has not. Ee deh clear now say fear don enter Wike body. Him don chicken out.
sr. member
Activity: 1008
Merit: 491
February 15, 2023, 01:10:25 PM
#13
No mind this our politicians. Na them them. All of them na the same. The last thing wey peso go do this time around na to allow politicians to dictate who and who wey em go vote for and or to vote for, after passing through the hardship wey d happen for the country.

If River state people want make they vote for Tinubu because of sae Wike ask them to, na their concern. Thank God sae no be a state vote go determine who go rule this our country. We get about 36 other states.

Make Wike just d calm down, em noise don d too much since wey em d get kasara with Atiku peso no d hear word. Shey after 25th of this month everything go end and we go come get a new president. All man go come rest
full member
Activity: 448
Merit: 146
February 14, 2023, 09:12:27 AM
#12
One thing you gats understand be say, wike dey do all this things for him political interest,  right from 2019 him no like atiku, and him dey always talk am. Today wike dey pursue abiye sekibo left and right because say their political interest no align again.

Wike political ideology and that of Peter obi dey world's apart, Peter obi dey more like a socialist while wike be like capitalist. So wike cannot support obi, wike still want the status quo to remain,  and Tinubu kind of personality resonates with that sort of idea.
member
Activity: 126
Merit: 3
February 13, 2023, 04:32:39 PM
#11
Well woke somehow dey right ooh for wetin e dey fight for ok, because I hear say them agree to zone presidency to south East, and later them no do am like that again and even the VP of sticky na e be chairman of the meeting wey them hold and talk to zone presidency, again them get law say if north Don produce president from PDP then the party chairman no go come from north again e go come form east or south but no do am like that this time so many error dey the PDP so na e make me say wike fit dey right for wetin e dey fight for.. and e reach person make e no fit support that e party again so I no too blame wike for not supporting atiku..
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
February 13, 2023, 12:12:22 PM
#10
After the PDP presidential primary election wey Atiku win Wike and other candidates, Wike begin para, e they talk say na him they carry PDP for head even when other elder statesmen like Atiku run comot from Naija after the last election, only to return now wey another election don they close, Wike also believe say PDP candidacy suppose come from the south and not the north, so na all these things they vex Wike for where PDP they.

Having said that, Wike they use him head wella for this election, him know say as PDP member wey him be so, him no go fit declare support for a candidate of another party, so him just lockup they run him matter underground, him also no campaign for Atiku, him just sit down for fence they use tactics take sabotage Atiku's bid to be president. From my analysis i no they give Atiku any chance to win this election, the two strong candidates na Peter Obi and Tinubu, and na one of them go win the election, PDP na jonzing party.
hero member
Activity: 910
Merit: 810
duelbits.com
February 13, 2023, 11:30:11 AM
#9
My people how una see this matter?

Una feel say wike dey fight for the good of Rivers people or en dey fight for en personal interest?

And why be say wike no support Peter obi based on the issues en get with Atiku, why en choose to support Tinubu?
Wike holds a grudge. Wike thinks he is powerful but sadly, he is only one person or just a mere man as every other person. All the suffer wey we dey suffer can he beat he say he is affected? He cannot sit in high places and tell us who to vote or who not to vote after all there is no difference between PDP and APC. No wonder Tinubu called it PDAPC.
sr. member
Activity: 504
Merit: 360
February 12, 2023, 04:31:16 PM
#8
Una feel say wike dey fight for the good of Rivers people or en dey fight for en personal interest?
If you dey talk about personal interest now you go think say na we poor mass dey do am, as the way I dey view this is now be say why be say na only him dey shout, why be say na only him carry the matter for head. Watin I wan ask am be is d South South no get party chairman he go affect them, dey Don get vice president na this one go even favour them past the chairman wen him they fight them. If na be personal interest him Don ever ask river people for watin him dey fight for abi dey no get PDP people for river state. This one na pure personal interest because no bi now wike dey cause problems since Prince Uche Seconds, Senator Ali Modu Sheriff, Senator Ahmed Makarfi and Ayu too, him own too much make him go rest. This one wen him the shout where was him in 1998 when they creat am. He just want to have saying in the party. Wike no fight for any body but himself, he want make they recognise am and dey pretend not to see him that why him dey vex.
And why be say wike no support Peter obi based on the issues en get with Atiku, why en choose to support Tinubu?
Him dey look for were him get recognition, wike no support Peter obi becus he no believe in him, meaning he can not win. This leader are all afraid of been poor that why dey dey look for where to chop people's money.

sr. member
Activity: 462
Merit: 411
Top Crypto Casino
February 12, 2023, 02:24:28 PM
#7
My people una know about the issues wey governor wike and the presidential candidate for PDP (Atiku) Dem been get, the problem Don really increase o, e reach where be say wike don give order to Rivers State people say make Dem no vote PDP (Atiku) for president say make Dem vote APC candidate (tinubu)

Though wike never talk am openly oo, but the PDP political leaders for my local government don dey announce openly say wike say make dem no vote Atiku but tinubu, even yesterday for PDP rally for eleme, Dem still announce am.

Broo.... The shoe wey dem dey call Nigeria na everybody put their legs inside and na all of us know where e dey pinch us. Any person wey brain for him head no go take these politicians seriously because nobody wey suppose tell you who you go vote for, after everything wey dem don put us into them still dey tell us who to vote for? Rather make them tell their principal make dem come give us reasons why we go vote them into office.
hero member
Activity: 994
Merit: 660
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 12, 2023, 01:31:05 PM
#6
And why be say wike no support Peter obi based on the issues en get with Atiku, why en choose to support Tinubu?

Atiku dey fuck up, him no wan give Wike wetin Wike dey fight for and one of them na for them to zone the party chairman to dis side make everything no dey the north since dey no gree give south the presidency ticket. Wike na our own and na fight wey dey benefit him,, people him dey always fight for even though some personal interest dey always dey inside.
Baba last last, politics is a game of interest and one thing we must know with Nigerian politicians is to say they dey do anti-party activities very well, for example, wike with be PDP for Governor and states houses of Assembly but be another party at the presidency, so wike decision na base on the one went favour his political interest.
-Wike is aware that Atiku is not to be trusted because he has betrayed agreements severally which is what has resulted in the rift between Atiku and wike.
- by mandate of the party Wike will not be able to campaign openly for another party at the presidency but he can use body language and also deliver his political block votes to the candidate he supports.
sr. member
Activity: 686
Merit: 411
MetaWin.com
February 12, 2023, 10:58:54 AM
#5
My people una know about the issues wey governor wike and the presidential candidate for PDP (Atiku) Dem been get, the problem Don really increase o, e reach where be say wike don give order to Rivers State people say make Dem no vote PDP (Atiku) for president say make Dem vote APC candidate (tinubu)

Though wike never talk am openly oo, but the PDP political leaders for my local government don dey announce openly say wike say make dem no vote Atiku but tinubu, even yesterday for PDP rally for eleme, Dem still announce am,

My people how una see this matter?

Una feel say wike dey fight for the good of Rivers people or en dey fight for en personal interest?

And why be say wike no support Peter obi based on the issues en get with Atiku, why en choose to support Tinubu?

Mate, before I will begin, I believe you are fully aware of this acronym for political class " no permanent friends but permanent interest" all politicians can never do away with this acronym because it speaks of great volume. As a politician you must be nursing this in mind so as to remain relevant irrespective of your political affiliation and that is what he is doing.  I know many would tag it selfish and self centered, that is what and how the business is, if you do not protect your interest, you will be thrown overboard with nothing left for you. Being a smart politician is all it takes to remain relevant and I believe you already know that he wike is a very smart politician who knows how the game is played.
Lastly, op I would like to see the link to the claims of wike telling his supporters to vote tinubu. Let's be factual with updates.
legendary
Activity: 1232
Merit: 1071
February 12, 2023, 09:03:14 AM
#4
Una feel say wike dey fight for the good of Rivers people or en dey fight for en personal interest?
Just like almost every politician, personal interest dey always come first for them and for Wike he is only trying to remain relevant by asking people to vote Tinubu instead of Atiku, that is if this report is genuine. If the election is not free and fair, Tinubu is the most likely candidate to win considering he is a master in election malpractice. Wike is aligning himself to ensure that he continues to be relevant in the political space in case Tinubu wins. Wike dey after e personal interest normally.

Just a few days left to the election, there will be a lot of drama leading to that day, something dey even tell me say dem go postpone the election.
legendary
Activity: 2184
Merit: 4113
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
February 12, 2023, 05:23:11 AM
#3
And why be say wike no support Peter obi based on the issues en get with Atiku, why en choose to support Tinubu?

If you be politicians who you go support when be say you know when Peter obi win, Him go carry everybody along provided you go for work for am and dey accountable to am but if Tinubu win na people wey work for am him go carry along. Wike self fit dey work openly with am but get underground package with Peter obi since the man dun visit am well well in the past months.

You see this politicians, no dey trust anything them talk abi no be d same wike wey say even though him lose to Atiku say na the interest of the party him go work for. Sha if Wike no work with Atiku, I no go blame am because Atiku dey sideline Wike well well while others dey recognize him force for the south south.

Atiku dey fuck up, him no wan give Wike wetin Wike dey fight for and one of them na for them to zone the party chairman to dis side make everything no dey the north since dey no gree give south the presidency ticket. Wike na our own and na fight wey dey benefit him people him dey always fight for even though some personal interest dey always dey inside.
sr. member
Activity: 672
Merit: 490
February 11, 2023, 06:10:56 PM
#2
All these politicians that just selfish heartless people, what ever they do it must be in their interest else they don't support. I am not surprised at the so-called governor action, the man na WIcKEd man normally right from when he was a local government chairmo sef, na tyrant attitude him get. But it get one tin I wan correct from ur statement; Wike no go fit order Rivers people, cos Dem no be him zombies rather na him stooges and surrogates na him order not Rivers. Imagine how him pick the worse case scenario becos of him own selfish interest against the nation wey we dey cry say dis current government don scatta finish.
member
Activity: 350
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 11, 2023, 03:41:17 AM
#1

Jump to: