Three of these things na something wey I sight say people wan dey try remove body for, to work for person to trade forex and to dey play gamble weda for casino or online. Me myself I Dom reason am for our country as e be like this now I no sure say to work for person fit favour person again especially when e come be say u dey alone or u dey feed family and salary no come balance this one na one of the things wey people really complain of last year.
Another one na forex trading and gambling I just put them together because them dey like brothers, one of my friend call me after the new year, bring him phone and book dey calculate all the money wey him spend for online betting account and forex trading Omo the money too much but that bobo go always tell you say money no gum am but everyday him dey trade forex still dey play gamble. These three things wey I mention sometimes fit control mental health those wey dey trade forex go know wetin I mean that one na when u allow am be addiction you fit dey calculate forex ur brain dey hot sef the same thing with gambling,
So this year how person wey dey do these things want take cope and how much profit and loss you as an individual Dom calculate from your own side and how u dey take control or cope with the addiction.
Make we hear from you person fit dey here to learn from our own contribution.
You don't trade forex without sufficient training, make nobody deceive you, you no go fit really learn forex well from youtube or signals wey them dey drop for telegram. you must get firsthand guidance from an expert and continue learning under the person for a considerable length of time before you can be experienced enough to start profiting to a reasonable extent.
Excessive gambling is also a problem and should be your last resort when you are battling with limited funds, it would not make your life better since you don't even have spare funds talkless of amounts you can afford to loose.
The way I handled my addiction in 2018 was to quit gambling for 3 - 4 years, healed from my addiction and financial losses and got a new career to take more seriously than gambling and since then gambling has always been the last thing I do, I literally don't have much drive for it now since there's other important things I'm committed to doing and making money.
If you must trade, get a grounded knowledge, but never gamble as a full-time job.