Original Topic: Why beginners should pay attention to their privacyAuthor: o_e_l_e_o
I nor de eva normally tel people make Dem watch videos, but dis one worth d 30 minutes even if I nor sti like him style:
Data Brokers: Last Week Tonight with John Oliver (HBO)The whole matter sef de fear pesin. Everybody no (or suppose no )say many browsers, websites, and apps de monitor you and Dem de collect ur data. Watin many people no no b say data brokers de buy and sell Every single one way Dem collect from u. dis data fit b money way u de owe or how your body take de and Dem fit sell am give
anybody way want am.One broker way dem de call Epsilon settle 4 $150 million after Dem don sell data tire give people way Dem no say b scammers for over 10 years. Dem don sell Data give domestic abusers and stalkers(people way de monitor) way go allow dem track old victims.D video talk one case way pesin die bcos of him data way Dem sell for money way no reach $50.
Many companies talk say ur data de hidden, de-identified, or Dem de added with other data before dem share am or sell am, and many pipo think say Dem de safe.dem find out from One study say 99.98% of all dis anonymized data Dem fit de-anonymized am and Dem fit use am identify users. To de Anonymize data no get meaning.common website way we fit visit(without say we no even do anything for d website) go still give the website enough information to take identify the user, track their contact information, con sti send am email after some minutes.
Dem de sell your data give government. Governments fit need warrant or other legal ruling to fit come search your computer or device, but Dem nor need any permission to take buy that information from data brokers. Many government agency de buy ur data and dem de use am for anything way Dem want.dis matter ressemble matter of dis agency Dem de use data analysis from many blockchain company tay track ur Bitcoin transaction and ur Bitcoin address.
To add join am, centralized exchanges de provide many type of data give data brokers, especially if you by urself give Dem ur KYC information d same tin with blockchain explorers d same tin with SPV and light wallet servers.d same tin wit sites like Coinmarketcap or other crypto news site. All dis Bitcoin information and other information way relate to crypto Dem go pool am join other of ur info way Dem get con sell am give
anybody way want am,even Dem scammers and criminals. Remember say na simple click of website give d website info way go reach no d pesin way click am.you really wan make d whole world know how many bitcoin you de hodl?
D way Dem tay de cast our privacy and watin we de do day by day too much. So no make am worse by say u con de cast ur privacy matter by ursef.
Dis one na better place to take start to de take back ur control well well:
https://www.privacyguides.org/Peer to peer bitcoin trades, avoid d privacy invasion of centralized exchanges:
https://bisq.network/,
https://localcryptos.com/,
https://hodlhodl.com/Run your own node, and avoid to de leak information about your address and transactions:
https://bitcoin.org/en/bitcoin-core/