Author

Topic: You lose your friends cause of politics,for politicians (Read 94 times)

full member
Activity: 798
Merit: 134
I believe say people don wise already and I know election na next week Saturday since them no fit do am this week Saturday again. E don tey wey be say I don comot body for politics mata because e dey too carry enemy follow body, e dey also waste people life since dem dey easily pay people to go do one evil thing for dem without even putting their personal life first.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
For this country if you lose your friends for one yeye politicians then I ahswear you be mumu!!!
Tinubu been support Atiku for presidential ambition for like twice, they are very Good friends na em correct guy. Peter obi been do Atiku Vice aspirant before na Good friends them be. You con they here they fight your correct guys, friends wei be say you suppose they build wealth with. Make we no lose guard oh for this country.

Bro you don try with this your advice and this na one of the best and finest piece I've seen since today and I wish I for award you But i no get.
I don see brother dey kill brother and pikin dey quarrel papa and mama just over persons wey dey share money behind close doors.
I dey always tell people say politics na game of personal interest and since politics na game ,na who Sabi play go win and Nigeria really need to visit their root to be able to win this war and what we need typically is a rugged good man that knows the game.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
For this country if you lose your friends for one yeye politicians then I ahswear you be mumu!!!
Tinubu been support Atiku for presidential ambition for like twice, they are very Good friends na em correct guy. Peter obi been do Atiku Vice aspirant before na Good friends them be. You con they here they fight your correct guys, friends wei be say you suppose they build wealth with. Make we no lose guard oh for this country.

People stupid normally, abi na today you dey realized am. People dey fight and kill demselves because you no get the same political reasoning like dem. Dem dey forget say this politicians wey dey fight for morning like dis dey meet for night seat down drink one or two beer or whatever drinks dem like. U mumu go come dey block your friend for whatapp because him no support OBI or your candidate, continue (in mama patience voice). Politics is a game and only those that knows how to play it wins. Some country the game no dirty but it didn't start like dat. You see country wey dey 100's of years older, you wey dey just 60+ wan go compete with them when your illiteracy levels na die.

Before Nigeria go get a free and fair election, alot of things needs to be achieved like our educational level need increase, our wellbeing, human right awareness etc and this things need reach everywhere no  be only youths matter. One thing self wey make you an educated person na wen you fit understand say people fit get different opinions about life which politics is a big part of but yet that doesn't make them not educated. When It's politics even the republican and democrats dey fight for wetin go favor them yet dey still do what's good for the country and na so e supposed be for Nigeria as well. Make u no go lose a friend wey fit be your helper tomorrow because of OBI or tinubu wey dun make am already for life and dey steadily relate.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
That's one thing people need to understand we all have our opinion about everyone, if you look at social media see how violent everyone is bad we are supposed to stand strong we should NOT allow politicians to come between us as youths, for social media I was not happy at all seen the response of most people, please everybodys opinion matters its very simple no big deal if you don't want my opponent that's fine, everyone should support their opponents, NO BE FIGHT MATTER.
hero member
Activity: 1050
Merit: 501
You know when I commot mouth for politicians matter na why I see former governor of Imo state Emeka Ihedioha, Rochas Okorocha the rapour with present governor of Imo Hope Uzodinma in a wedding ceremony of a.daughter of a top politician in Abuja. After I see that happen, I kukuma swear sae I no go ever drag issue with peso or carry politicians matter for my head again. That display of theirs make me weak for the matter because I know how this fellas been the castigate each other for the state and their followers d do the same against the other.

You see all this our politicians na dem dem. They know how them d settle each other for back. Wey be sae their supporters go d act like mega promax enemy for online. No be big time mumu d be??

With all this things wey our politicians d display for online
na only mumu people wey go d take wetin them the talk against each other for back seriously to fight his friends or neighbors
hero member
Activity: 784
Merit: 666
Anyone wey lose friend because of politics and choice of candidate can never be considered as a friend in the first place. When you no allow anything come between you and your friend no matter what na him be true friendship. I pity those wey dey disown their friends because of election, they’ll never get any like that, election will pass but a true friend will always be there. We should stop grading our friendship or relate it into politics, because politics is a dirty game, not reliable and it’ll come and go. Politicians do things for their own selfish gain.
legendary
Activity: 2226
Merit: 1049
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Well, las las, you suppose know say there are some people wey grow tall and wide, but unfortunately for them, na fish brain dey there head, for me, I no dey discriminate any body all because they no dey see political things from the angle wey me i dey see am from, everybody dey entitled to their opinion, and so also, every one get right to choose any body wey dey feel say na him be the right person to vote, las las, na still the person with the majority of votes na him go win.
member
Activity: 378
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
We Don grow up already, and we Don get sense, na only people wey still dey inside uncivilized community (village) nai go dey keep enemies because of politics, politics na always about personal interest, my interest fit dey different from yours nai make we no fit support thesame candidate.
As you Don talk too all this Politicians na friends despite their different ambition and different party, Dem still dey do things together, na still Dem be that PDP, APC, labour party etc.
Dem get where Dem dey go chill after election and drink better cold wine, laugh and jolly together, so anybody wey dey quarrel because of this Politicians needs to wise up because this politicians are never enemies....
newbie
Activity: 15
Merit: 1
 For this country if you lose your friends for one yeye politicians then I ahswear you be mumu!!!
Tinubu been support Atiku for presidential ambition for like twice, they are very Good friends na em correct guy. Peter obi been do Atiku Vice aspirant before na Good friends them be. You con they here they fight your correct guys, friends wei be say you suppose they build wealth with. Make we no lose guard oh for this country.
Jump to: