Make una no vex the way I take arrange this my topic but if any of you know how I go take do am well I no mind if you correct me because our people say "only thing wey dem no dey learn na to cry".
I don stay like this for some times things dey run me and family matter for head carry join, sometimes e go hard me self to even open my mouth yan person wey no dey reason wetin me dey reason sometimes. E get sometimes I go feel like to give up because life no easy if you no know you no go know, see as you dey eat 3 square meal a day no be so others dey eat but if them no open mouth yan you e go be like say things pure for every bodi.
If you notice me sometimes I been dey current here dey do most of the task at times but as a family man wey me be I lose focus based on pressure and family wahala, but one day I sit down for my house front just put my hand for my jaw dey reason how life be for my side one thing come tell me say make i never lose hope because I still get place wey small small pepper go dey enter my hands, na so me fall back here with full force say make i start again even though say many people don leave me go far but e no mean say me no go still buckle up.
As e be like this something come enter my head say I still another family here wey be say I go rub mind with them to carry get back my feet, just our people talk say "na tipper and tipper dey play together reason because if you sink na your fellow tipper go help thour you out from there"
Meaning if I associate with my people here na dem go still fight my matta make i bounce back at least make my family eat small food. Like this the matta been don enter depression and una know wetin that one be for a family man, e no easy at all. After I get myself small I come say make i raise this topic at least I know say all of us no be one mama or papa but e get some people wey go need small guidance and advise based on how family matter dey run them.
So this place na for people wey depression dey worry or wey need small assistance no be say na to beg money but assistance on how to run life with them because e get one parable wey dem talk say " Two better heads is better than one small head" so with our contribution of words and peace of advice we go save souls and life because wetin I see before me fall back here no be small thing.
I go really want to appreciate Brainboss then him give me small chance to join him campaign and that little help really boost me well well so I say thank you.
Like this I see many campaign wey open slots but una know as e be if Man no get drum to carry fetch that water you no go enter for any of them until you get the required drum. I just talk am like this so that e no go too dey open but I believe say una get my code anyway.
So abeg una to dey free to post here make we help ourselves to reduce depression and anxiety.
Thank you Brainboss.
I understand things from your angle mate,e no easy atall,our people dey speak one language say" oosi,oosua" that is to say,if you no go,you no go know.If you no dey here see as e be,you no go know as e be.Life no easy atall especially when e be say na only you dey carry your cross,you dey try as much as possible make people no laugh you,you dey try as much as possible say you become someone vital in the society tomorrow.Definitly everyone needs a guild about life,the things to do to make money and make life soft,because them dey talk say all hands are not equal,e get some people wey don really know road,and the ones wey Neva know road just need them in dia life so that them fit match the right path.But one thing I dey always believe,and one thing wey dey always motivate me be say,as long as I still dey on the hustling race,one day,I believe say Oluwa go make things soft for me,same way e makam soft for some persons.And I also believe say here wey I dey,na the right tract for me.