Pages:
Author

Topic: As our economy dey so, Bitcoin na blessing to us? (Read 573 times)

full member
Activity: 1176
Merit: 165
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
For me oh, I think say Bitcoin na blessing to us, because no single entity get control over Bitcoin.
Making it more resistance to censorship and manipulation.
E dey empower individual to get direct control over their finances without relying on intermediaries.

Na true wey u talk so, Bitcoin na really blessings to us, e don help our leaders to creat job opportunities for us wey no get work to do or wey dey find am hard to work for person and thank God say Bitcoin no dey under anybody control by now e for don crash, or e for don dey cease dey do like government work and wey dey sure of our money despite say e dey fall at times but at least no stress or pressure unlike our local banks dem wey to collect our money o na war, na so Waka Waka person go dey waka, just dey stress person unnecessarily but Bitcoin don come don make things easier and better for us.
member
Activity: 434
Merit: 85
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Bitcoin is really a big advantage to the world economy and not just Nigeria economy alone. The invention of Bitcoin is really one of the greatest invention in human history. Honestly speaking I haven't seen any invention that has been fought by governments around the world like Bitcoin. The emergence of Bitcoin brought up several jobs for people around the world that's why I said it helped the world economy. Many people got jobs in exchanges that came up as a result of Bitcoin invention thereby reducing the global unemployment rate. The benefits are too numerous to mention.
Bitcoin is important for every that acknowledged crypto. Bitcoin is entirely lifesaver for the smart people that cannot engaged in top white collar jobs. Nigerians have make good utilization of bitcoin and most of them have also suffered due to their carelessness and greed in the system. Everyone knows what to expects from the system, we should always mapped out our plans ahead of time, the little time we have, always shoots for skyrocketing results and not settling for lesser results.
full member
Activity: 1176
Merit: 165
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
For me oh, I think say Bitcoin na blessing to us, because no single entity get control over Bitcoin.
Making it more resistance to censorship and manipulation.
E dey empower individual to get direct control over their finances without relying on intermediaries.

Yes u dey correct, Bitcoin na really blessings to us, especially for me o because ever since I know Bitcoin my life don change, I don advance for life , if no be Bitcoin, o for no know wetin I know today, Bitcoin don really create jobs for plenty people and I thank God say Bitcoin no dey under government power, if not by now, e for don crash and people for they suffer more, since government dem dey enjoy to dey see us suffer but Bitcoin don come to help us out yet, dem still won comot Bitcoin from existence which can't be possible, because if no be Bitcoin some people for no get kind idea wey dey get today about Blockchain and Bitcoin don help to the extent, some people na land owners while some na business people, etc.
member
Activity: 168
Merit: 75
Na true talk u talk so, Bitcoin na really interesting technology wey dey help pesin to get control over e own money, and dey make financial services more accessible to everybody, especially me like wetin e dey do for our society today, and I  dey happy say many people don start to accept am as a form of payment.
And I  no just dey look the money side alone, because e also dey make person to dey more independent and nobody get control over am like our local banks and  Bitcoin go dey more and more popular for future and e go dey change people life the more, if the government like make dey do wetin dem won do, as far as way dey for us to still dey use am, we go dey use am small small dey go and I hope say person go make through this bitcoin.
full member
Activity: 224
Merit: 151
Bitcoin is really a big advantage to the world economy and not just Nigeria economy alone. The invention of Bitcoin is really one of the greatest invention in human history. Honestly speaking I haven't seen any invention that has been fought by governments around the world like Bitcoin. The emergence of Bitcoin brought up several jobs for people around the world that's why I said it helped the world economy. Many people got jobs in exchanges that came up as a result of Bitcoin invention thereby reducing the global unemployment rate. The benefits are too numerous to mention.
full member
Activity: 182
Merit: 120
Bitcoin na blessing for Nigeria no doubt and the fact be say bitcoin don help many people because people dey take advantage of the volatility nature, it's best if everyone can be part of this technology to take advantage but it's impossible in this country, even if people want to adopt it can't be everyone, even with the features of bitcoin not everyone will like to own bitcoin. The second thing wey bitcoin take help us as a decentralize currency, freedom to control your own money and when I observe the technology of bitcoin e just dey unique, for example politicians, government know the advantage and use of bitcoin but they can't just leave Nigeria currency they feel fiat is the superior but they know that's not true, I dey get one feeling say our politicians own bitcoin but we don't know and they can't come out open, I believe say any person wey hear about bitcoin know say e dey beneficial.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
Indeed bitcoin na really blessing to us. Na only blind man wey no go see say bitcoin no be blessing to us. Just whatch out from the beginning of bitcoin invetion till now, you guys see say e don creat awearness and the adoption don dey massive since then. and people wey accumulate an wehen e been dey cheap naim enjoy an pass. and now signature campaign come be another way wet late adopters carry benefits from am. Just chech how many people for the forum don use Bitcoin money achieve better thing. Some for here don build house, some don buy car, some don start business, while some don use an mary there dream wife. Some don use am save there loved ones wey for don die. and many other things. so bitcoin na really blessing to us.
jr. member
Activity: 67
Merit: 7
Op na true u talk o Bitcoin na blessing to us more especially the young youth wey dey into am, if to say na by power or Bitcoin dey under centralized power before hardship for really dey because the rate of Bitcoin go come dey valued according to that particular country currency just imagine our weak currency e for no get value but now as na decentralized policy no body even the USA sef no fit take charge of am and them dey find all possible means to make am centralized but God no go gree for them
member
Activity: 238
Merit: 54
   God really use Bitcoin bless our country this hard time,if not we no know wetin for Don happen to many of us especially people wey no get job or hand work at all and dey get from dem person..see now Bitcoin don reduce plenty bad boys for street wey don finish university since ten years till now wey no get  work or who go help dem, ab i na  pick pocket , thief, e.t.c .
   Even the ones wey dey help the politicians during election sef no ready again because dem dey fit make them moni òn their own now through Bitcoin ,on like before during election period we go dey hear say dem dey fight and kill themselves mainly governorship election, but this our past governorship election for Bayelsa state no dey like dat ,everywhere dey peaceful  so na very big blessing be dis o o o we thank God well well and Bitcoin makers .
full member
Activity: 266
Merit: 113
For me oh, I think say Bitcoin na blessing to us, because no single entity get control over Bitcoin.
anything when you fit do legitimately for this country when our leaders or a particular body no fit de make decisions about, na him sure pass aswr!

But then, bitcoin no be work but na just means when we fit use invest our money so within some years time, wetin we go get back go make sense wella.

Make e no surprise you say if our government know say you fit de make one or two rubbers for here them for even de check your phone find way when de go take disturb you or extort small money from you .
member
Activity: 154
Merit: 33
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Indeed Bitcoin is a blessing to us all because it is decentralized digital currency that is not at the obligation for the wicked governments to take authority controls about via terms and policies including the taxation charge rates. The government is so heartless that they don't care about what you an investors profits maybe but all they cares about is having all sectors as revenues to generating itself Money in disguise to economic revenues.
Looking at the current state of time where there is crumbling of the economy that the fiat is so going valueless and depreciating to the USD. Also as at now that the government has set a financial regulatory system of the banks going bankrupts leaving the masses frustrated that even those who has accounted to have money in the bank are restricted from having their Money in other to solve their essential needs. The government do not ever care while the economy is crumbled.
So Bitcoin had really served an alternative for the masses to do with their funds and assets above the control and effectiveness of the  economic system in the country.
full member
Activity: 560
Merit: 161
Bitcoin na really big blessing to Nigerians both in economy wise and generating money for people.  As the economy dey go bad it is affecting fiat which it is losing value because of this people will prefer to invest their money on Bitcoin than to leave it in the bank which it will depreciate over time. Many people have been able to generate money through bitcoin in one way or the other, bitcoin is really a blessing indeed . Their is no doubt that bitcoin has really been help to people in this bad economy.
full member
Activity: 322
Merit: 146
Bitcoin na blessing to em investors and those way get interest to Invest on am considering how hard our economy be and the competition for the labour markets including the hijacks way our government dey do us just like when we dey work like lions but dey earn and chop like slaves or ants.
The way of Bitcoin really suit okay for this our economic system because whether things hard or e no hard for the country, whether crisis dey for the country or not, whether na economic break down as inflation or deflation, e no concern Bitcoin. Em own na to dey face em own differences like em dey another world. Na why e be digital currency and a decentralized currency.

Also as our dubious and rebellious government no get a dime control of this digital market of Bitcoin investments instead na everyone dey in-charge of em own Bitcoin coin such as the security aspects through the Blockchains.

However, things don hard for the country to an extend our currency (naira) no get value again so e com be say those who earn in hard high rated currencies like the US dollars na em the bad economy no dey affect. Imagine where $1 be #1,700+?  Our money don big for eyes and in figure but no values to afford tangible something.
This na also other benefits of Bitcoin being blessing to us all because Bitcoin dey calculated using the universal world exchange currency US dollar $.
So anyone trading or investing on Bitcoin na Dollars dealer.

As e dey sweet us the Bitcoin investors and scaling through the hard times the bad economic system set for us, na so e dey pain them the government specifically as them no get hands to censorship of the Bitcoin industry.
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
Of a truth getting to know about Bitcoin na better update wey dey help many people but the truth be say you fit dey consider am as the best blessing wey you don receive make another person dey cry say why him even know about Bitcoin in the first place. Maybe say him don loose better money for inside this our Bitcoin wey all of us dey rejoice. I get friends wey be say anything concerning Bitcoin dey know want here, sometimes e get some kind money dey go collect I go tell them to invest am inside Bitcoin because with the way the economy take dey now money no dey last again, anyhow you hold am for account or for cash before you know u don dey carry out expenses both the one wey necessary and the one wey no dey important.

So na better thing wey be say us wey dey here don learn how to manage our Bitcoin so as not to cry like the way some people dey do.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
Vave.com - Crypto Casino
The control can be of two types: the first is the control over bitcoin price while the second is the control over your own money. Bitcoin do not give the government or central authority the power to have any of the two controls. But according to your post, you are referring to central authority control, like the government.

But regarding economy, bitcoin is an asset and its price is controlled by demand and supply. People buying more and the coin is becoming more scarce which makes its price to increase. In short, bitcoin is an appropriative asset and that is how I see it is helping Nigerians, for people to use it to hedge against inflation.
Well I don't know how it will look like and if individual whales can control the Bitcoin price then government entities can do that as well if they heavily invest in Bitcoin with their national wealth. But if the government is trying to control the price without investing, then they can not do that because as you rightly said, Bitcoin price is moving with the demand and supply. And one thing we have to know is that Bitcoin is not on this Earth to remove inflation if not inflation has been removed since but it is to make the Bitcoiners more comfortable in the time of the inflation because of the increase of Bitcoin. The economy is very bad but Bitcoin is making it users to surpass the economy so they are not feeling the impact of the bad economy. Though when they go to the market they feel the inflation rate.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
To be honest ehn, Bitcoin na the best thing wey happen to me this year, the learn wey I learn about am naim dey sweet me pass because even the small investment wey I don do, I dey see better change wey dey sweet my belle, and I still dey give a very big thanks to this forum members wey help me achieve this goal, assuming say i nor know about Bitcoin I for still dey think say to buy bitcoin person must get the full money to take buy 1BTC before em fit buy am. Anyway apart from investing wey Bitcoin dey offer, na still one of the safest wey to take make transaction using wallets, the feature of P2P without any intermediary na just one of the best feature wey person fit experience for business transactions. And no be say na person dey one place sef dey control the entire Bitcoin network, this na one of the thing wey make our government dem nor dey like make am succeed for the country, because no way for them to manipulate anything wey concern am.
member
Activity: 168
Merit: 75
For me oh, I think say Bitcoin na blessing to us, because no single entity get control over Bitcoin.
Making it more resistance to censorship and manipulation.
E dey empower individual to get direct control over their finances without relying on intermediaries.

Wetin you talk so na actually true, but make we no also forget say e get ways too wey e no favor Nigerians too. For example, this one wey fee don really high like this, the thing go really worry plenty people as them no go too see Bitcoin the way them been see am before. Especially for people wey no get plenty money for Bitcoin. Just imagine say them wan send small money via Bitcoin, them come sama them better charge. E just be like that time wey naira come scarce, wey if you wan withdraw small money from POS, them go knack you charge wey almost reach the money you wan withdraw. So the thing dey affect, not just us wey be Nigerians but every other people wey dey use the Bitcoin.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
For me oh, I think say Bitcoin na blessing to us, because no single entity get control over Bitcoin.
I no go lie you, bitcoin na complete blessing give us wey know am. I d pity those wey still be doubting Thomas for wia bitcoin d up till now. I no get anything to say to them as they agree and accept wetin the media and government d yarn for wetin bitcoin to be. Financial freedom wey we d find na head by head.

The situation of how our country be nah, no be wetin peso no suppose to depend on one source of income wey go d pay am in naira(considering how naira to dollar exchange rate d now). Peso suppose get different source of income, if peso gets any freelancer work wey go pay am in dollar na em advantage. If peso choose to dull moment na em business cos peso need survive and invest for em future and the future of em children. Na bitcoin come be the sure way for that.

Anyone wey no wan invest for bitcoin, na em self em d do. Gone are the days wey peso need to convince peso to invest for wetin go benefit am for the future.
jr. member
Activity: 135
Merit: 6
Well Bitcoin is really a blessing but not to everybody but to those who owns it now and those who will venture into it sooner or later because someone  who doesn't know about Bitcoin or who is not into it won't see it as a blessing.
However, it is really a huge blessing to those who has it now and those who will have it later.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
I swear na comfirm blessing sef, if not because of bitcoin how you think most of us wey dey this forum gi fit chop? Bitcoin Don save many life today wey we no fit imagine, the most likely part wey I come love am must is that it's not control by our government if not the kind of shege wey we go see no go be small thing, many people today don't have work, they only focus on bitcoin investment and today if you see them, them get money pass those people wey dey work under government, even many wey dey under government dey respect bitcoin if them hear the name, they are even among the people wey dey even get interest on investing their money in it.

This days sef I no dey see any young man who is well educated dey suffer himself dey walka around street say him dey find work, everybody just dey concentrate on how to become a successful person on their own,  because this life now you no fit dey wait say make you dey wait for your destiny helper, my brother you have to stand and use the knowledge wey you go get for school starts up something that you will never regret doing it, mostly many young boys now na through all this investment them dey see something chop now and you too as a human being wey you gast to make am, you have to stand up and follow people do what they are doing to become a successful person too, and all over the world bitcoin is well known as a good investment.
Pages:
Jump to: