• saving and investing: many of us know this one but we no dey do am. This one na to keep small of your income aside for future use no be to chop all , and then investing na to put some of you income into some thing way go make that money increase value over time. save at least 10% of your income and invest like 20%, you go surely see changes, and then the second one na
The good thing be say anyhow wey you dey take create wealth before for the real world, you fit still use am create wealth for the crypto industry because say crypto na just another currency like fiats too but e come get better advantage pass fiats dem because of some features wey Bitcoin carry. Saving and investing na one of the OG ways of raising capital to take invest and with crypto you no need dey do two things again, you fit just dey save for Bitcoin and already you dun dey invest be dat. As you dey commot your percentages from saving, just put am for Bitcoin and you're set for life because na you go benefit am at the end of the day.
• financial literacy: This one dey very important , make we tell ourselves the Truth, to get am clear for this industry, we really need to understand how money dey work , how to make am, how to manage am, and how to invest am. If you know this things e go really help your finance. And take you to the next level.
U no really need financial literacy to make am for this industry but you need am if you wan get a head start ahead of your peers because no form of education is a waste/scam as people dey talk. A time will come when that education that you got go help you. This industry na new industry so no too dey believe person wey dey tell you say him be expert for here because na try your luck many people dey do here. That person wey dey tell you say him fit tell you coin wey go do well or not from his knowledge, if you put head for ground you go fit make money pass am. The education that are helpful here are those gotten from the general financial literacy wey you dey get for other businesses or investment. Just understanding how to buy, sell and store your Bitcoin for your non constodial wallet dun dey enough to make am for the industry.
@cryptopreneurBrainBoss na true you dey talk, na the way the OP take put the headline and the body of the message dey confuse most people. The financial Ideas on how to create wealth and diversify your source of income, na general method to create and sustain wealth. However most people dey say for inside cryptocurrency, methods dey for ground way you fit apply to help you create wealth, which some persons too don list them out like, staking, mining, day to day buying and selling of cryptocurrency etc, which is all encapsulated in the crypto space, way most people expect say him go also include to help elaborate him idea.
Financial literacy na good aspects, but most times e dey come with so much sacrifice, you go need to deprive yourself of so much distractions in a pursuit of a goal, na this aspect gongon dey hard for a lot of people to implement, because it's not well talked about.