Pages:
Author

Topic: Afta excitement, reality go set in - page 2. (Read 302 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 16, 2024, 02:30:03 AM
#3
Good advice.

Most analysts dem talk sey once Bitcoin cross $51k and stabilize above am, bull run don start be dat. But for someone like me, na last quarters of 2023 bull run start for my eyes.
If you should take a look at it very well, bullrun started in January 1st 2023. At the time, bitcoin was around $16500, 10 months were green candles while just two months with red candles which were even mild. Bitcoin got to $44700 in December 2023. Just that the bull run has continued this year.
sr. member
Activity: 700
Merit: 270
February 15, 2024, 03:14:03 PM
#2
E don tey wey I be wan make dis post but activities nor gree me. Too much distractions and all dat to make ends meet and put food on the table. Una know how e dey be na. E nor easy for dis Tinucracy. If we wey dey here and dey wan campaign or d orda still dey feel d impact of inflation for Naija, make we just imagine wetin those outsider wey nor get any job or wey dey civil service dey feel? E don red, honestly.

Well, too much talk nor dey for evening market according to owa forefathers. Make I go straight to the matta wey carry me come here. I just wan encourage us to make judicious use of dis opportunity and capitalize on dis bull run to generate betta cash for owaselves wey go see us through the rainy days wey be bear season for dis industry wey we dey so. 2026–2027 supposed be anoda bloody period again for dis industry if we follow historical data.

BTC don cut chain, come cross road dey do waka for $50k since two days now. Excitement don dey begin fly up, noise don dey happen. But make we remember sey na only people wey get coin suppose follow dey celebrate oh. You wey nor get Bitcoin or solid altcoins you dey waste your excitement and celebration.

Most analysts dem talk sey once Bitcoin cross $51k and stabilize above am, bull run don start be dat. But for someone like me, na last quarters of 2023 bull run start for my eyes. See, dis same Bitcoin wey dey $50k now go still cross $120k as e dey be. With wetin I dey see and hear e be like e go even hit above $150k for dis season. E don almost dey wan return to its current ATH before halving sef. Dat wan mean sey more space dey for spike upward be dat.

Make una set something aside to buy and hodl. Nothing is too small. Nor talk sey you nor dey betta campaign na im make you nor go fit do am. Nor give dat excuse. Endure now to reap dis bull run. I nor know who I dey talk to but I sabi sey e get wan or two people wey dis post go dey useful for.

God bless all owa hustles... One luv!
My brother, this thing way you talk make sense well well, most of us no been get the idea to holding over the years,  but I believe now the awareness don dey now. So the need to remind people about these go well.  But u no say country hard now, for some people to see money this period no easy oh, talkless of seeing to use buy BTC.  No forget say currently the price of naira to dollar don high well well, for people to fit buy Bitcoin considering the current dollar price Omo e go hard oh, make God just help us to fit navigate through the situation.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
February 15, 2024, 12:58:43 PM
#1

Jump to: