Boss, I like the way you just take deliver the whole message on this Matter, because some new investors go the think say na by investing aggressively nah so person go take make better profit with bitcoin, and on a normal no investment expert go advise person to the invest a percentage higher than what he is saving from the total money he receives whether na weekly or monthly pay.
Actually, na the bigger the amount of money or percentage you invest na the bigger the profit you go expect. Likewise, the bigger risk you go face incase things take opposite side. When it comes to bitcoin matter, you no need to be aggressive or passive investor, wetin you need na calculation and management. Investing aggressively is a sign of greediness to make huge profits which is a bad strategy.
Bitcoin no be like contribution wey person go dey expect to collect certain amount of money at the end, there is market fluctuation which affects your investment capital. Na why person need to invest moderately in order to balance the equation between the profit and lose. It doesn't matter how much you dey collect per month or weekly, what matters is how much you fit afford to lose.
You fit dey collect better money make you no get mind to lose some kind percentage wey people dey suggest here. You no need to based your investment on a fix percentage, let it be based on wetin you go fit afford at a time. Mind you, there's no gain where there is no risk. Just make sure say na profitable risk you dey take. In summary, whether aggressive or not, make sure you dey invest no matter how small make we no dey behind.