But the way the country be now, my guy I no go lie you I plan to focus on Bitcoin forum if I rank up to full member. Make we no dey decive ourselves like say we no like this forum. The country porus. you fit still get 10 skills for Nigeria and still dey suffer. Why you dey talk like this be say you never dey see Bitcoin furum money. if you do, you go suspended that your electoral work Because no be everyday you go dey see work. Wetting dey make people learn plenty work na to make money. So I see nothing for Nigeria. I don hustle for street well with my skill. were I dey today? I still dey find work. So it's better to focus on a reasonable thing Dan to be treated as trash all in the name of say you dey work for person or company.
I dey reason with you e better make person get hand work but make we consider forum as side hustle because any thing fit happen wey you go hate forum but after that if you turn back you go get wetin you go grab for hand. This issue of connection dey also because no be the day wey dey dey look for carpenter or welder you go begin dey learner but if na your work you go just grab am.
@Samlucky, forum money sweet but the day the campaign finished or dey commot you for campaign na that day you no say forum no be permanent job but side hustle. The advice wey I go give una na to hold your hand work very well even though you start chopping money for forum, you go they use that money dey take support that your business make e dey grow.