The suggestion no bad as e go help make confirmation faster since some blockchain get a very fast confirmation speed pass Bitcoin blockchain but why I no go advice make we use Bitcoin on other blockchain na say, you no dey promote the use of Bitcoin well to begin with and you dey exposed yourself and customers to the volatility of Altcoins as those Bitcoin wey dey those other Blockchain are basically altcoins. Scammers fit send you a different Bitcoin wey no dey the main smart contract of the real pegged Bitcoin and if you no dey very observant dem go scam you. Scammers will create multiple pegged Bitcoin that are fake and newbies wey no sabi wetin dey sup go fall victim.
Wow, boss thanks for this yan wey just yan so, if to say you no talk, I for no know say dem go fit run bitcoin for other block chain sef, and even the dangers wey dey associated for this kind of system. Anyway sha, even though say we no try am because of the risk, e still good make we get this kind of knowledge.
For the other part wey you dey talk about using other crypto for transaction due to times like this when mempool dey congested. That na very good idea, but me nor too like altcoins but I fit reason that of the stable coin wey you recommend, na the only coin wey be say I dey see say I like because of em adoption and fast transaction rate.