come to think of it, this bankers way you talk about say them go calls you, me i really believe say nah only scammers go fit call people and convince them say them too nah bankers and them also sabi crypto stuffs, because no legit banker go try that rubbish, even bank self they talk am say th no go call customers any day to ask you their bank details, why? Because them already get am as every of their customers details dey their system (maybe even transaction PIN)
Na wetting I been wan talk be that bankers no fit do that kind thing because they know truewell say if dem get cut up say dem go penalize them, dem no go do am because e dey against there law. Except say na banker wey dem don sack before wey dey use bank information wey him get before dey enter people. Because most scammers wey dey fit enter person freely na those x bankers wey don work with bank before wey don dey frustrated wey go turn against bank to do that kind d thing. The only side I know say bank go fit cheat person na if dem send like $5 to bank, the exchange rate wey dey binance p2p no go dey the same. maybe as the current price now be
#1200 or #1194.2 accordingly for p2p, bank go give you like #896.64 or even #800 because according to there
exchange rate now for bank so dem go want make profit too.
Even say scammers Call you say make you do one or two, or say them be cryto currency expert , I no see any need if you know your way in crypto. because as me and you know say with the ban wey them lift say we go fit send the money directly to our account without the help of any entity just like the way you dey do your normal binance p2p without stress. And morover scammers don dey for long since binance p2p don replace direct crypto transaction with bank, so no be now wey dem lift the ban wey person go come make mistake for nothing.
Instead of falling a victim to scammers, while not still use the binance p2p, since the ban upliftment never settle down, because I no say na gradual process e go take to circulate. Wetting go make person fit fall into that kind thing na: 1 too much being in hurry to to be the first to initiate transaction by all means for bank direct.
2 na who never Sabi about binance p2p or being ignourant