This days a lot of people done they bring out crypto coin and majority of the people way they bring out this crypto coin just they do am to exploit other people, them go lunch there personal crypto coin then put there money inside con make public advert so people go come buy am and as soon as people don come buy the value of the coin go they go up as soon as the coin reach the kind price way them like them go con sell off there own coin and as soon as they sell am off the value of the coin go drop
Plenty coins now na Wetin dem Dey do be that, na teams just Dey use am scam people, na why if we Dey make investment, the best thing na to invest in Bitcoin, but we know say plenty people now get interest for altcoins, even as we know say the risk Dey high, so if anybody wan invest altcoin, make dem make sure say na strong altcoins dem Dey put money, d ones wey don Dey crypto space for long time, but all dis new projects me I no Dey advise anybody make him put money ooo, but mostly now na project wey fit make people Rich quickly dem Dey look for, and dem believe say na from all dis new projects dem fit get am.
If we go fit remember when davido lunch en coin way them they call davido coin, as soon as en lunch am en come make am know to everybody using his social media account's, a lot of people rush go buy am na so the crypto coin con dey grow in value and price before we no watin they happen davido sell off all en coin way en they hold na so the value of the coin just drop
I see as d thing Dey trend for twitter that time, I no just come hear about the coin again, I know say bad thing don happen. We no suppose Dey follow our celebrities blindly, anything wey dem talk, we no Dey even care to do our research, we go just do am, and Dey don’t even care about their followers, they only care about Wetin go enter their account.
After devido launch him own coin, other celebrities also launch now like Sabicoin, that one na sabinus get am, and Jotta coin wey be say na brainjotter get that one, and all no really end well.